Theophorus's Posts
Nairaland Forum › Theophorus's Profile › Theophorus's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 30 31 32 33 34 35 36 37 38 (of 114 pages)
Una say dem relieve una of 'Burden' but still talk say una go review the matter, Abeg which kind opata be this? LG na burden but una refuse to do LG elections abi? |
Abeg, make NLC parkwell joor. All the Fraud going on in the Ministries what have they done about it? All the unproductive workers what have they done about getting them productive? Every time Increase Minimum Wage without any Improvement in their delivery/services. |
Choc hocho upandan. Grateful ke? Oga, this fight wen you start so ehn, finish am ooo cos you go overboard already and it's probably too late. You should have let go when you had the opportunity. |
No Ex. |
Dem dey tell you make you give your Life to Jesus Christ, you dey do anyhow. Well, Death dey pass your front, prepare for the day after it branches to your side. |
Make dem Sha regulate this skit things |
Hahaha!... Drag FG to Court ![]() Mallam Fintiri, you better begin work on how to improve IGR cos this FG handout wen you dey Drag upandan no dey sustainable ooo. Anyhow wen you and your people reason am, na Regionalism we dey go so ooo and na wetin una fit organize now, una go chop then ooo. Okwia? Okay Bye. ![]() |
Abi she choose to Cohabit with the Guy? But then anyhow wen you view am, the guy dey guilty cos He camp persin pikin for house without permission. |
His Family members will also complain about how Nigeria is Corrupt not admitting that their Own is also part of the Problem. A Country/Continent where Greed, Wickedness, Selfishness... Is part of their DNA. |
I think say dem say those people no be Lawmakers again? Until dem cause Problem for Una na that time una go know the importance of Negotiation and agreement. |
Happy Birthday Prof. Some Children don't know that "Who better pass dem better Pass them". All they do is Drag everybody like Tiger Generator but na dem go tire. |
If ElRufai fit collect small, He go make sense ooo. That Man na orator but Him mind dey very corrupt. Religious bias is one of his major problems and him Son don show wetin really dey him mind towards others. |
Washing Machine full everywhere for Obodo Nigeria, so why the unnecessary brouhaha abi na higi-haga? |
Taaaa! Na joke she dey joor. This Life ehn, you gat just Live and not over bother yourself about alot of things. You want to sponsor your wedding... My sister he go hard before you go see man wen go join body with you because of that condition except na Jigolo. |
Seriously? Abeg make una park well joor. All of una wan use wahala keel one man. Abeg!!! Any man wen try this kain thing, make he just know say na death warrant hin sign. |
Chai! Wike doing things. The people wen dey beef am because Him no support their Candidate bayi nko? But laslas who don pass you don pass you. Congratulations Mrs. Wike. But this Life ehn... See as dem dey arrange demselves ![]() |
Which kind reporting be this bayi? Persin steal 20k, Pot of Soup and other things but na only Pot of Soup una mention. Well, na from one place he dey start. If dem no stop am now, he fit enter politics. |
Hahaha!!! Physical exercise is good. Your handlers must sha give you work to do show that your followers go dey engaged. |
Waoh!!!... This is Very Good News. Congratulations to My Ekiti Kete Folks. Upward and Forward... |
Chai! Starboy of the SE but I can't blame him cos if His Predecessors had implement the Minimum wage, he would have continued to pay it. |
Dem say use 0.1 Litre and Add 2Litre of water to distill before soaking cloth but Baba use 1 Litre undiluted to soak cloth, come dey complain. Abeg park well and go and learn and to wash clothe. |
Sha, make everybody know say wen shit hit ceiling na Everybody go collect. He better make we all reason wetin go benefit everybody. No be to dey find wetin go feed our Greed ooo. #Selah |
Well, if He dey part of budget and dem ratify am, nothing again ooo but Sha, if na you dem give shey you go reject am? Congratulations to people wen dem gift but Sha, oga Guvnor go and give your People the needed Dividend of Democracy. |
Things are happening ooo. Well, one man's meat is another man's... |
We go just dey import anything and everything. But no lele, na to use the Loan do First Degree reach Terminal Degree be the thing. |
Dem give you contract but you dey do anyhow because you no wan finish the project, no wahala. If na Money dey delay you, better go explain yourself and see how you go fit compl9the project sharperly. Those wen wan use those things project this Government for bad light, na dem know ooo. |
Hmmm! May we Never be Unfortunate ooo. Amin! |
Oga, forget that thing joor. Better Hospital full Obodo Nigeria, so go one of them. Na the Country wen you do CBN for almost 10yrs.so make you self enjoy the Healthcare wen you Join sponsor. |
Welcome to Nigeria. I doubt if this happens in any other Country of the World. To trace these things no hard at all but people wen suppose trace am dey part of the Ring. Think About who go Sell am and where dem go sell am, na there you go understand who be the Kingpin. |
Well, Regionalism is on the Table already. Hope you guys will not continue to play games with the Boko things and hope that "Repentant" truly repent cos if not then the people who raise them have alot in their plate already. |
Relocate it to Sambisa Forest. |
Debt is good if Invested. On the flip side, Abeg if you dey owe Loan sharks or any of your Paddy, Abeg park for one side ooo cos you no get the leverage to Yab FG for Debt wen dem owe. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 30 31 32 33 34 35 36 37 38 (of 114 pages)

