Angeldada55's Posts
Nairaland Forum › Angeldada55's Profile › Angeldada55's Posts
Why are these pipu like this sef ? Nigeria no get head o... All our politicians are power hungry pipu, self centered and they like to oppress. They sabi act movie ehn...dem go sti do ham korokoro for your eye cx dem know as e dey go pass most of us. We go just gather here for nairaland dey complain. Suffering and smiling... And some pipu don turn dull baby cx poverty hold dem for prick. Dem dey use me and you play and we sef no send cx na hussle sure pass as e never touch us...lol We nor unite for this country walahi ; aproko naim we all be. See all of us for nairaland � Iffa talk now, e go be like Oshiomole na my guy |
MyVILLAGEpeople:...like say you dey my mind. Iffa talk now, e go be like pesin na wizard. |
One pesin go just dey do well small small and pipu go don like ham cx dem dey see hin money chop then BOOM their messiah is a *Fraudster* I don talk ham before, and I go talk ham again. Nigerians and FRAUD are like 5&6 !!! I no talk say the man do ham o cx America sabi play some kind yeye play sef... Iffa no talk now, e go be like the man do scam true-true |
I don't understand... No story of wetin dem do at all ? Iffa talk now, e go be like something else |
Nigerian and fraud are like 5&6 !!! Ole ni everybody !!! This Is what the government is making of them ( nigerin youths especially ) all. They ( leaders ) are the ones teaching ( the youths ) these things ( they made them criminals in disguise ). Who do una sef for this country ? The thing now don turn *inbuilt* or lemmi say its in their DNA to do SCAM as Nigerians. I just dey pity the country... Iffa talk now, e go be like say I be foriegner !!! |
So he was killed for selling just Tramadol ? Iffa talk now, e go be like pesin head no correct. |
If pesin talk now, e go be like pesin no go school... |
Gather here if na just comment you come here come read � I wan tell una something... Cx Iffa talk now, e go be like pesin na "jigolo" |
...Hmmmm Which drama ? The one for school gate ? Se the girl no fi talk dat year or even mention drama teacher name to take make gateman even believe her ? Or the "black belt mama" no fi just tell gateman say na drama she wan come do for school ? Why force the matter to a fight ? See, make una no dey whine over this matter o !!! Wetin she do no good cx school get rules and regulations for students to follow and the gateman do hin job well but I have nothing against the poor girl... " owu ti iya gbon, ni omo ma ran " Thank you, NEXT !!! Iffa no talk now, some pipu no go get sense. |
daddytime:Hmmm... You have spoken well "daddy" � I for just waka pass but the likes you got on this comment catch me again and as me sef no come dey stingy...I gaz dash one better like join � ...make I talk cx Iffa no talk now, e go be like something else. But I no go buy land for this. So, you go borrow small space make I take pass my message sharply abeg � I'm sorry o, but apart from say he too dey react to "house help" or "chores" matter, I hope any other thing no join ham ? However, as a man wen dey do well before wey things come turn out as e be so ; e get as e dey affect psycologically. In fact, nor be all men dey fi gather strength fight the "trauma" so he honestly need YOU ( the wife ) more now ! He could be frustrated...and you know what that means right ? So, my own small advice na say ; make you no try hold ground too much with ham on anything or whatsoever. Just try as much as you can to always put a smile on his face Cx I see say you be better wife. Make you find a way, make sure the kids have a kind of relationship with him more, now that he may feel lonely even as una dey inside house together ( you should know as a man, he go wan dey show ego ) so the kids are your weapon to get some things out of his mind truly. But ehn, forget telling much about him to people...just put your family in God's able hands in prayer. In fact, you go dey pray more now Cx devil sef fi get hand inside this matter ( God forbid sa ) And lastly ehn, no EVER say you too tire to feed him ( you know what I mean right ? ) A word they say... Iffa talk again now, e go be like na me wise pass. God bless... |
Ok How she no go begin *shade* wen she don get wetin she nor expect for her life. Pesin wey nor get sense, who suppose dey roll for floor say God sti count her join pipu wey go do something for life. I have nothing against her mind you ; before una begin run mouth. But, as dem wan suffocate us with her matter wen no concern us, make we sef kuku begin analyze her ways and see if she be plus ( + ) or minus ( - ). I mean, what are these people trying to teach the younger ones ? Na so dat one go begin fight for pikin wey fix eye lash go school wen get rules... Anyways, na so tomato dey turn stew. See Titans everywhere, dia role model dey burst teeth cx she don hammer...ehhhh � Iffa talk now, OP go say make dem BAN pesin |
As I no come be last born nko ? Iffa talk now, pesin go say I no dey relate. Hit like if you are the second in the family... |
Ok...e be like dia two dey try cx we dey see result ��� Coach, It's AFCON or NO CORN o !!! Iffa no talk now, he fi come forget wetin carry ham come as coach of the super eagles. |
The special one !!! ��� Iffa no talk now, e go be like pesin no know the man. |
Funny set of pipu !!! Uncle Bode wey no get shame. After the rigging, he go carry the money enter church for proper sharing and followers go sti wear ANKARA follow dem... "Zombies in uniform" Iffa talk now, pesin go say na one party I dey support. |
Ok... I come dey pity the man sa !!! And Iffa talk now, pesin go say I dey one sided. Hit like for sowore. |
The topic alone reach to talk about... I no need read the whole hand out sef. Now, *matters are rising* ; 1 trillion ke ? Iffa talk now, pesin go begin swear for these men wey no get conscience and fear of God !!! |
Wetin be this one work sef ? Which kind office dem dey sit for here sef ? Iffa talk now, pesin go say I no know anything... |
Gather here if the only thing that caught your attention is the money. I come dey wonder as I fi take transfer dat kind money from my mind to my bank account direct. Iffa talk now, pesin go say I too like money. |
Na wetin this one dey use money do be dat ? I hear o... Iffa talk now, pesin go say e no concern me. |
Ok let's be nice... I suggest we gather or raise some money for the sick. I wan donate 1k Na Whuch pesin akant I go send ham put ? Iffa no talk now, e go be like we are all the same with the "Sorry comment". |
Na wetin pesin no go see for Naija news... Na for this country I see say everybody dey depend on government for everything !!! How this kind business go dey wey dem no go put things in place in case e sup ; se dem don call fire fighters ? Iffa talk now, e go be like pesin dey mock hin own country pipu. |
Benclever1:My sincere advice is to NEVER try it o. Se this one don forget "apple" wey bible warn us about ni ? Fear gehs wey no dey like consoms o ; dey sabi finish pesin destiny quick quick !!! Wetin you wan kick start ? I pity your life Cx e go come dey sweet you till you finally hang your sef for the real rope when matter go sup. Iffa talk again now, e go be like pesin dey talk from experience. |
Mynd44:You kuku don talk my mind... And Iffa no let you know now, e go be like say pesin copy you. So, no need to go buy land for this again... Your head Is there � |
Ok... Make e no be like say pesin see ham he no talk. |
I hope say this dull baby sef don promise never to come Naija again sa ? If not ehn, make he nor just try ham !!! Na me gan gan go come for ham... I go show the #bastards of Africa say ; a GOAT will always be a GOAT !!! And "the boy" is truly a GOAT. Iffa no talk now ehn, pesin no go know say pesin don dey vex. |
She fine o... Iffa no talk now, e go be like pesin dey bad belle the geh. ...win the competition and come home with another crown. #Adedimeji |
Wetin aboki no go see for gate ? Iffa talk now, pesin go say I dey too harsh. |
Na two types of pupil dey the school. 1.) Intending olosho ; future slay queen and baby mama. ( picture below ) 2.) the one you just saw in the news Iffa no talk now, e go be like pesin no dey follow the news on nairaland.com
|
The general overseer has spoken !!! Iffa talk now, e go be like pesin no dey read bible. |
Where the uncle wife today ? Iffa tell you now say ; No justice in the world. You go believe ? A rapist can marry a murderer, have kids and become rich in life. #Karma fast asleep !!! However, #Grace does not prevent pains but gives the victim the resilience to bear it. So, those who are in pain should endure. Nothing is guaranteed. No one is special. Anyone can die, have an accident or fall sick. You can loose your source of income or money in business...life is uncertain. Bad things happen to good people ; no explanation to this !!! It's part of the chaos in the world and nobody understands how the world works. God isn't omnipotent in the literal sense... Iffa no talk now, e go be like pesin never see something inside life. ...happy she's alive though. |
Local boy is frustrated and also giving up on himself !!! He actually thinks that's the only way out...lol Now, he will be forced to pay back and he go come put hinsef and family to shame. Na wa !!! Iffa talk now, e go be like pesin never do bad before. |