₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,330,865 members, 8,447,464 topics. Date: Saturday, 18 July 2026 at 11:11 AM

Toggle theme

Adeyemik's Posts

Nairaland ForumAdeyemik's ProfileAdeyemik's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 11 (of 11 pages)

AutosRe: Nigerian Beware Of Auto Duping Syndicate by adeyemik: 5:49pm On Mar 20, 2009
Bros,

Una see de tin wey greediness dey do. Una tink say una don see awoof, de awoof won con tear una pocket or even tear una pocket. EOD for 800k, Camry for 600k, de price suppose alert una say na gbaju ee dey do una. Wen persin talk say awoof de run belle, mak una know say na true talk.


[size=18pt]Anyway, a very big epele to una wey fall mugu, next time mak una shine una eye well well.[/size]
PoliticsRe: 6,000mw: Minister Can’t Supply Work Plan by adeyemik: 9:55am On Mar 18, 2009
Ha ha,

Fellow naija people una suppose see the writing for wall. The minister just dey look for avenue to chop money. OBJ used 8 years e no fit achieve d 10000mw, e wan com use 10 months achieve 6000mw, representing 60% of OBJ's unachieved objective.

Abeg, se these our so called leaders think say naija people be mumu abi na wetin? Instead mak hin say e wan chop money, dey man dey blow grammer.
Car TalkRe: Do I Remove The Thermostart In My Car Engine? by adeyemik: 9:33am On Mar 18, 2009
Bros,

Remove the thermostat and continue to contribute the wealth of the Femi Otedola's, Mike Adenuga's and their likes. As your mecho has advised you to remove the thermostat, I will advice that you run away from that mechanic.

[size=18pt]"FLY WEY NO DEY HEAR WORD NA IM DEY FOLLOW DEAD BODI ENTER GRAVE"[/size]
PoliticsRe: Ibadan Residents Panic Over Robbery Attacks by adeyemik: 1:36pm On Mar 16, 2009
Dear Ibadanians,

You should not expect less. You have [size=18pt]thiefing[/size] man as your governor, who prefer to use state resources and funds on his daughter's wedding rather than developing the state. His daughter was robbed of $56,000 yet ibadan people did not make noise. Where on earth did she get the money from? Sorry your governor made the state attractive to armed robbers because he lacks direction and focus.

Send your governor to Lagos or Edo to be tutored on how to govern a state.
AdvertsRe: Luketech Technology Is Calling All Naijas by adeyemik: 11:47am On Feb 26, 2009
Gbam !!! Well said my fipol, maybe d guy mean 32m owo eyo (Cowries).
AutosRe: Flood/water Damage Cars by adeyemik: 8:56pm On Feb 23, 2009
Bros, awoofu dey run belle oooo. If you do mistake buy the moto, I assure you say your mechanic go use you build hin house. Promise72 and Siena do yan you the real koko, I tak God beg you no go near am at all. Dat $6000 (Cost including clearing and freighting), ig you tak am go Cotonu you go see bete moto buy.
AutosRe: Cheap Used Cars For Sale by adeyemik: 5:28pm On Feb 20, 2009
Bros, na one chance moto you wan sell? Na wah for you, dis na convocation before matriculation. shocked shocked shocked shocked shocked
AutosRe: 2002 Ml320: Eye Catching: by adeyemik: 1:37pm On Feb 20, 2009
Na eye catching true true. Moto on top dirty na serious eye catching. Infact, I don lose interest until you carri am comot for dat place and giv us new photo of the moto in a clean environment.

The car cleeeeeeeeaaaaaaaaaaaaaannn sha, but before we yan dust the car up with studio like picture.

Thank you.
AutosRe: Need A Fast Buyer.toyota Corrola.cheapest Price Ever: 65k.HURRY NOW by adeyemik: 12:23pm On Feb 20, 2009
Somebodi shout HALLELUYAH! HALLELUYAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAHHHHHHHHHHH!

Bros, I happi for you no bi small. If man na God dat moto no go go anywhere, but as God na God, He has done it again. The car is finally making is onward journey to compete on the same road with the president, senators, reps, governors, IG, EFCC and business moguls, what a new beginning.

Oooohhhh!!!! somebodi shout HALLELUYAH! HALLELUYAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAAHHHHHHHHHHH!!!!!!!!!!!!!!!!!!!
Car TalkRe: The Effects Of Naira Devaluation On Car Prices by adeyemik: 9:30am On Feb 20, 2009
Dis ya question na wah oooooo. Bros, why you tink say na so so bicycle full china? Tay tay wen dey moni (yuan) no good sansam, moto price dey high, food price bad, sa everytin bad for d country. D price of moto dat time na hin force fipol to dey use bicycle.

So for our obodo naija, de ting wey devaluation go do na hin bi say fipol no go dey buy moto again, na bicycle everybodi go go buy. Car owner wey do shakara giv fipol we dey ride bicycle, no wori soludonomics go soon mak everybodi the same (bicycle riders).

For our car explorer sori importer, e beta mak una dey take style style import bicycle smallsmall, before e bicom Tochukwu, Dele and Haruna bizness.

Bros, I imagin sai na bicyle we all com de ride for lagos, how una tink say 3rd Mainland bridge go bi?

Baba God go help use for this era of SOLUDONOMICS

[size=18pt]END OF STORI[/size]
Car TalkRe: What Do You Know About Cherry Motor? by adeyemik: 8:21pm On Feb 19, 2009
My people dey talk say awoof dey run belle. Wit d name alone you suppose waka away, dey call moto "cherry"; cherry and "Se ri" wetin bi d difference? e meaning "You see". Persin buy "YOU SEE" car e tink say e buy moto, you go see d kan ting wey e go take your korokoro eye see. People say if you wan chop "opolo" frog, mak you chop d own wey get egg. Mak una use una sweat moni buy beta ting. No let chin chung people deceive una. My people wise up.

A big e pele to all cherry sori "se ri" owners - YOU SEE

[size=18pt]END OF STORI [/size]
AutosRe: Need A Fast Buyer.toyota Corrola.cheapest Price Ever: 65k.HURRY NOW by adeyemik: 5:51pm On Feb 19, 2009
Haha,

Mak una see, if moto fit mak somebodi rich or bicom governor, tomitomi go don bicom rich. Your moto don mak you falcooler, you know see as fipol dey compete to condemn sori commend your lovely ride.

Bros, abeg no fling the ride again, take am go museum, e go attract tourist and dat na cool ego for you. Abeg tink am

[size=18pt]END OF STORI[/size]
AutosRe: Nigeria Built Limousine. by adeyemik: 7:09pm On Feb 17, 2009
Bros, make una no under-rate naija abeg. Stretched Limousine na small ting to do. If you go mit Ola Oluwa for Abule Egbe, e go help you build your limo. Abi una think say all the molue and 911 wey una dey see na imported? Na lie, na the guy dey build the dem for Abule Egba.

Bros, the difference btw your limo and the 911 na small ting, dey guy go do am for you. Sebi limo get fridge inside, just tell lam say mak e mak space for Eleganza cooler. Lino get tv, se bi? E go just build small iron table somewhere inside and you buy 14'' LG tv put inside. Wetin you want, the guy go build am to you taste.

We to much, limo na garri and epa.

[size=18pt]END OF STORI[/size]
AutosRe: Need A Fast Buyer.toyota Corrola.cheapest Price Ever: 65k.HURRY NOW by adeyemik: 2:35pm On Feb 17, 2009
Oga, Na how much bi your last price? Se d ABS and Airbag still dey work sha. And na how many Airbag e get? Wetin bi d Odometer reading?

Seriously interested.

[size=18pt]End of Stori.
[/size]
AutosRe: Does She Has The Authourity To Sell The Car ? by adeyemik: 2:21pm On Feb 17, 2009
Bros, d woman get the right to fling the ride, because d ting wey d husband get, na d wife get am as well (two shall become one). But sha, I go tell you say mak you no buy am sam sam at all at all, even if the husband send letter, sign, even put hin picture and dey take the consent give you. if yawa gaz, o boy, nigeria police go take you chop well well. Infact, dey talk say dey steal d car, you com go but stolen car, trust nigeria police. Na only God fit help you, if you not get big stick for your garden.

Bros, the fear of Naija Police na d beginning of wisdom for this kan matter. Remember CRIME FIGHTER.

End of Stori.
AutosRe: Ever Purchased With Mstercard On Clickbank Or Paypal by adeyemik: 2:04pm On Feb 15, 2009
It is quite unfortunate that penpal accepts Mastercard issued by banks in the war torn country of Niger, Benin while Nigeria as a country is not listed there, no thanks to our "GOOD" reputation.

Bros, lets wait may be the Nigeria re-branding project embacked upon by the government will work or it is another highway to chop money. Time will tell
AutosMak Una Unbanned D Ban by adeyemik(op): 4:36pm On Feb 12, 2009
I read am I no understand, I digest am e no gree go, Abeg my fipol na tru tru say dey ban Igwe abi na lie?

Bros, if na tru tru, I cry for dis our obodo naija. De Igwe wey mi I dey read hin ajasa for Nairaland, na apostle of TRUTH and do tins well well. E go dey talk say mak fipol no de do magomago for de moto wey dey wan sell and giv us d VINN numba. If na because hin tanda gadagba for de side of truth, una take sack commot. My broder naija get long waka to waka before ole, gibiti, afo wo ra and keni ma ni, fit comot for our land.

Dis igwe tin bi lik, de stori of one family, wey they boy dey tifi tifi, de mama dey beat am say mak hin stop, but instead mak de papa join de woman change de boy, de papa go dey halla giv de woman again. Fipol go waka com, com halla say de boy don tifi somtin, de papa go tell dem say mak dey non vex but d papa fail to correct d boy. D mama halla so tay, d papa no gree correct hin pickin.

One ogbonge monday, d pickin go tifi again, fipol com follow am com house, na hin mama dey meet for house, she beg dem say mak dey no vex, after de fipol waka, d mama beat the pickin well well, e no giv am chop eat. Wen de pickin fada com back see bulala mark for hin pickin bodi, e ask say who beat am, e talk say na hin mama, wetin e do, e no ask. E grab hin wife beat so tay, blood comot for her bodi, on top dat e talk say mak she pack comot for hin house.

Bros, two months waka, dat saturday com come, NEPA dey, 12 0' Clock nak gbam, for AIT on top crime fighter, de boy face show gadagba gadagba. Shame wear hin fada lik wrapa, no bodi wan associate wit am, people for street giv am plenti name, na shame drive am comot for d place.

My people say, good NAME beta pass GOLD AND SILVER. If peson do bad tin abeg mak we 2+2 together tell de peson say d tin wey do BAD. END OF STORY GBAMMMMMMMMM.
[size=20pt]
E je ka se dada koba le yewa kale.
[/size]
AutosRe: 2007 Mazda Cx-7 Grand Touring and CX-9 by adeyemik: 3:09pm On Feb 12, 2009
@Zerofobia,

I need a 2007 Nissan Maxima, please wire me with the total cost.

Regards,

AK
AutosRe: Buy Your Car In United States And Receive It In Nigeria. It's Now Quiet Easy by adeyemik: 4:41pm On Feb 10, 2009
Kindly check lot number OONN35013619 and give me the estimate.

Regards,
AutosRe: Buy Your Car In United States And Receive It In Nigeria. It's Now Quiet Easy by adeyemik: 3:56pm On Feb 10, 2009
Hi,

Can i get the price of a Nissan Maxima 2006 model with full option.

Send to kazeem_adeyemi@yahoo.com
AutosRe: If You Love Speed You Will Need This Pill:How FAST CAN YOU GOOOOOOOOO by adeyemik: 2:51pm On Feb 10, 2009
Sanity in the house please!!!!!!!!!

A 1999 model Suzuki (tokunbo bike) with an asking price of 1m? This is unbelievable, I have seem a 2007 Suzuki GSX-R 1000 (1000cc Engine) with an asking price of  NGN650,000 not yet used in Nigeria and in a very very very excellent condition.

Moreover, if you take a trip to an english speaking neighbouring country, you will see it far far cheaper.

Bros, give bike lovers a reasonable price.
AutosRe: Life Hammer by adeyemik: 6:25am On Feb 07, 2009
The "LifeHammer" is a small tool designed for expediting your exit from a car after a crash. The heavy steel hammer points are for knocking out the side windows to make an exit, while the small hook with a razor on the other end can cut through a seat belt.
AutosRe: Interested In Speedboats by adeyemik: 6:14am On Feb 07, 2009
Dont forget to give us the VIN as well

[size=18pt]VIN OOOOOOOOOOOOO VIN[/size]
AutosRe: Interested In Speedboats by adeyemik: 6:12am On Feb 07, 2009
Dont forget to give us the VIN as well cheesy cheesy cheesy grin grin grin grin grin grin
AutosRe: Interested In Speedboats by adeyemik: 6:12am On Feb 07, 2009
Dont forget to give us the VIN as well cheesy cheesy cheesy grin grin grin grin grin grin
PoliticsRe: Shame On Nigerian Police - All Because Of 50 Naira Bribe They Want To Die by adeyemik: 5:23pm On Feb 05, 2009
I.G see your people. Come baba wetin you go do now.  This na serious shame. Shame to Naija Police
AutosRe: Sexy: I'm Sure You'l Agree! by adeyemik: 5:12pm On Feb 05, 2009
Oga Boss,

Abeg where person fit see this toy, I just wan snap wit am.

[size=20pt]ABEG OWO, KUDI, EGO , UHU MONEY GOOOOOOOOOOOOOOOOOOOOOOD TOOOOOOOOOO GEEEEEEEEEEEEEEEETTTTTTTTTTTTTTT.[/size]
Car TalkRe: Types Of Car Good For Weeding by adeyemik: 1:59pm On Feb 03, 2009
911 molue bus. It is very spacious and accommodate as many guests as possible. Again you don't have to pay more on fuel consumption or vehicle theft.
AutosRe: Rolls Royce Phantom 2009 Coupe by adeyemik: 6:59am On Jan 15, 2009
@ MAKE IT RAIN

Nice ride!

MakeItRain, lets be reasonable

From a common sense perspective - Is it worth driving this type of car in Nigeria and on this our road no matter how big you are? Though common sense is not common.

From a Business and humanitarian angle - Have you imagined how many employees you can employ by investing 68 million in a cottage industry and mouths you are giving food to eat.

If I invest the 68mil on buying DANFO/FEDECO/HIACE BUSES for transport business (assuming each bus goes for 800k), I will provide means of livelihood for 170 people and within 6 months about 300 people. Calculate how many would be area boys and robbers taken off the road and homes.
[size=18pt]
Let common sense be common!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!
[/size]
AutosRe: Brand New 2008 Hp Laptops For N20,000 by adeyemik: 10:37am On Jan 14, 2009
Olive B:
Confident Lifestyle Network is organising, “Empowering the Naija Dream”
Own
BRAND NEW LAPTOP for N20,000
BRAND NEW KIA RIO CAR for N250,000
BRAND NEW HOME APPLIANCES for N100,000
See poster for details. Or www./
Call:
Olive: 07025411423, Victor: 08029879354
Why do we like putting the cart before the horse? It is only in Nigeria that you can always have abortion before pegnancy, convocation before matriculation. How do you expect people to pay into someone's account before knowing the person or knowing the caverts of your "END POVERTY POMOTIONS".

If what you want to sell to innocent Nigerians is geniune please do the right thing.
AutosRe: Hyundai Elantra ! Beauty Defined In Car by adeyemik: 1:00pm On Jan 13, 2009
@Pyramid77

Congrates on your new acquisition.

I once used an Elantra, it is a good car and enjoy it more when it rains and have to go through floody area. The floody water my toyota camry cannot go through, the Elantra goes through it and come out smiling. As regards engine performance it was very was very good.

However, Elantra has the following issues
1. The body frame is not solid. Pray that no one ram into any of your bumper, once it has a slight cut, stopping it from expanding will not be possible, so you have to start planning to get a new bumper if you want to keep the car's beauty. Though, the car's outer body frame my look frail but the inner frame and engine are strong. I once used the Elantra to pull/tow my Camry from Ekiti down to Lagos.

2. Never allow anyone to touch the car's brain box or to be removed to test on another car, if you do, you will be asking for problem. A friend of mine had the same Elantra, it was giving him problems and Naija mechanic said it was probably the Brain box that had a problem, so he advice that he needs to get a new brain box. My Elantra box was removed to test my friend's car and that was the beginning of the beginning of problem with my Elantra. The first problem I discovered was that the car's fuel consumption increased drastically, I had to buy another brain box, airflow meter etc, yet the problem was not solved. I had to resolve it by selling it off.

3. When on the highway and your speedo meter is clocking 150, the car becomes very very light. At the same speed with my Camry, I still feel the strong stability.

Nevertheless, Elantra if well maintain, like another car is a good car. What you have to ensure is that, the car is serviced by a good mechanic not a "kalokalo", "trial & error" mechanic.

1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 11 (of 11 pages)