Theophorus's Posts
Nairaland Forum › Theophorus's Profile › Theophorus's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 35 36 37 38 39 40 41 42 43 (of 114 pages)
The Lord Keep Us all from every form of Evil. |
"No Champion Forever" make ANC prepare for the beginning of the Ending of their Dominance. Life na turn by Turn. |
Before you begin Yab people wen fail PS exam, make sure say na you write your WAEC/JAMB yourself ooo. If na runs you take dey do exam come dey yab these people that means say you be Hypocrite and na part of the problem you self be. |
Una wen be Govt Workers collect Salary finish come decide to go on Strike. Most people wen dey work for Private never collect any Salary so dem never buy any food for house. No wahala cos we know say una strike no dey last pass 24hrs. |
Thanks to people who provide some cussons for the Students/Nigerians. #This too Sha pass. |
Wike says Hi. But Bros Umahi, you suppose know say na when people need your help dem dey remember you but once you help dem finish like this, dem fit bullshit you. So if help, no expect anything/loyalty, just do your own and go. |
Cos Old Money don't Smell. Na New Money (People wen just begin dey see Money) dey make noise. If you observe people wen just see 3.5km of 3 lane road, you go see say their shout too much, na cos dem just dey experience am ni. Person wen just dey see Big things go dey flaunt am but person wen don old for the game go just quiet. |
Okay, make I go save up to buy my CNG machine. |
Before election go reach, you sure say no be only Obaseki go remain for PDP like this? Abi, Obaseki too will kuku defect back to APC? |
Una dey ask for increase Salary but forget say Purchasing power dey reduce continously due to Inflation. Instead make dem ask for Price control and think of better interventions dem dey think of how to go on Strike because dem no like who be the current NG Leader but laslas we all go learn. |
Bros Reno, Abeg let ElluPe71 boys Rejoice naw. Leave dem to continue their song joor. In the final analysis water go find hin leave and everything will be clear. |
udofia234:Well, alot of things dey wen we never really understand for this world wen we dey so but sha, make dem go do deliverance for that Girl ooo cos with wetin dey happen to her so ehn, she fit no marry till she go die. Just because of Demon wen don use opportunity of her grieve enter. |
Oshey, Oya make una start wetin una like to dey do pass. Una do 8months prep elections, just 14months after elections una wan start another one. No lele, make una Sha start quick so that we can know what to do to Una. |
Why he come be like say na Sendo Camera dey use snap pixtures? Well, Congratulations to una ooo. Make una ensure say una enjoy each of the moment. |
Match of 90+minutes just reach 25minutes una don dey talk Abeg make he reach better level joor. We go evaluate things when time reach, though we gree say heat dey town but still make we get some patience so that we no go rush dey conclude wetin no be am. |
This List no complete at all. Cos in the real sense the list suppose pass hundred. But laslas sha, make we all do jejely because no Champion forever, when time reach you go leave the Center Stage for another person. Bukky Saraki, Dino, Aregbe, Tessy, Ambode, Lucky Igbinedion, Eweta, Obiano etc... The list is endless |
Actually, no be must to write the Exam and alot of courses dey wen dem fit do without Mathematics and if their course need am dem go write GCE or NECO. "In a Town where there are no elders, the people Dere will Balablu-Bulaba." Theophorus 2024 |
He get level wen you go reach, you no go gree chop any bread again except this 20k ooo. For this level wen I dey so, I no fit buy the bread. |
Character and Stereotypes. Learn to avoid some people because Fraud, Wickedness and Greediness na their second name. When you Really Love someone even when they accuse you wrongly, the first point of Call is never a Court but since na Money (Greed/Fraud) Influence joining you can see the result. Laslas sha, Life get as He dey always balance every equation, so in whatever you do ensure you do good/right. |
Oga deputy Governor think say Him be "Headless mob", he go dey talk anyhow just to score cheap points. He better learn say him na leader now and making some claim like that man that talk about 608 Pj's go get consequences. |
Fearurcreeator:Absolutely, Life na about Calculations but this Life ehn. Laslas sha, your head Dere. #1Luv |
Fearurcreeator:Chai! You never meet me before but choose to call me 'Olodo' well na you know ooo. Happy Weekend. |
Blessedpalms Life is quite funny, you get serious with academics so as to have good grades in expectation of good jobs only to realize "who you know is more important than grade" as you see some 3rd graduate work even in Headquarters of Banks. You come to realize that Life can choose to smile on anyone, irrespective of whether you think they are qualified or not. Funnily, those who fortune smile on feel you only lag behind because you're not smart. Just like Arsenal in the 2023/24 season, everyone keeps saying shit but forgot that Arsenal needed just 1 team out of 7 to take just 1 point from Mancity but all failed and claim Arsenal is not ready. Well, God no go shame Us. Amen! |
Abeg, make una carry Yeye surds comot joor. Na Money gangan we need no be mathematics joor. How many Maths Fubara know abi Wike abi Sanwo abi PBAT? I need money no be Surd abi Maths. |
Seriously, is not fair now! Why will a son of man be asked to bring things up to 3M in this present day Nigeria just because he wan marry una daughter? Well, make people stop to dey turn their daughter to Poverty Alleviation opportunity ooo. |
Congratulations to Her. Make everybody sha prepare to meet thier Creator. |
Vanity upon Vani.. Well, Shebi it will reduce the Price of Food and other Essentials? Though those buildings na esthetics and Pride dem be, so me no really fancy them but I no go mind to own one of them ![]() |
SmartNYSC:Good Morning SmartNYSC Please, I need help on the following; 1. If I want to process exemption, how do I go about the registration? 2. When is the registration commencing? 3. What's the NYSC registration website? Thanks. |
Well, Mancity use Epl catch cruise ooo but no lele Arsenal turn don reach to use Epl catch cruise. |
NLC chairman account don Red, so Bros don dey find another way to collect some money and call off the Strike. Abeg, NLC should go and sleep joor. We sabi their way. Even ASUU we'd sabi Strike self don lose Form. |
1970-1997 Abeg these people get time ooo. Abeg, make dem leave this matter joor. |
Once no be you plant-harvest yourself, just forget about checking if na GMO or not except you want make Hunger kill you. Nobody go paste am for the body say na GMO. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 35 36 37 38 39 40 41 42 43 (of 114 pages)
