Theophorus's Posts
Nairaland Forum › Theophorus's Profile › Theophorus's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 38 39 40 41 42 43 44 45 46 (of 114 pages)
crazygod:Are you sure this is the type of Team Liverpool love playing? |
Oshey, Emperor Fubara has spoken. Instead make Baba get down begin work, he dey play politics upandan. You think say those noisy people go save you? Guy, na when your re-election bid start you go know who really dey with you ooo. You better Kool down begin strategise and do project make everybody dey see your work ooo. Well, you fit use "Rivers no be Lagos" campaign sha, and if you people be like those Edo people dem go vote you again. Only say like Obaseki nothing wen you go do for them pass signing of MoU and repair of Streetlights. ![]() |
Eeyah! Day don dey brake small-small. Body go tell una. Shebi una dey support dem before. Una think say na others una Hatred go first kill? FYI, that Hatred na una he go destroy ooo, make una sharperly begin re-orientate una children before dem go kill themselves by themselves. |
Waoh!!! Standing Ovation to the Snr. Ladies |
So, because Shaibu pray for am now na im make Obaseki use am replace am abi? Abeg, make una pack well joor. |
Abeg, make dem carry all these their Yeye politricks comot joor. All of them greedy and selfish people. Sidecomment: Who get Money wen hin no need make he send me some, cos account balance odi too low. |
If we talk dem go say we dey beef another but seriously, make we dey serious for this Country naw! Person Drive from London to Naija (We gree say na strong woman), you turn am Ambassador, give am Car and House. Well, expect more Children to begin some useless adventures. |
Nameless man? Research further and you will realize that these is just one of those online clout chasing things. People doing anything to get traffic and get some $$$. |
Baba don change to Suit. Well Done Mr. Emiefiele, atleast now you don get experience say Nobody dey hold power forever and Wisdom helps one to be careful when it seems as if 'Hand' no fit touch you. Congratulations and hope your Lawyers get better sense to talk better talk, if not na Prison you dey use play so ooo. |
See some comment up there and you read some Ladies saying "The Man was Abusive". So because the Man was abusive, the woman did the right thing by making Him lose all he had worked for 17yrs. To the women supporting their fellow Women in this Act, I wish your Brothers/Sons what you Wish other Men. |
This wan wen City Don collect like this. Before you know now, dem go begin rush Palace. |
RIP Sir. Sha, make everybody prepare to meet their Maker. Live each as if na the Last. Stop this unnecessary Greed/Wickedness cos the Reaper can come anytime. #Repent and find Salvation. |
Oga Wike, You are really doing well. Even if some people claim say na only low density area the Train pass but Atleast you don complete this one, na to start those other area remain. Bros, just continue to dey run things and show dem say na Mr Project be your name. |
When that Obasek* was doing Gragra in 2020 and some person's were supporting him, they didn't know that he would soon do to them what he was doing to others but alas, this is 2024 and they are already 'kollecting' from Obasek*. But laslas Obasek* go soon 'kollect' from those wen hin injure during him 8yrs as Govnor and he go become example for upcoming Children who likes Trouble and Betrayal. |
May the Lord deliver Us by His Mercies from every/any form of Evil, Amen! Please, let's all ensure we observe all safety Precautions and be carefully careful always. Laslas, All men will pay the Debt of Physical Death but not all will pay the Debt of Spiritual Death. Find Christ and Receive Salvation for Your Soul. RIP to Her. |
Oya! Make una impeach am sharperly. But make Obaseki no forget say he don do hin worst and the person wen him injure no go dey use better mind reason hin matter. Sha, make Obaseki go gather all hin Arsenal ooo cos matter don Red for am already. |
I Salute this Kris ooo. Seriously, this kind Love scarce ooo. Thank You for Being Good. |
Oshiomole Vs Obaseki Wike Vs Fubara El Rufai Vs Uba Sani Sha, know for this Life say if you one help anybody, help them with pure mind and no go dey Fight others because you wan help one person because... that one self dey. |
Lamba! Talk is Cheap. May the Best Man win. |
Well, everybody dey find how to trend these days so it's understandable if people just dey talk anything without thinking. |
Ogene001:Look for any of these Books on History. 1. People and Empire of West Africa by Stride Ifeka 2. Africa in the Nineteenth and Twentieth Centuries Edited by Joseph C. Anne and Godfrey Brown 3. A Thousand Years of West African History Edited by J. F. Ade Ajayi and Ian Espie 4. The Rise of the Nation States by F. Agbodeka Any of these books will help you know your History as well as the History of your Neighbors. |
These gifts make Sense die. But some questions wen dey my mind 1. Shey the Guy no get anything for House before now? 2. Who pay for all these things? Shey na Family abi na the Guy dem force to provide the money? 3. Is this the norm in that Community or the Bride Family dey "Saner clime"? |
dominique:I read this your comment, come go check your Profile, na there Naim I take know say You be Senior. Mamoo, Abeg continue to dey help train all the Children wen dem no train well. Thank You. |
Ladipo Boys doing Things. |
Abeg, carry your Daughter Run ooo. Make she no go join body with people wen don sign date with Trouble, Evil and Misfortune. |
Okay, na Business you dey do so no lele. But for Real Life no break contact with your Family because of anybody ooo, make dem no go carry you Handicap. |
Make I see the Mercy pixture first before I go talk but this Baby no really look like this Guy wen carry am at all. Just check only shape of their Head and you go understand. But then wetin concern una wen una dey worry for another person matter? Abeg make una leave these people to enjoy their marriage. |
I just hope say this hype/temporary change of levels never enter this youngman head. Guy, Abeg get to work ooo and lay proper foundation for your Home and Future ooo. This Life na Marathon ooo, no be 100m. All the Best. |
OvertheTop:If the CBN policy doesn't change, then you will have to wait till after 2027 for now. |
If you are holding for the sake of thinking it would rise again, then I urge you to Rethink cos this down wen he dey go so ehn na long thing ooo. |
Well, hin own don meet am. Dem go soon replace am with the First Runner Up. To those of you thinking through your Tribal/PoliticalParty/Candidate prism, I urge that you realise that the Law does not look through any of those prism. |
Finally! Day don Break for Una area. But, wait ooo, I think say one Govnor say na Business Model be Kidnapping for Kaduna and Kidnappers are 'Business people'. Eye don dey clear small-small say "Who throw stone for Market, hin family fit break head from the stone touch" |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 38 39 40 41 42 43 44 45 46 (of 114 pages)
