Came's Posts
Nairaland Forum › Came's Profile › Came's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 11 12 13 14 15 16 17 18 19 (of 81 pages)
Madam, go marry make we see how you go handle your own marriage... Too knowing home breaker giving advice.. Yeye dey smell. |
I no been no say this kind fat dey this woman body, some people just need to add weight to look beautiful , see as she come fine now. |
Wetin that grammar way Okotie speak mean self, because me i no sabi that grammer ooooo, na grammar go carry person enter heaven... Wife he no get, children he no get, he just dey marry dey pursue them.. Na only wahala he sabi do. |
This woman gather nose ooooooo!!! |
Person way don get 2 sons with different baby mamas,,we never no weather 3rd baby mama dey unload self... |
I dey wonder how this lady go take push out banky's baby if the baby go take head resemble him papa.. Hmmmmm!!! |
Wetin una expect from person way Alomo be him best drink, maybe the alcoholic content inside Alomo don make am high, him come think say mercy be punching bag. |
I don think wetin she do way fit warrant that kind beating, highest he go say she pursue another man, but that one still no warrant that kind beating at all.... Na wa oooo , how person go beat person pikin like that....most men who do this knows that no family member of the woman is strong enough or rich enough to confront them.... Doooohhh mercy. |
Mercy snatch her own come start to dey born sharp sharp make she for born all her children for one man incase gbege finally happen. They like ready made men them, na him be the koko. |
T-Boss: Tiwa, i beg,make i snap selfie with you,no say No pls. Tiwa:hahahahahah,,no wahala, you self don be star now. |
Banky wife no get yansh , but she fine. |
I love Empress,she is cool and articulated. |
No be hot drink dem say dey follow spoil kidney? Hmmmmmmm!!!. |
Madam,i wonder why you decided to make this beating open,,because no be today this man don dey beat you, he go beat you buy you plenty gift,,,,Hmmmmmm... He be like say you don catch another big man, abi the beating don tire you? |
John Njemah, no be the brother of empress Njemah be this one... Hmmmmmmm...... You try advice your sister not to marry that musician way been dey beat am ooooo, if not na your sister you for write for now. |
Mercy no even let bimbo relax for the relationship,,she snatch the man straight.If to say she let am relax, she for born too... Bimbo, I happy say you don born with your new man. |
People reads meaning to everything, na wa oooo... The man is a gentleman, and would not have done what he is accused of. |
Some go even carry camera men go to snap them make dem for show the world say dem give. |
Na dustbin she pack for body abi wetin. |
Why this woman lie say she no do butt implant ... Na wa oooooo . |
I hope say her papa abi na pama go fit wear this kind dress as she be woman now. Yeyebrities. |
All this show off na wa oooooo.... Papa king, hope say you dey see am, make you self think of something to show off with ooooo, na una way . |
You will realize the value of what you had when it is gone,is the lesson Chris has learnt, and many are in such situation too. |
She no hide the baby face like other yeyebrities them.... |
Dem put AC for outside ke! Hahahahahaha ... I laugh fall for ground. |
"you are the reason i wake up everyday,ready to see another day" so you for commit suicide if to say you no born this baby, Hmmmmmm, it is good we always give God the praise,people die in their sleep,so no one should say waking is his/ her power. |
This oyinbo people too dey give their children too much freedom, see as this boy spoil him teeth say na fashion, with the way he looks i won't be surprise if he has started smoking something.... |
This people life get as he be, how person no go waka freely for the rest of him life... Na wa oooooo. |
My dear forget that man, because he no truelly get your time, he no love you at all. |
Make una tell this man make he stop to dey murder English...You see am when nobody no am, that is why you wan kill am because now people don no am. Na wa for you sir. |
Why she carry matter go to Oga at the top, people way dey handle this kind situation no dey this country again? |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 11 12 13 14 15 16 17 18 19 (of 81 pages)