₦airaland Forum

Welcome, Guest: Register • Login • With Google • Trending • Recent • New

Stats: 3,344,661 members, 8,513,016 topics. Date: Wednesday, 04 November 2026 at 11:13 AM

Toggle theme

Favour32's Posts

Nairaland Forum › Favour32's Profile › Favour32's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 236 237 238 239 240 241 242 243 244 (of 262 pages)

Health › Re: Coronavirus: FG Orders Closure Of Varsities, Schools Nationwide by favour32(m): 9:37pm On Mar 19, 2020
Amaa2019:
Wonders shal never end, see the same person who talk say Northern gov quick close skul cos them no wan learn (dem prefer illiteracy) today na same man dey talk why govt no close skul from day1
This kind of human being is difficult to deal with.
There is nothing you do that can satisfy them.
Pity people living with such a person_____hellish!
Health › Re: Coronavirus: US Approves Chloroquine As Treatment - Trump by favour32(m): 8:48pm On Mar 19, 2020
eldoradoxx:
America get President joor, no be this yeye leader wey una get for Nigeria. See how he daily briefs his people on the way out. APC led Senate is still begging Buhari to speak to Nigerian's on a common plague in the land. He is hiding inside villa. God will punish everybody that helped reimpose this kind of hopelessly useless leadership on Nigerian people in 2019 election.
If cabal nor tell am make he talk e no go talk grin.
Politics › Re: Coronavirus: Buhari Not Alive To His Responsibilities - Afenifere by favour32(m): 10:40am On Mar 19, 2020
grin grin Hahahàhahahahahahah!
I dey laugh dem bc dem think say na Buhari.
Oya cabal!
Make una do una work? cool
Politics › Re: Dino Melaye's Mother's Grave Decorated (Photo) by favour32(m): 5:55am On Mar 19, 2020
helixmanager:
You can do better! Instead of stating his failures based on senatorial responsibilities, you rather went on personal lifestyle which exposes built in hatred in your heart.

Try to be objective in life, it will make you a better person.
I be wan answer am but I say make another person do am.
Health › Re: Mentally-Challenged Preacher Rehabilitated By Kokun Foundation by favour32(m): 4:31am On Mar 19, 2020
AkupeMBANO:
everything doesn't always happen the way you and your wife gossip about it. this one you wrote today is crap!
Mad man dey talk sense but normal people dey nonsense.
Nor mind the couple dem think say everything na arrangee.
I ask am if dem dey take clear eyes mad?
Health › Re: Mentally-Challenged Preacher Rehabilitated By Kokun Foundation by favour32(m): 4:21am On Mar 19, 2020
Osgilliat:
I told my wife that this mad man preacher has a big plan.
The next thing you will hear now is that he has open a church and guess what? Millions of people will troop in to worship. It’s just a simple strategy.
Na clear eyes dem use dey mad?
Christianity Etc › Re: Coronavirus: Apostle Joshua Selman In UK, Shocked As Members Refuse To Hold Hand by favour32(m): 4:03am On Mar 19, 2020
Uyi168:
....
Healings and miracles only takes /took place on the pages of the Bible...
Your concord arrangement nai fall your hand. grin
Health › Re: Coronavirus: Guidance For Self-isolation In Nigeria by favour32(m): 3:58am On Mar 19, 2020
Orion01:
The fact that Buhari has not addressed the nation shows how incompetent he is. It is the minister of health we see all the time. The same attitude he showed towards the fulani herdsmen situation till It got worse. Other leaders of the world are reassuring their citizens and informing them about what they are doing. The dummy we have as president is playing silent game with us. The truth is, we dont have what it takes to manage this epidemic should it spiral out of control in Nigeria. Imagine washing your hands regularly and still caught the virus, somehow we are still going to touch something, forget to wash and then touch our face.
God help us
You sure say na real Buhari?
Dem never write and teach am wetin e go talk shocked
Travel › Re: Coronavirus: US Consulate In Nigeria Cancels All Visa Applications by favour32(m): 8:38pm On Mar 18, 2020
GOFRONT:
The media says that corona virus is coming and everyone panics, But the bible says that Jesus is coming and no one cares..
You nor know say na when hand meet human beings nai dem dey care grin
Family › Re: Virginity Doesn't Guarantee A Stable Marriage (a Must Read for young ladies) by favour32(m): 12:10am On Mar 18, 2020
ufotty2001:
That is how one told me that I most marry her before I will have se.x with her..
Dis time e dey hard o.
U must test the goods to know the elasticity before u know what to do.
Anyone wey nor ready make e waka.
Politics › Re: Sanwo-Olu Visits President Buhari With Pictures From Lagos Explosion Site by favour32(m): 10:13pm On Mar 16, 2020
Maxymilliano:
Sanwo Na bòlò, what’s the point of sharing these pics? Is he seeking a solution from Buhari who himself is seeking a solution from Abba Kyari, Or is he just showing him for the same purpose of cluelessness for which both of them are known for ? I don’t seems to understand.
Bendel
Celebrities › Re: Idris Elba Tests Positive For Coronavirus (video) by favour32(m): 7:51pm On Mar 16, 2020
slimthugchimee2:
Even the movie industries will not be spared
cry cry

By the way after so many tries, I finally got first to comment
cheesy cheesy
Na wetin dey thrill una for this childish first to comment matter.
If e dey make more credit for bank account e good.
Crime › Re: A.I. Ajao: OAU Lecturer Assaults Student (Video) by favour32(m): 8:21pm On Mar 15, 2020
Nor blame this person wey video this...the person get Parkinson's disease grin grin grin
So that's why shaky shaky hand...I think say opolo eye dey turn me sef grin
Politics › Re: Innocent Ikpamezie: Hope Uzodimma Appoints Thug Arrested For Election Fraud by favour32(m): 6:06am On Mar 15, 2020
Police come be like scam for Nigeria.
Dem go parade criminal for show business and come release am later nor be yahoo yahoo?
***I tell una b4 say two yahoo guys wey police parade sometime last year for Abuja wey dem specialize for BEC dey street now!
See criminal don become GM!
Make una continue na all of us go dey suffer the reaction.
Imo enter one chance with this governor wey get fraud case wey immunity cover so quickly. shocked
Business › Re: Zenith Bank To Acquire Union Bank by favour32(m): 5:45am On Mar 15, 2020
majamajic:
So union bank is gone ?

Unity bank keep surprising me , they look fragile yet floating wella
Na North dey wedge unity bank na
Politics › Re: New Pictures Of Sanusi At His Lagos Residence by favour32(m): 7:37pm On Mar 14, 2020
Person go wear Agbada Agbada nai be double Agbada say na king with the load for head.
Na God save Sanusi,that load don dey comot in layers.
Politics › Re: Sanusi Arrives Lagos Airport (photos) by favour32(m): 5:35am On Mar 14, 2020
daddytime:
Now, let the nationwide tour begin in preparation for 2023.

Na una go even clamour for am to contest.

Tinubu go don weak like dodo for this game of thrones. Lol



The North na the master of the game when it comes to Nigerian politics.
Six states for North na poverty headquarters of Nigeria.
Why North nor be master to turn am around?
Everyday nai most youths dey follow trailer from North to South,wetin dey pursue dem wey North wey be so-called master nor fit stop?
Education na a part of solution to North and make dem leave this religious extremism matter.
See most moderate Moslem countries wey dey tolerant dey progress dey go.
Example,UAE,Quater and others.
If anything negative dey happen for Nigeria na North dey extreme pass.
Most youths for South dey educated so not be everything dem dey say ranka dede to elites or politicians.
No youths again for North.Many don run come South.
Make una leave dis master sh!t thing and educate una people, control population and stop all these religious extremism.
Na me Favour dey tell una d truth!
Politics › Re: Sanusi Arrives Lagos Airport (photos) by favour32(m): 5:33am On Mar 14, 2020
daddytime:
Now, let the nationwide tour begin in preparation for 2023.

Na una go even clamour for am to contest.

Tinubu go don weak like dodo for this game of thrones. Lol

The North na the master of the game when it comes to Nigerian politics.
Six states for North na poverty headquarters of Nigeria.
Why North nor be master to turn am around?
Everyday nai most youths dey follow trailer from North to South,wetin dey pursue dem wey North wey be so-called master nor fit stop?
Education na a part of solution to North and make dem leave this religious extremism matter.
See most moderate Moslem countries wey dey tolerant dey progress dey go.
Example,UAE,Quater and others.
If anything negative dey happen for Nigeria na North dey extreme pass.
Most youths for South dey educated so not be everything dem dey say ranka dede to elites or politicians.
No youths again for North.Many don run come South.
Make una leave dis master sh!t thing and educate una people, control population and stop all these religious extremism.
Education › Re: Ekiti Varsity Retains Lamido Sanusi as Chancellor by favour32(m): 5:10am On Mar 14, 2020
easyfem:
seriously this man deserve this ................ av been following him over 8 years ago........... he seem to me a good man but only GOD knw his mind cox once an housa man always an housa man .......... na so them tey use buari tricks me
Sanusi nor be hausa man you hear?
Politics › Re: Sanusi Living 'Like A Prisoner' In Nasarawa, Police, NSCDC Deny Visitors Access by favour32(m): 1:59pm On Mar 12, 2020
This shows say nor be one country be Nigeria.
Which law/constitution Ganduje dey operate to banish person?
Politics › Re: Salihu Yakasai: Dethroned Sanusi Won’t Have Access To Visitors – Ganduje’s Aide by favour32(m): 2:05am On Mar 12, 2020
What does the constitution say about this?
A stone age governor of Kano state would wake up from slumber and banish a citizen of the Federal Republic of Nigeria (with no criminal record) with a law which is below the constitution.
The constitution is supreme.
Nigeria is not progressing@ all.
Family › Re: Living With My Aunt Who Is A Pastor's Wife Is Hell. Should I Run Away? by favour32(m): 1:54am On Mar 12, 2020
Raalsalghul:

70%? More like 95%, that shit is inbred: more like there is a special gene in them responsible.

I've seen it play out several times without number.
Women wicked o!
If na 95% nai be say na almost all women dey do am
Crime › Re: Lady Slaps Female Police Inspector At A Police Station In Lagos by favour32(m): 1:05am On Mar 12, 2020
valarmorghulis:
How would you feel if a white man called you a nigga, hope you won't call him a racist
Na the only low way to trend.
E lacks creativity.
Politics › Re: Senator Bima Enagi Introduces Bill To Ban Generators; 10-year Jail For Seller by favour32(m): 1:00am On Mar 12, 2020
These Northern senators nor smart@ all.
Their brains dey below average.
If that be, nai be say dem be mumu!
Family › Re: Living With My Aunt Who Is A Pastor's Wife Is Hell. Should I Run Away? by favour32(m): 12:50am On Mar 12, 2020
Wetin I never understand be why over 70% of women dey maltreat another woman pikin?
But dem nor dey touch their own?
Nor born give another woman make she train am o.
Na there dem dey unleash latent terror!
Politics › Re: Bianca Ojukwu Celebrates Chimamanda Adichie, Ngozi Okonjo-Iweala, Dora Akunyili by favour32(m): 8:19pm On Mar 09, 2020
I beg how Ngozi Okonjo Iweala take become Prof?
She be lectural and where?
Person go fit be Prof without without being a lectural?
I wan know but I know say dem don talk dis matter before.?
Properties › Re: Share Your Omo-onile (Landowner's Children) Experience. by favour32(m): 6:40pm On Mar 09, 2020
Oba try well well for Benin,Edo state, wey e stop dis omo-onile nonsense.As young men, mostly illiterate boys nor wan do anything but to depend on hand out from people who wan develop their lands.
Delta State government try well well.
Any so called omo-onile wey dem catch for Delta state na correctional center e go rest for sometime..
Family › Re: Wife Ties Up Her Husband In Calabar, Attempts To Suffocate Him On Women’s Day by favour32(m): 6:20pm On Mar 09, 2020
Dis na domestic violence!
"Take my money go drink and buy for other women", as if she bring money come the marriage.
Travel › Re: What's The Best Skill To Learn Under 6 Months For Me To Migrate To Europe? by favour32(m): 6:04pm On Mar 09, 2020
Wait make coronavirus cool down before u travel.
Go learn but learn wetin dey where u dey travel go.
Politics › Re: Sanusi Lamido Arrested, Exiled To Nasarawa After Dethronement As Emir Of Kano by favour32(m): 5:37pm On Mar 09, 2020
Sanusi the truthful man!
The enlighten King tell dem the truth nai dem dey worry so.
Nothing do you Sanusi.
You be king forever.
Poverty rate for North na alarming rate
The northern elites nor wan know.
Dem wan continue to subjugate the poor primitive people not to see the light.
Nothing do you Sanusi!
Ganduje make you live forever!
Culture › Re: Emir Dantoro Suspends Officials For Allowing Fulani Herdsmen Enter Communities by favour32(m): 4:06pm On Mar 09, 2020
Witcher:
This is bad... Fulani are nomadic, technically all the land belongs to them... Well if not the land at least the grasses.. he should expect payback if I'm in that town I will run away. Fulani are not like other black creatures they're special and they never forgive
As Fulani dey kill anyhow and the present Fulani led federal government dey technically dey support dem so.Time dey come almost all ethnic group in Nigeria go face this Fulani.
Nobody get monopoly to violence. It is just dat majority of Fulani are primitive stagnated by their leaders now elites who broke away from stone age behavioural tendencies through education and exposure.
This crude people bad.If you see how dem dey slaughter person with "asara", oboy dem still dey backward.
Celebrities › Re: Ned Nwoko Hosts Pete Edochie, Celebrates His 73rd Birthday (photos) by favour32(m): 9:36am On Mar 09, 2020
tillaman:
grin
Las las Sir Pete sef go receive brown envelope!!
This man just dey flex people anyhow, I sure say na future governor of Delta state be Oga Ned
Just add 19 years join Ned present age to be future governor of Delta state.

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 236 237 238 239 240 241 242 243 244 (of 262 pages)