₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,330,441 members, 8,445,484 topics. Date: Wednesday, 15 July 2026 at 07:25 AM

Toggle theme

Theophorus's Posts

Nairaland ForumTheophorus's ProfileTheophorus's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 55 56 57 58 59 60 61 62 63 (of 114 pages)

PoliticsRe: Akpabio, Speaker & 2 Others Padded Tinubu’s Palliative Budget - Sahara Reporters by theophorus(m): 6:11pm On Aug 13, 2023
All these people no just like this Countree at all.
Wetin dey their mind na to just loot everything till the forever but dem no go succeed Sha.
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Chelsea Vs Liverpool (1 - 1) On 13th August 2023 by theophorus(m): 1:32pm On Aug 13, 2023
Who go win?
The Blues or the Reds?
Well, make we hope say both go fit arrange play better soccer for this season.
PoliticsRe: Alleged ‘Coup’ Against Obaseki: My Story – Deputy Governor, Shaibu by theophorus(m): 5:27am On Aug 13, 2023
Eeyah! Philip, sorry ooo.
Obaseki don dey show you wetin him do him other benefactors.

Obaseki wen get 1yr left as Govnor still dey create unnecessary wahala because na wetin him be be that.

Sorry ooo, Mr. Philip, just manage for now ehn, all will soon be over. This na lesson to others, avoid Toxic people ooo.
PoliticsRe: Shaibu Welcomed In Edo Labour Party — Chairman, Kelly Ogbaloi by theophorus(m): 4:11pm On Aug 12, 2023
Chai! Dem don dey use oga Deputy catch cruise. Unfortunately if him do mistake join those Ellupe69 people nothing for am again be that ooo.

Make He just humble stay where he dey for now until coast go clear to move based on negotiations.

Next time when you see people with Obaseki kind of Character dem no go tell you before you go Run.
FamilyRe: How Some Men Package For Marriage And Deceive Women by theophorus(m): 3:51pm On Aug 12, 2023
FOR THE SAKE OF YOUR SANITY NEVER REPLY ANY OF KOBOJUNKIE POST.

On the ongoing matter, Na Mumu dey marry Man because He dey spend on top Her. She be correct Mumu. If She leave the guy next person wen she go marry go be Yahoo boy or Thief because na wetin dey attract Her be that.

Man wen use Front and Back or Skin color as Criteria for marriage go likely marry "wahala Promax".

Change you values and you will attract people like You. Check well, that Girl na from that Tribe wen like Money pass their anything.
PoliticsRe: Uba Sani Rejects El-rufai’s Ministerial Candidate Tells Tinubu To Expect Another by theophorus(m): 3:34pm On Aug 12, 2023
Chai! Nobody wan associate with El Rufai again.
El Rufai, na fall you don dey fall so ooo. No expect any come back again.
Foreign AffairsRe: Nigerians In Niger Beg FG For Evacuation Over Impending Attack by theophorus(m): 8:53am On Aug 12, 2023
Wait ooo, just read the comments from OP's post and you will understand that those people do not want to leave Niger and they spite Nigeria.

Make those people rest for Niger, there is no point coming to Nigeria. France is Far but Nigeria is close by, so it understandable why France had to evacuate her people.
PoliticsRe: Drone Pictures Of Senator Dino Melaye's Awareness Campaign In Kaba by theophorus(m): 8:20am On Aug 12, 2023
Oboy see as everywhere just full as people plenty dey Ride Okada.
Those Okada go reach 10,000 self.

Yeye and Iberiberism, Kogi people no just get luck for this matter.
PoliticsRe: How Yahaya Bello 'lobbied' For Ministerial Appointment In Tinubu's Cabinet by theophorus(m): 6:38am On Aug 12, 2023
Though, I agree with this speculation cos Yahaya need something to keep him from Efcc wahala and He is still young and need a position to continue chopping National Cake.

But that Yahaya na pure disgrace, so make Efcc help us trouble am well.
EducationRe: FUTO ASUU Sacks Chairman by theophorus(m): 9:49pm On Aug 11, 2023
If ordinary Chairman of ASUU FUTO chapter came make some quilty of Financial Misappropriation, then imagine when that man becomes Govnor.

Look in the Mirror and you will understand our problem as a Nation.
RomanceRe: Rate This Architectural Work. by theophorus(m): 6:37pm On Aug 11, 2023
Respect but then the number of windows makes it seems not there or here.

But then I will rate it 55%
RomanceRe: Woman Pays N5,000 Revenue Fine In Anambra For Not Wearing Bra by theophorus(m): 6:31pm On Aug 11, 2023
Agboro people on the loose.
PoliticsRe: Biafra Will Be A Country Of Coup And Counter Coup by theophorus(m): 6:05pm On Aug 11, 2023
Just go Alaba and you will understand that those people go get plenty issue for thier area once dem get wetin dem dey cry for.
PoliticsRe: PEPT Judgement Before September 16 by theophorus(m): 6:03pm On Aug 11, 2023
Chizaam2008:
Go to the INEC and verify!

Plus disqualification on at least 5 grounds.
Only ONE MAN HEAD!

Perjury ? OWA!
Forgery? OWA!
Double nomination? OWA!
Invalid nomination? OWA!
Forfeiture? OWA!
Dual citizenship? OWA!
TREASONABLE FELONY AS A US SPY? OWA!
Sealed criminal FBI file? OWA!
You will think people who claim they won elections should prove it but unfortunately na disqualification dem dey cry for.

But seriously, how person no go get situation room to dey follow wetin dey happen for polling booths? Well, I just say those PEPT guys will not Bill those Lawyers wen scam Mandate brouhaha people.
PoliticsRe: Lnt’l Youth Day: Edo Youths Laud Obaseki For Green Skills Training, Commitment by theophorus(m):
Kai! So na this Lamba, Mr Godwin still dey do.
Well, since all him people sabi say na Lamba/Bobo Govnor dey do, everybody don join the trend.
TV/MoviesRe: BBNaija: Venita Accuses Pere Of Peeping And Standing Behind Ladies In The Shower by theophorus(m): 5:52pm On Aug 11, 2023
Abeg make una pack well joor.

Una dey act po*n still dey complain say una dey naked and wetin be the result of watching po*n no be wa*king?

Yeyebrities and Iberiberism
PoliticsRe: Ogun PDP's Lawyer Says He Is Handicapped As Tribunal Dismisses His Application by theophorus(m): 6:41am On Aug 11, 2023
He shoke am?
Well, before you start ensure you do critical and sincere evaluation.

Don't be like some people who are shouting "All eyes on the Judiciary" but couldn't prove their claim of winning any election except to ask for disqualification of the winner.
Foreign AffairsRe: Chinese Company Stops Construction Of Niger's Kandadji Dam Over Sanctions by theophorus(m): 6:40am On Aug 11, 2023
Why you go dey waste your time and fund to build wetin fit blow up in seconds?

Abeg until some Peace and Sanity returns to Niger, there is no point investing any money there ooo.
PoliticsRe: There is no IDP Camp in APC: Oshiomhole Reacts To Obaseki-Shaibu feud by theophorus(m): 9:43pm On Aug 10, 2023
Oshiomole support you to do Gov or but you decide to destroy him political career.

Wike support you against Oshiomole but after winning you decided to destroy Wike and PDP.

Shaibu loyal to you but you don begin dey show pepper.

Edo people give first 4yrs, but na MoU you use am dey sign.

Edo people give you another 4yrs, na Streetlight wen no light anything you use am do.

Well, after your Gov or wahala na Wahala Promax you go enter cause your enemies don too plenty.
PoliticsRe: Obidients Drags ALEX OTTI For Not Purchasing "Made in Nigeria Vehicles" by theophorus(m): 7:41am On Aug 10, 2023
When you no plan say you go dey replace am every 3month why you go buy substandard Chinko products? cool
PoliticsRe: The Berlin Wall Tinubu Is Building Among Two Huasa Territories Must Collapse by theophorus(m): 7:40am On Aug 10, 2023
Do small research and you go discover say that Alexbells na those our people.

Abeg, leave ECOWAS to fight for Democracy and stop all balablu-Blubala
BusinessRe: Naira Inches Towards 1000 Naira To A Dollar by theophorus(m): 7:40am On Aug 10, 2023
Abeg make people who need am dey buy am go until he go dey excess for ground and he go begin crash till he go reach #50. cool
PoliticsRe: Portable And His Boys Beaten Up By Lekki Boys (video) by theophorus(m): 12:54pm On Aug 09, 2023
Beat ke?
How? With 2by2 or UTC? Abi Horse wipe?

Abeg make dem carry matter comot for here joor.
PoliticsRe: Inferiority Complex Is Pushing You To Make Harsh Decisions – Yesufu Blast Tinubu by theophorus(m): 7:36am On Aug 09, 2023
You go think say some people dey use their sense well until sentiment enter their reasoning.
Yesufu, Abeg use your sense well and stop reasoning like some children wen dem collect their bread.
PoliticsRe: Bus Drivers In Anambra Lament Extortions By Touts Despite Paying Tax To Gov’t by theophorus(m): 7:35am On Aug 09, 2023
Even for thier backyard MC Oluomo dey rule dem cos na only Lagos get those Agberos.

Dem go begin claim say na only Lasgidi get Agberos but hand don touch them now, dem do begin talk True.
Foreign AffairsRe: We May Be Pushed To Invade Niger — US Tells Coup Plotters by theophorus(m): 7:18am On Aug 09, 2023
All these threats ehn.
Peace ooo, na wetin we all want be that ooo.

Cos if he happen who no go, go know.
PoliticsRe: Niger Republic: A Word Of Caution To The Dogs Of War" ~ Femi Fani-kayode by theophorus(m): 7:16am On Aug 09, 2023
Broda Femi, good morning ooo.

Abeg, park well cos you no be security expert and you've never been strategic with your personal chooses so leave this matter.

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 55 56 57 58 59 60 61 62 63 (of 114 pages)