Came's Posts
Nairaland Forum › Came's Profile › Came's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 25 26 27 28 29 30 31 32 33 (of 81 pages)
why start what is bigger than you? Too rash,guess!!!!!!! |
See ring for pikin nose, the mama no wear ring for nose she wear,,, university here I come..... Wehdone girl. |
Mama no put ring for nose, pikin put. Mama dey bath with lux soap ,pikin dey bath with Tura soap,na him be say pikin don open eyes pass mama be that. |
Na true ooooo, some people dey way go do another thing way go cause wahala, dem go come put am for 2baba head... The lesson to learn is don't be rash, think before you embark on any journey. |
I want make this woman tell me why she no wan marry since all these years.I go like no oooooo!!!! |
Na Edo state she go abi where she go. Better pikin, you try. |
Thank God say no be mistake from hospital this time. R.I.P. ooooooooo!! |
I 100% sure say she don get belle. Na belle go make dem do this wedding sharperly. |
This guy no wan marry abi wetin self. |
This girl na trouble maker,na only trouble maker go fit dey get time for anty Kemi like this. Mind your children, business or whatever and forget about wahala pls!!!! |
I too gbadun this Eniola. Gbogbo big girl carry go jor,nothing do you. |
So all these cry way people dey cry, he dey hear am,and no do anything, dem wan protest now, he dey ask 2baba question. Make una take time there oooooo!!!! |
No mind them , like say na only 2baba get baby mamas, plenty of them get too.... Dem wan take school rubbish 2baba, dem way go no dey make sense at all. |
" At the end of the wedding,she realized her heart was somewhere else" so no be your heart you take dey follow the guy all these years? Na wa for you oooooooo . I no no why people like to dey waste money do elaborate wedding when their heart no dey. |
"Under pressure, me say under pressure, under pressure, my people under pressure" ... Nija never still comot for under pressure way this man sing tey tey... This man na legend true true. |
She dey shake yansh for JJC, see JJC for back .... Maybe she dey happy say she don carry belle. |
Continue with the fashion way no make you get time for your marriage, way one woman way no dey do fashion come carry belle for your husband....continue you hear. |
She no even born cute child way go make people pity am, she go born headmaster . Na OYO you dey for this recession ooooo. |
This jzeeeey, and beyouncy pic funny oooooo.... I over laugh. Hahahahahah!!! |
She no carry fake bag go the dinner . |
Pete Edochie dey find wife, abi this one wan take Pete become popular. |
I no sure say black face go fit forgive 2face anything way he do am oooooo.... Where faze dey self? that guy just hide. Black face pls, find a place in your heart, and forgive 2baba oooooo, because this your hatred don dey too show oooooo... |
I dey see four nipples ooooo,,abi na my eyes...she no say her breast still get swag, that is why she show am, if na slippers she no go try am. |
If those people way dey top fall, wetin dem go tell God. Risking one's life no make sense ooooo... |
You way go school, na bad mouth you go learn for school? Yeye dey smell. |
The police go say "chai, na my one year salary this man dey spread so for air" Hmmmmm!!! |
She wan use this opportunity show herself. Oga madam, go sitdown for kitchen make men handle matter oooooo. |
See wahala.... People can use person life weak person. Father of all nation,you for dey your lane oooooo, dey take music dey fight dem. |
See gobe!!! Who be this pregnant woman ...Hmmmmm!!! |
Are all these show off necessary?.. Na them dey announce themselves to kidnappers. |
I wonder wetin him dey sing for people way dey invite am to come sing . I no even no who him be until I hear that gala song. Money dey change people ooooooo....kc, and E money make una doooohhhh,,na so world be. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 25 26 27 28 29 30 31 32 33 (of 81 pages)