Came's Posts
Nairaland Forum › Came's Profile › Came's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 34 35 36 37 38 39 40 41 42 (of 81 pages)
He left Nigeria 30 years ago, he no get wife , he no get children.... The kind life way some people dey live ehhhhh, na I DON'T CARE life ooooo. R.I.P. oooooo!!!!! |
This guy mouth get as he be... He just dey work for Kim. Good for them. |
Marriage ke!!! Wetin she dey find again, she don born boy,born girl ... Hmmmmmm..... Na really true say man can not live by bread alone ooooooo, this woman don prove am... Hmmmmm... |
Madam stay there dey collect gift and continue to dey waste your time with person way no ready to marry . |
How he go sleep....He dey find money to take care of him materialistic wife... Yeye . |
Wetin I wan carry dem do... My guy,go hussle, and forget people matter... Who dem EPP.... |
If no be boutique , he go be salon for dem... Una try. |
Oya, make una start the abortin oooooo... Dem say forgiveness dey for una .....make una carry go. |
Na only pre divorce pic we no dey see. |
19, and in final year... You no finish secondary education before you enter? After university education, wetin again? Na to marry or get better work, and start making money ... You no like the man ....I sure say you don test one boyfriend way dey scatter your dada for that school... Think well oooo. |
When she marry way we no no. Congratulations oooooo.... |
I be 34 still dey hussle for sun... I pray make baba God pick my call ooooo, as dem no born me for silver, Gold or even bronze spoon ... |
Make dem pity dat wall paint am,if not for anything for this Xmas way dey come ... Hmmmmmm..... |
When money come, people way no believe say dem fit make money go just dey do anyhow with the money... Good for you .... |
Some children can disgrace their parents ehh.. So na man be her problem.... Make dem leave am make she learn her lesson. |
Na wetin people go talk dey make people die in silence.. |
I no see any belle ooooo... |
Bachelors don finish for this world way be say na married men, and men way don born plenty children with plenty women spinsters go dey find.... I tire ooooo... |
Madam , why you go tear this better dress.. Na wa ooooo.... |
He need the guards ooo, because people go just match am.. |
Na this excuse dem say make you talk make you for finish your school,,, you try well well... You naked dey sing dey happy you say na mental problem make you do am... Spiritual problem would have been a better excuse , because now,you will be seen as a mentally deranged person.. Na you sabi... |
Na Dangote wife be that woman beside am... She fine ooooo... |
Dem still carry MaryK, and the rest go beach... Na wa oooooo.... |
Jumping the fence to see my babe because they refused to let me in, as I jump finish i come end for police cell that day ... No be small thing ooooo. |
The guy don plan the thing tey tey... Hmmmmmm.. |
Haayaaahhhh, I feel for the mother,which mother go like watch dat kind video oooo... If devil give you something with right hand, he go use left hand collect am... Na desperation cause this wahala for this girl ..una dooohhhhh!!!! |
Wetin him dey sing way him go get music label self... Na dem sabi ooooo... |
I sure say na Denrele be that mad man way dey Beverly back for the first pic. |
How old be the papa self.. |
Na only baba God get the long lasting body spare parts for hand,, make una stop to dey wonder... Enjoy your life bro. |
Yeye girl way think say na man go make am happy ... At tender age na marriage be her problem, and of all men na her suppose brother she see marry... Hmmmmm... R.I.P. oooooo |
This kind story dey sweet to talk when money dey Person pocket. School ooo , Agberooo , owo ni koko, for Davido voice.. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 34 35 36 37 38 39 40 41 42 (of 81 pages)