Came's Posts
Nairaland Forum › Came's Profile › Came's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 30 31 32 33 34 35 36 37 38 (of 81 pages)
Na this one be rice way she go cook give people chop.... Cake go belleful poor people? This oyinbo style no be am for where poor people dey oooooo. |
Are they twins ? Them don become big girls's oooooo.... I wonder wetin cause divorce for this woman... |
Why the marriage no go last with that kind loving,caring husband way dey do him responsibility. Na woman way dem curse go leave that kind man.. Wetin she dey find outside again... |
That doesn't look nice at all.... The knee just dey take all the attension... Linda do something about it pls.....which kind dirty black be this one.....the knee color just different from the rest of her body. |
Who say recession dey .... Hmmmmmm... |
She looks like one mad woman way dey always use kpangolo cook for dustbin area. |
All because of money... Hmmmmmm... |
Wetin me I no be say this woman don pass girlfriend stage, na wife level she suppose dey now. |
Una see as this girl take her hand push her dress back make her body for show .... Na wa ooooooo.... Na show body be swag now.... You try yellow babe. |
Chacha 2nd child,baby girl, was born, on Chrismas dayyyyyyyy!!!!! Congratulations . |
Na only person way never experience the death of a close person go dey laugh person way him person die..... R.I.P. Henrietta. |
Showkey baba send me address to your house, I no wan miss this pepper soup, I beg .... Hahahahahaa.... |
Why the building no go collapse, see as the building be.... People go dey blame police,but Govt. no dey take proper care of their welfare at all.... Dem go allocate big money for themselves, and forget to better the lives of those who protect the country. R.I.P. to the dead. |
This guy don leave him farm work come dey sing again.... Make he go settle wahala way him get with obj for farm ooooo, because two of dem be farmers....I wonder Wetin people wan teach their children about respect when them dey insult elders ... Na wa oooooo.... |
People way she dey give yarsh, I hope say una don hear ... Una merry Xmas oooooo..... |
Na him opinion ooooo, everyone is entitle to his or her opinion.... Something way you no believe no go work for you, Jesus self talk am say blessed are those who have not seen but believe when Thomas dey doubt, Jesus no say some people no go believe say him dey .. So am not surprised with seun's opinion. |
This is the next option when trust is gone. Hypertension sitdown people go dey find am...when una see wetin una eyes dey find, una eyes go clear. |
She don join deeper life church... Good for her . |
Rob no like himself, how he want another person to like am.... He allowed his fat state to take better part of him.... Na insecurity be him problem. Of all women na olosho chyna him go see.. Yeye man, he go pay child support tire. |
Does she look like she cares if she is being replaced? She just use the guy gett wetin she want... The children....,, finish.... Can the man take care of the family single handedly. If na the man dey waka up and down people no go talk ooooo, dem go say na business him dey do make family for chop. |
Na show off dey kill them.... Your mate dey show their husband , and children, you dey waka up and down with lover way no proud to be seen with you... Na you sabi .... |
The husband for first swear as the head of the family that he will sleep with no other woman before the woman go swear. Leadership by example. |
If to say money fit buy death, rich people go don buy am finish tey tey way be say na only poor people go dey die.... Hmmmmmmm.... |
Female actors are always giving people the impression that they are OLOSHOS... |
You don't deserve him because you no say you be Olodo rabata. |
No be money dem go take take care of responsibilities... If the man is capable, the women no go follow another man waka. |
Na you sabi.. Mumagee don get children way she wan born,and she no be baby mama.... Na flexing remain for her now .... She no help you ? Talk true ... Now you warn paint am black ... All men way dey find women way don already hammer way no go come demand money from their hand, wetin una expect ... Free the woman, I beg. |
I suspect this missing ooooo,, she no no him house... Na gbeborun missing be this one ooooo... I wish you speedy recovery Julius... |
When dem go born second pikin,plenty women don born plenty children still dey beautiful .... Na una sabi ooooo....everytime, beautiful, beautiful .. Person no go hear word. |
Make this thing no be true ioooo... because I dey envy their union .... It had better be a rumor... Hmnmmmm..... |
Freeze, freeze, freeze, abi na freezer, how many times i call you... Who you don epp too... Who you epp.... Mind your cool fm work ooooo... Hmmmmmm.... |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 30 31 32 33 34 35 36 37 38 (of 81 pages)