₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,330,989 members, 8,448,117 topics. Date: Sunday, 19 July 2026 at 07:06 PM

Toggle theme

Came's Posts

Nairaland ForumCame's ProfileCame's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 23 24 25 26 27 28 29 30 31 (of 81 pages)

CelebritiesRe: Seyilaw’s Daughter Is Overweight - Kemi Olunloyo by Came: 9:02am On Feb 25, 2017
This woman no no seyi house or phone number to give am advice personally, why she come carry the advice come social media... Na wa oooooo!!!
CelebritiesRe: Fans Slam Tonto Dikeh For STD Infection Allegations; She Responds‬ by Came: 5:04pm On Feb 24, 2017
To jealous person no good ooooo... Some mama dem no let their daughters rest when toto marry ,na so dem dey use am talk everytime for house give their daughters,dem no even no say toto dey die in silence.
CelebritiesRe: What Recession! Toke Makinwa Rocks A N742,500 Givenchy Antigona Bag by Came: 5:00pm On Feb 24, 2017
So na wetin she carry the money way she dey make for the book way she take dey spoil person name be this? Their fake lifestyles no go even let person know when dem talk true.
CelebritiesRe: Nollywood Actor, Mr. Latin Tells Wife, “babe, You Make Me Happy Always” by Came: 4:46pm On Feb 24, 2017
Make she continue to make you happy ooooo, no come tell us tomorrow say she be one thing one thing ooooo.
CelebritiesRe: Does It Mean All These Gifts Were Gifted From Tonto Dikeh To Tonto Dikeh?(photo) by Came: 4:42pm On Feb 24, 2017
People dey keep record oooooo... Hahahahahaah.... I hail una.
CelebritiesRe: ‘my Husband Gave Me Stds’ – Tonto Dikeh Reveals Why Her Marriage Failed by Came: 4:40pm On Feb 24, 2017
If person way you trust,love,and even take do shakara disappoint you ehhh,nothing dey pain pass am... I feel you toto,my sister, life must go on.
CelebritiesRe: Write A Sad Story Using Only 3 Words by Came: 4:32pm On Feb 24, 2017
Toto is divorced.
CelebritiesRe: Tonto Dikeh: "My Husband Was A Cheat And I Was His Punching Bag" by Came: 4:29pm On Feb 24, 2017
Hmmmmmm, toto suffer for this man hand oooooo, I sure say the man go beat am true true,because toto must bad mouth am anytime she catch am dey cheat... Toto, sorry ooooo. Na when person marry person go come dey see plenty things way dey hidden.
CelebritiesRe: Exposed – The Exact Cause Of Dagrin’s Death Finally Revealed And They’ve Lied To by Came: 11:56am On Feb 24, 2017
This boy sing for him last album say make people let am rest, still people no dey hear word...Hmmmmmm!!!!
CelebritiesRe: Fufu Is Killing Africans - Ghanaian Pastor Mensah Otabil Says by Came: 11:54am On Feb 24, 2017
Pastors no no wetin to preach again, because wetin dem wan preach way people never hear before. This one say fufu way dem take train am from pikin no good again, because he don get plenty money way people dey contribute give am..... Na wa oooooo.
CelebritiesRe: Fans Blast Tonto Dikeh For Claiming Her Husband Gave Her STDs; Tonto Replies by Came: 11:48am On Feb 24, 2017
Make i be myself ooooo, people dey lie die, dey claim wetin dem no be..... Fowl yansh don open, we don dey see fowl yansh..... Hmmmmmmmm!!!!! Person way for marry person from east and be happy,she waka go see one Mr X. Learn your lessons, and keep quiet,i beg you.
CelebritiesRe: Tonto Dikeh: "I Treated Many STDs, My Marriage Based On Lies, Deceit, Scam" by Came: 8:49am On Feb 24, 2017
He that wears the shoes knows where it pinches, not all that glitters are gold, experience,they say is the best teacher. I wish you well Tonto.
CelebritiesRe: Toke Makinwa ‘on Becoming’ Book In London Despite Lawsuit by Came: 7:35am On Feb 24, 2017
See handsome man way toke wan rubbish, if he cum outside,he mean say he no get your time, na you forward yourself to am.
PetsRe: 5-Year-Old Girl Attacked By 3 Dogs Dies by Came: 3:56pm On Feb 23, 2017
Na landlord una go blame abi people way leave their pikin to roam carelessly where big dogs dey, me way be adult self no fit stay any place where those kind dogs dem dey.
CelebritiesRe: He Got A 'tricycle',patoranking Pictured With Genevieve Nnaji And Rita Dominic by Came: 12:08pm On Feb 23, 2017
Make person born out of wedlock or make person dey wait for husband reach 50 years, and no born, which one good pass?....somethings we call abomination are blessing in disguise. A word is enough for the wise.... Hmmmmmm!!!
CelebritiesRe: Daniel Ademinokan Gushes About Stella Damasus: "She Keeps Me Busy" by Came: 11:57am On Feb 23, 2017
I wish this man can open up on what made him leave his ex wife, so that women will learn one or two things on how to keep their men.....Hmmmmmmm....Stella, I wish you a blissful marriage oooooo, if wall open na him lizard go fit enter.....
CelebritiesRe: Funke Akindele And A Man Who Got Drunk As At 10AM (Pics, Video) by Came: 9:26am On Feb 23, 2017
She just carry person face show for social media without the person's consent..... People get away with what would have put them in trouble in Africa.....try this in Europe , and get sued. Madam,face your matter, you get them plenty. Yeye dey smell.
CelebritiesRe: Did You Know Kim K's First Marriage Was When She Was 19 To A Man She Eloped With by Came: 10:43pm On Feb 22, 2017
This girl cherish marriage, she no leave the Man upon say the man abuse am, na the man still file for divorce. She was ready to stay in an abusive relationship, her eyes never open that time... Hmmmmm...
CelebritiesRe: Toke Makinwa Takes Her Book Tour To London(pics) by Came: 3:45pm On Feb 22, 2017
Wetin dey inside the book way never happen to person before way make the book spectacular self, shey na bleaching of skin or cuming outside ,person never hear before?.....she just wan use hatred spoil person name, say she dey sell book.
CelebritiesRe: Baby Michael Jackson As Grown To Be Unrecognizable Check Photos by Came: 1:47pm On Feb 22, 2017
Na micheal Jackson start this cover cover face of baby way people dey cover now. The baby don grow say make people no call am blanket again oooooo.... Hmmmmmmm!!!
CelebritiesRe: Big Brother Naija Or Jenifa ’ S Diary? Which One Would You Choose by Came: 2:02pm On Feb 21, 2017
Wetin their big brother dey teach self, big brother way no dey respect himself, Janifa all the way pls, person need laugh for this recession ooooo,,no be something way go make person commit fornication or adultery .
CrimeRe: Man Cut His Wife’s Corpse Into Parts (Graphic Photos) by Came: 12:22pm On Feb 21, 2017
She knew he wanted to use her for ritual, they were separated two years ago, yet she went back to him.... When some things are shown to us, it is left to us to use our head, and take to our heels. R.I.P. to the dead.
CelebritiesRe: I Would Have Married Ogogo If He Was Single - Kemi Olunloyo by Came: 12:12pm On Feb 21, 2017
I hope say Ogogo no be polygamist,because those way be polygamist don dey regret oooooo.... Ogogo beware pls!
CelebritiesRe: Na Dangote I Wan Snatch- Bobrisky Replies Haters Over Mr. Churchill Rumours by Came: 12:08pm On Feb 21, 2017
Hahahahahah, this woman ehhhh,,abi na man funny oooooo, he wan snatch Dangote.... I laugh fall for ground.... Hahahaha...
CelebritiesRe: Iyabo Ojo Looks Dazzles In Her New Makeup Free Pics by Came: 12:04pm On Feb 21, 2017
Madam, the pastor allegation, I hope say na lie oooooooo....Hmmmmmm!!!!
CelebritiesRe: Kemi Olunloyo's Son Blasts Georgina Onuoha by Came: 9:05pm On Feb 18, 2017
Omo mummy, tell your mummy say na Africa she dey now, our ways are different from the ways of the people where she raised you, so make she dey respect herself.
CelebritiesRe: Kunle Afolayan's 100-year Old Grandmum Has Died by Came: 2:12pm On Feb 17, 2017
100 years, na celebration be that ooooo, owanbe don shele. I beg,sendme my own ashebi material make I start to dey prepare now. R.I.P. to the dead.
CelebritiesRe: Blac Chyna And Rob Kardashian Split, Call Off Wedding Too by Came: 11:00am On Feb 17, 2017
This girl no plan to marry for life, she will just target rich men to born for and live on child support... Na cesarean she dey always do so that the market no go slack... Rob self, of all girls, why you chose this girl? Na wa to you . Oya,start to dey pay child support.
CelebritiesRe: Tonto Dike In Adorable Birthday Photo Shoot With Her Son (pictures) by Came: 9:09am On Feb 17, 2017
So this woman don remove the wedding ring way she say be millions... All that glitters is not gold indeed.
CelebritiesRe: Tonto Dikeh Wishes Her Son Happy Birthday In Different Style (see Pics ) by Came: 9:04am On Feb 17, 2017
Na dog been be her family before king come, mama king hope you done get answer way you go tell king when he ask you the meaning of that plenty tatoo for your body.
CelebritiesRe: Tonto Dikeh Blackmails Husband, Sponsors False Gist With Male Colleague by Came: 1:43pm On Feb 16, 2017
I no go surprise if this man be gay,many of them be gay, dem just marry to take Cover up.

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 23 24 25 26 27 28 29 30 31 (of 81 pages)