Theophorus's Posts
Nairaland Forum › Theophorus's Profile › Theophorus's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 36 37 38 39 40 41 42 43 44 (of 114 pages)
But Naturally the Igbos are not know to be united naw. It's that lack of unity that inform that style of Geographical settlements before the Advent of Modernity and Formal Education in that locality. Observe they are not really united with anybody or anyone except those they can leech on a the time. |
Train-Teach you pikin ooo, make he no go become problem to area. |
42 Years? Wen you suppose don invest for your Obodo Ghana and go back after retirement for UK. Well, my Nigerian pipu Abeg make una try put small investment for our Obodo country incase USD1 become NGN20.00 |
For PR purposes or what? Well keep doing the visiting, maybe by 2031 it would count. |
saddler:Okay, we have agreed there God. I am a Christian, so please point to some of the errors in the Bible. Probably I can gain more understanding of your point. |
Sincerely na only mumu dey talk say "God no dey". How you go talk say this wonderful design (world) no get designer/Architect? |
1. Men won't flock around you forever 2. Early married is Goodcos there is really nothing to enjoy on the street. 3. You can't get a good boy with Burna-Boy abi Portable swag. NB:Essentialone, Oya credit my account cos I don provide answer to your question. |
Me just read somethings just dey laugh. Make Fubara dey enjoy hin two minute fame go, once hin boys change their Reggae to Blues, he go know how far. Ordinary First year you never do, you don dey fight upandan. Wetin you for just calm down do your thing and make good name for yourself. Shebi you see wetin dey happen to Obaseki now? |
Ofunaofu:Eyaaa! Don't worry, you will soon heal. Pele ehn. |
We know say the Southwest na the best side naw. Na dem dey hospitable pass and na their weather make sense for this Obodo Nigeria. |
Gaming Phone for this Weather? Abeg no time to check time joor. Time must be invested approximately. |
Chai! You mean say Obaseki no get anything to Campaign for Asue again, na to dey pay people to public Beer-Parlour talk remain. Chai! When Obaseki dey do gragra he no know say power dey transient, now day don Break for the Guy area, intoxication don clear for him face. Welcome to Reality Mr. Obaseki, just shout again say "Edo no be Lagos" and the Children of Hate will follow up you. |
Na person wen him own meet go fit explain wetin he dey experience. Make Good things dey happen to Us all the Time. Amen! |
Well, we sabi people wen dey rent house but after first payment dem go begin form Vandame and dem no go gree pay rent. Dem dey always think say dem wise but laslas dem dey collect. May Isaac, leave dem make dem continue their way very soon their Trap go catch them. |
Most Nigerians like Fraud pass anything. Na thru dem dey chop their daily bread. Their salary na 120k but daily dem dey do fraud to make 150k but dem go still Blame polithiefians like say dem no dey do Worst. Bankers wen dey do USD roundtripping and na Aboki dem dey sell give. You wonder why Fx plenty/readily available for Aboki hand but he dey Bank? See ehn, the matter long. |
To those of you following Social Media to decide wetin dey happen for your home and to those of you listening to your Frenemies and taking advise from them, Abeg make una read and apply the wisdom. This Life no be straight line ooo and no go dey rush behave anyhow because of wetin dem dey tell you ooo. A Bird in hand is Worth more than 10 on the Tree ooo, no leave the 1 wen dey your hand to fly away ooo. |
Oboy, dem her people don donate to her, so that she can continue to feature her Daughter in her content for the perverts to view. The little girls she is suppose to be training not to follow her whacked way of Life, she is already introducimg them to her wokeness. Abeg, make the Guy collect those Girls from her sharperly. |
Finally... |
Kobicove:Your 'Head dey there'. You na Senior Man, cos for you to know say we nickname the guy 'Okada', then he mean say you don dey enter your 40's. Respect Bro. |
1year is gone and you're busy fighting imaginary Battles with People who do not really matter. Wisdom is choosing your Battles not in Gragra. Your Predecessor is called Mr. Project, what would we call you? Mr. Fighter? My brother, those children of Hate beating Drum for you will soon change their Raggee to Blues ooo. |
If you no get who go fight for you Abeg no just dem push Fake news ooo, make dem no go carry you go where you no know ooo. No let make your Bitterness control your brain to your hand to post Iberiberism ooo. #Okbye |
Some part of these talk make sense wella but still on still na Persin wen get better eyes go fit decode and apply the knowledge wen dey this post. Kudos Aweda |
Make I go find money buy some 10Acres along that Coastal road wen PBAT wan construct. I go use am as stop over picnic arena for people and tourists. |
Oshey! Mr. Speaker, continue from where Oga Governor stop. Sha, make all of Una remember say una get less than 5months. And Person wen wise dey always avoid wetin go make the number of enemies wen hin get increase. Once PDP-LP loose this election, I hope say una go fit bear the consequences of these una actions Sha. |
No go dey talk abi publish wetin you no know because you want paint the Govt Bad ooo, cos Freedom after Speech Nobody fit guarantee that one ooo. Nnammudi Kwanu still dey hostel for Abuja because he go dey talk anyhow. |
You should have open the account with your Permanent home address, that way you use the Nepa Bill of your PM. But still on still na the Fraud wen those boys dey do cause all these wahala. Just be patient Sha, gradually the matter go sort himself. |
Wny we just like some spurious talk for this Country like this? INEC disenfranchised gini? Abeg, who wan register make he go INEC office, no be to dey disturb us with Iberiberism. |
Abeg, who get ChelseaFC scouts phone number, I go like call them make dem come Recurit me for their Team I can help turn their Fortune around. |
Chai! Wetin be this naw? Abeg na another Ritual? Abi na another invention of the wokeness of this generation? |
Congratulations say you don comot. This Country go good and na soonest he go happen. |
Hmmm, person Daughter na hin some people do like this ooo. You wen dey support Yahooboys and Hookup girls shey you see now? You will calling them Hustlers but their Hustle na Wahala he dey create for another person abi Family self. Abeg, make everybody Sha Train their Children well to avoid Story that Touches. #Shalom. |
Mr. Adelabu na man you be but Nigerians no like who dey talk Truth. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 36 37 38 39 40 41 42 43 44 (of 114 pages)
