Came's Posts
Nairaland Forum › Came's Profile › Came's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 33 34 35 36 37 38 39 40 41 (of 81 pages)
Na over showing off dey kill them. You get am madam. |
Mama king don use her experience advice una oooooo, na make una use the advice remain. Advice dey sweet to give when you experience plenty bad things, and at last all go well for you. |
No be Wizkid I dey see sooooo !!!! |
She needs Jesus to let go of the pain in her heart. Emotional sickness takes a long time to cure. The content of that book will forever remind her of the pain.... Hmmmmm.... She was betrayed by a man she loved,not any man, but her husband .... Why did he marry her when he knows his heart isn't involved. |
If na some yeye women na to remarry go dey their mind as their husband die.... Dem go use "I need a man to help me raise my children" do excuse ... May you enjoy the fruit of your labour ma. |
The face of the man way no no wetin him want.., he want to dey chop two women, married,and unmarried dey go without any wahala. If na woman do wetin this man do him wife now, people for don take talk kill the woman... Hmmmmmm.. |
The koko be say people no see marriage as sacred again.... Dem just see marriage as one big party where they go to say " I do" |
You knew about him, and that Anita lady, still you follow am go say "I do". Madam, leave matter, and move on with your life... Trying to put people down won't help you either. |
Dem rub the baby Mary K, abi wetin.... My own be say why dem waste money for wedding when dem no say dem go soon separate. |
Madam Kemi dey right for this one oooooo... I talk am too.. How person go wear this kind dress say she dey launch book .. She for say she wan launch her olosho work. |
He was brave to have killed himself, because killing oneself is not easy at all . R.I.P. |
I hope say she don fully surrender her heart ooooo.... Na heart be the koko to surrender no be rubber. |
So you bleached your skin of a man. When man starts to do things to please God, and not human beings their life will be relaxed and peaceful. Kpele oooooo....Oya go back to your former skin colour as the man don go oooooo.. |
How this guy think say him fit run with him car for that computer village way people dey full... They were two in the car, and he was the only one beaten, why dem no beat the other man.... |
Don jazzy way don reach 50 years say him be 34.... Happy birthday oooooo.. |
Those way get Children with plenty women no plan am oooo....Just make sure say na one hole your Kondo dey enter to avoid plenty baby mamas. |
Him face be like juju self . Ole Ajibo ole !!!!! |
Una see wetin the love of a woman can cause... Three Gboosaa for women ooooo... We serve one God anyway. |
This man way no get respect for vows.. He just dey do wedding anyhow for church... Na wa oooo ... |
The person way keep the gun where the children fit play with am try well well , make he go collect award oooo ... Yeye. |
Wetin dem do him wife, because me i no understand grammer oooooo... Wetin be "taser" I beg una? |
Person call off wedding many times, una discuss elope he no send you, you visit am dey see woman property way no be your own , dey see many things still you still go Marry am... Anty you saw the handwriting on the wall, but you decided to ignore it.... Heal alone by yourself, sorry .. |
As long as you be celebrity, you no fit hide anything about you oooo.... It is just a matter of time we go no every every . You like privacy, you come carry yourself come outside say you be star. |
Jesus said if you believe all things are possible because he knows that believing gives us all. |
One man still leave this beauty go give another woman belle... This life ehhhhh... Na wa ooooo.. |
Make him just use am do movie make money, because nothing way eyes never see....no hide like that Cucumber girl ooooo,,,, Life goes on. |
This guy don marry or get children? Make God dey save people way think say all these drink with sexy name , and way dey cost big money na enjoyment . |
Na Tony Tetulla be dat. Tony it as tey oooooo.... Make una advice that yellow pawpaw way police shoot way God save say make him no drink Whisky oooooo... Hmmmmmmm.... |
Wetin the guy go do am way she no go fit forgive if she truely love am like Ani loves 2baba.... Highest the man pursue another woman or him get baby with one baby mama without telling her . Na dem sabi shaaaaa !!!! |
Hey madam, no come make people dey pity you for here ooooooo, you suppose don no every before you allow that man waste money for wedding.... Whatever happens to forgiveness I no blame you,plenty customer dey for line dey wait... Enjoy your life oooooo... |
To be celebrity no easy ooooo... Any small thing the world must know. These people don't live a normal life,I no jealous them at all. |
So because he wan donate cash,he come go call camera people .... He try well well....showing off na part of showbiz. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 33 34 35 36 37 38 39 40 41 (of 81 pages)
I no blame you,plenty customer dey for line dey wait... Enjoy your life oooooo...