Theophorus's Posts
Nairaland Forum › Theophorus's Profile › Theophorus's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 33 34 35 36 37 38 39 40 41 (of 114 pages)
Na LT bus be that ooo. The Drivers of those Uses are in a class of their own ooo, No do mistake follow Dem drag road ooo except say you want Hear stories that touches. Eko for show. |
Oga tenant shey you hear say Country be like wetin hard small? Oga Landlord dey try use the small change wen dey hin hand to keep body and soul together, you dey talk about Sewage Pipe Abeg find money fit that thing joor, later you and landlord go dey run am. If that thing make you fall sick, you go spend pass wetin plumber go take ooo. #peace-health-safety |
Life is not hard and it's not a 1+1 =2 situation. That He doesn't call or send Sms doesn't mean he doesn't love you. Hope say he no dey take something Sha? |
This is Good. Make dem collect well. Atleast, we go fit stop all those brouhaha for our Obodo country. |
Sorry, what is Oshimen? Is it a Angry Bird or A He goat? Abi it is a Banger that after sounding goes mute forever. |
President ooo, Governors ooo, Senators ooo, Reps ooo, Chairman ooo, Make everybody just do one term and comot so that everything can go round. But first make we return to Regionalism. |
If dem talk say LP na PDP SP he go be like na lie but laslas matter don dey clear small-small. Sha, anyhow wen he be, LP go still help APC win the elections as dem go still collect some votes from PDP. Apata na from South na the Excuse wen dem dey push be that. |
Raise people with Integrity una say lailai say make everybody dey do wetin dem like (whatever makes you happy). Client husband Don dey make Lawyer happy and nothing bad but client must not cast her. ![]() |
Chai! Obaseki who do you this thing? You don dey hustle upandan just to snap pix with anybody. You mates dey snap pix of project na this one you still dey snap. |
We know say na cos of Elections but still if you get better sense, you suppose know say except you wan pay 13th month by month end, you no suppose pay salary tomorrow because na Wahala you go put those people. For them to wait till July Ending before another Alert go sound that wan go hard ooo but since election and if Asue no win, you don enter gbege be that, so I understand everything wen you dey do. Just carry on, only say Asue no go likely win cos of your mumu previous actions. |
Wait make dem legalize Guns for this Obodo Nigeria, na them you go know say Hatred wen dey people mind no get part two. |
Congratulations Madam. But Ogwashi no reflects say Great people come from there. |
Lecture here and there; Award here and there Abeg Good Governance na hin we dey ask for. |
Happy Birthday ooo, Oga. Na you conduct elections wen we take get Democracy wen we do the silver jubilee yesterday, so we thank You. The Agenda now, na to return to Regionalism ASAP, make everybody hold hin side. May we for correct the 'error' of Ironsi. |
Good thinking Good Product. Congratulations to the SA people. |
According to some people, they will be expecting "No man's land" week but alas na Yoruba week dem wan do. If you Papa lie to you say Lagos na No man's land, my brother you better use your tongue to count your teeth before it become too late. Na Regionalism dey board now ooo, make everybody dey prepare to go back to him yard. |
Egg wen 1 don dey reach #150 Egusi wen cup na 400 Millet ![]() The 3 of them wen you mention no even fit fill belle at all. You no fit pack dem chop. Abegi!, if he no be Beans then He can never be Beans joor. #BringBackOur Beans. |
Use quality material you no gree. But you dey hope to build Skyscraper so that you go use am Brag. Well, when una teach una children to dey do quality things maybe una go fit build Sky Scraper. Abeg, before some people dey find more States, hope say dem know say na Problem wen their Brother cause with the First Coup na him we want fix so. We go return to Regionalism make everybody hold hin side. #WeRise |
Why he be say some people like Media hype pass Real deal like this. Person never do I Km dem don begin noise again. |
No need for too much talk joor.. Just organize Lawyers wen go serve them and make Police do their work. Anybody wen no wan use their sense must to collect. |
Sirika don enter correct gbege. Next time when you get opportunity to serve you no go do Balablu. |
Having soft hand is not an indication of soft life. The fact be our genetic make up does the thing and there is nothing anyone can do about it. Sha, account Balance dey very important either soft or hard hand. |
What's the meaning of the maxim "Iroko has Fallen"? Anyone who uses that maxim in respect to defection from one party to another... Well, Edo Election is just 3months away. Anybody wen come Third, make he no cry ooo. |
"We should make more friends and not Enemies". Dem no teach Obaseki that proverb at all. I just pity if the next Governor of Edo to Fiddo-diddo am, who will he run to? Well, Elections is just 3months away, and he go soon understand why Oyinbo talk say "Power is Transient". |
Well, the Progress of SW is key. As we are planning to return to Regionalism, necessary prep is needed. SW is not a chest beating region. |
Anybody fit blow, so irrespective of the seeming disadvantages just continue to do the little you can and Grace and Favour go smile on you. |
No wahala, wetin we sha want na make PMS come 150/Litre. |
Make ManU dey watch their back I 8-2 tell that the 8-2 will soon be avenged ![]() |
Well, Life is not hard. Buy the little you can afford. Very soon the Price go come down. Everybody should calm do. |
Oshey! Oya, Obaseki show dem say 2024 no be 1950 wen Oba no dey go market. Na your hand Power dey naw, so use am as you like and oppress anybody but Sha no forget say you go soon comot for Govnor office ooo. |
Congratulations and Happy Married Life. Other Ladies should take a cue from her. If Life give you the opportunity of getting Married, no let wokeness carry you go where you no know ooo. |
When the Righteous proper, the City Rejoice; when the wicked persih there are Shouts of Joy. Halleluya! |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 33 34 35 36 37 38 39 40 41 (of 114 pages)

