₦airaland Forum

Welcome, Guest: Register • Login • With Google • Trending • Recent • New

Stats: 3,344,636 members, 8,512,901 topics. Date: Wednesday, 04 November 2026 at 08:19 AM

Toggle theme

Favour32's Posts

Nairaland Forum › Favour32's Profile › Favour32's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 231 232 233 234 235 236 237 238 239 (of 262 pages)

Crime › Re: Policemen Who Assaulted Tola Azeez Dismissed In Osun by favour32(m): 10:45pm On Apr 24, 2020
Many years later, these men go show from nowhere and still dey police but dem go transfer dem go far from where the matter happen.
Naija na you want trust?
Crime › Re: Policeman Kills Policewoman In Rivers State During lockdown Enforcement by favour32(m): 5:36pm On Apr 24, 2020
otokx:
no controversy if you see Police find way disappear
Anytime I see dem, I dey hail because na mumu many pass.
Most of their I.Q dey below average...na mumu brain.
Politics › Re: Abba Kyari Tried To Clean Up Nigeria, Says The Economist Of London by favour32(m): 5:34pm On Apr 24, 2020
Na only Nigeria nai you go see who die become saint.
Who be the bad people?
Crime › Re: Policeman Kills Policewoman In Rivers State During lockdown Enforcement by favour32(m): 5:23pm On Apr 24, 2020
Wey charlatans nai many pass for Nigeria police,how the killings no go dey on?
Police killings and covid19 deaths, we nor know which one we go fear pass.
Family › Re: Share Your Stay At Home Experience With Your Partner. by favour32(m): 5:10pm On Apr 24, 2020
Lockdown sweet die!
I dey oil my two kpekuss every time.
Both dey try to return the favor by arranging well prepared food to refresh my system grin grin grin
Phones › Re: Which Network Provider In Nigeria Has The Fastest Internet Connection? by favour32(m): 1:28pm On Apr 24, 2020
No one you go support.
Na location nai matter.
Know the one wey good for your area.
Crime › Re: Nene Steve & Joy Aboel: Housemaid Tortured To Death, Hanged To Fake Suicide by favour32(m): 11:32am On Apr 24, 2020
If you use as woman face pass judgement for woman mind, nai be say you die well.
Health › Re: 108 New Cases Of COVID-19 Reported, Total 981, 197 Discharged, 31 Deaths by favour32(m): 5:31am On Apr 24, 2020
landmark86:
Dis getting serious I must say.
See what dis useless government have cos us.
Lock airport dey no gree.
They wait till dia friends & family returned. Bringing in the virus for the poor ones.
Now dey are locking us down. Suffering the poor masses.

My brethren, let no deceive ourself, dis lockdown thing will last for long oooo.
Make we remain strong in the Lord cos na we call for CHANGE in 2015 so make we enjoy am 2geda.
Buhari wey sacrify Nigeria because of e daughter.
Politics › Re: Deacon Femi Adesina, A Shameless Sanballat By Bayo Oluwasanmi by favour32(m): 5:25am On Apr 24, 2020
Nor blame Femi Adesina.
Femi Adesina na SLAVE!
Wetin slave dey do?
To serve MASTER!
So,Femi Adesina dey serve him MASTER wella for him belle.
Politics › Re: Burial Of Galadima Modu Sheriff: Social Distancing Order Violated by favour32(m): 5:09am On Apr 24, 2020
Northern Nigeria wey dey predominantly Muslims, dey controlled by this religious dogma,
na Allah bring na Allah take.
Make any Muslim correct me if I dey wrong.
So,nai make many nor dey send about covid19(especially the illiterate and ignorant ones) even if dem say e dey deadly.
Romance › Re: Runs Girls Are Getting Better Husbands Than Church Girls - Lady by favour32(m):
lefulefu:
u guys are going to the extreme cheesy
labelling naija ladies as either runzgirls or extremily religious or born again ladies
hope u know there are ladies who are in between
the not so religious girls wey no dey carry pastor for head but they are decent too
such girls can be flexible as well and are receptive towards guys
Of course,those who do not conform to both extremes are infinitely small in percentage.
Although,you are right in your inclination but those are exceptions!
Jobs/Vacancies › Re: 5 Job Hunting Mistakes You Should Avoid In 2020 by favour32(m): 12:06pm On Apr 23, 2020
Covid19 survival first until 2021.
2020 sweet for ear but bad for eye!
Romance › Re: Runs Girls Are Getting Better Husbands Than Church Girls - Lady by favour32(m): 5:48am On Apr 23, 2020
I nor know the authenticity of the statistics.
But for me, why e nor go be like that sef?
Runs girls na typical Nigerian person, anywhere belle face and money must come out. But make una know say, runs girl na human being too.During the course of her business,if she meets who she like wella and go want to permanent the kpekus for am as far the person fit marry am and take care of her.
For church girl, their matter too hard.
Modern guy nor dey like bureaucracy or bottleneck processes wey dey related to church girl.
Questions wey dem dey ask pass any exam.
The worse part, "let me pray about it and you should be prepared to see my pastor".Na so dem dey tell most guys.
As the church girl dey delay, guy man don see runs girl wey cheap dey nak easily. But he come later dey fall in love. Before you say "Jack Robinson!"
He don dey crase for the runs girl to marry her becausel she dey cheap to am.
Na those days nai dem believe say girl wey hard to get nai good pass. But now,girl wey cheap nai dey easily marry.
Na when e be eleventh hour, nai church girl dey become flexible, already e don late as old age don meet am.
Most of dem full churches looking for husbands.
When church girl dey very young,who toast am,
dem go say na devil come tempt dem.
For my advice,I nor support runs girl nature,in fact I hate runs girls!
But on the other hand, make church girl dey flexible or receptive to guys because you nor know who God say na go be your husband.
One day for church, pastor say, he see for him revelation say 7 ladies dey here wey dey look for husbands. Besides,some of the ladies dey relationships but anytime e want lead to marriage, the relationship go scatter,make dem come out for alter side make he pray for dem.
Me dey expect about that 7 ladies wey the pastor talk.
"Una know how many come out?"
More than 20!
All those ladies wey dey dress wella wey I dey think say na men wives na spinsters!
I open mouth!
God dey complex!
Nai him know who him like pass irrespective.
He dey give some people grace however wetin dem do For example, David for Bible.
So,e dey possible for a runs girl to get grace of a good husband.
Church girl make una throw away una questionnaire and rigidity,e nor dey pay again.
I nor say make una be runs girl o because I even hate runs girl matter.
Na so!
I hail.
Politics › Re: Governor Umahi Bans The Sun, Vanguard Reporters From Ebonyi Govt House For Life by favour32(m): 2:01am On Apr 23, 2020
Na you accuse, na you prosecute and na you pass judgement.
Wetin come be function of our court?
This governor crude sha.
Romance › Re: Should I Lend My Boyfriend Money? by favour32(m): 3:10pm On Apr 22, 2020
Men!(Especially the unmarried ones).
You see now!
Table turn now for money matter this female dey ask nairaland if she fit borrow her boyfriend money.
I nor believe this publication.May be na fictional.
But if na reality or fictional, make men learn o.
90% of men dey help their broke girlfriend 24 hours.
But when table turn,the world go hear especially Africa wey e dey happen yagayaga.
Avoid greedy girlfriend.Many nor dey good as wife.
Wife na helper.
Crime › Re: Police Arrest Delta Pharmacist After Lady Was Stripped For Stealing by favour32(m): 2:50pm On Apr 22, 2020
divineRx:
This man is a shame to the Pharmacy profession and he should be severely punished
Na the wife be pharmacist.
The man na Lukeman grin
Crime › Re: Police Arrest Delta Pharmacist After Lady Was Stripped For Stealing by favour32(m): 2:46pm On Apr 22, 2020
Period007:
He is not,believe Nigerian journalists at your own peril
Na the wife be pharmacist.
Politics › Re: Family Members Can’t Receive Double Money, Says FG by favour32(m): 8:54am On Apr 22, 2020
Una dey sabi copy copy.
How some part of Europe take post €800 to their citizens for lockdown convenience?
This Nigerian government led by a cabal don taya to copy when e reach to give directly to Nigerians(citizens right to palliative) for this lockdown?
Na their mouth you for dey hear say poor get branches or classes or parts!
Na so onyinbo do am?
Na everybody rich for onyinbo land?
Why dem share money/food without absolute discrimination?
Blackman for Africa mind black true true.
Nai make dem dey paint DEVIL black to resemble black man.
Politics › Re: Sadiya Farouq: FG Will Use BVN To Identify Poor, Vulnerable Nigerians by favour32(m): 7:59am On Apr 22, 2020
Black Africans wicked die!
Palliatives don get discriminations too.
Everything for their lives get comma. Covid19 dey select customers. Nor be everybody dey vulnerable?
If some part of Europe can share €800 @every interval for lockdown, why this government Nigeria nor fit do am flat rate 20K for everybody.
The convenient people wey dey among such online transfers through BVN fit return theirs or give the less privileged neighbors.
European countries dey discriminate when dem dey post €800 to their lockdown citizens?
Why discriminate?
I pray well well.As una dey discriminate so,make covid19 discriminate to those wey dey wicked so Nigerians because na only their people and their belle dem know.
Politics › Re: Adamu Adamu To Replace Abba Kyari As Buhari’s Chief Of Staff - Sahara Reporters by favour32(m): 10:07pm On Apr 21, 2020
Babagana Kingibe get history.
The man dey take off leave who him and am follow as he detect upheaval grin grin
Na wayo man o
E dey him gene
Politics › Re: Coronavirus: FG Blocks Five Governors From Flying Out Of Nigeria by favour32(m): 9:56pm On Apr 21, 2020
Why not call their names.
This hide hide nor dey help Nigeria.
If na onyinbo, straight dem don call names.
So their citizens go know the wayo governors wey wan run go hide.
Business › Re: Lockdown: I Visited Shoprite In Ikeja And It Was Empty (Photos, Video) by favour32(m): 9:48pm On Apr 21, 2020
pyyxxaro:
Naaa who don chop belle full they go Shoprite oh


I see some guy men today , one de on top the mango tree , the other ones hold stick de stone mango


Wahala de oh kiss
For our side, na one young woman wey dey below 30 years, nai climb mango tree with bamboo dey fall mangoes.
I know say na sell she wan sell dem.Bc d annoyance wey she dey fall those mangoes, nor be here o as na no man's mangoes.
Romance › Re: Her Mother Said She Can't Marry An Ebonyi Man by favour32(m): 10:19pm On Apr 20, 2020
Nor ever force love.
The girl dey show you affection b4 bc you be her ATM problem solver.
Now she don dey free,so she wan exit.
Never beg anybody for love.Show love if you nor get the receipt,move on.You go later happy for your decision.
God even help you say this wahala show before anything bc if you marry her, no peace.
Waka bo, love full everywhere yagayaga.Go find am.
Travel › Re: Coronavirus: FG Extends Airport Closure By Two Weeks by favour32(m): 9:01pm On Apr 20, 2020
Humanoid01:
Kini expertraites nitori Olorun?
You go taya for the mata grin grin,grin
Family › Re: My Wife Has Turned My Children Against Me by favour32(m): 5:43pm On Apr 20, 2020
Oga find your way or else na danger you dey as she and her kids don declare you enemy.
Anywhere you dey,find a way to dey post money for dem. After some years,
dem go know wetin dey.
First rule for life na self preservation. Anything less than this na waste of time.
Crime › Re: Lady Disgraced And Filmed For Stealing Milk In Delta State by favour32(m): 12:49pm On Apr 20, 2020
Na woman get that store but she dey heartless.
She thinks she can do anything because the younger brother,Raymond Ugbakor na Delta state governor boy.
Wetin the lady wey thief do bad.Why not peacefully hand her over to police let the law take its course?
I nor know why this woman wicked to your fellow woman.
Must you naked her?
Of course,she go deny say she nor know
anything for the matter but nor be order wey she give down dem go follow?
Politics › Re: Abba Kyari’s Burial: Momoh Defends Presidency, Says Mourners Cant Be Chased Away by favour32(m): 10:20am On Apr 20, 2020
Brainless government!
Na una talk say copse killed by covid19 will not be released to the family.Then,una pass back release Abba Kyari copse to the family.
Double standard government!
Nothing wey nor dey una hand.
All the mumus wey go look cinema for the burial without PPE go spread covid19 for Abuja and its environ.
Mumu nor good.
What of that king of mumu wey video capture so, wey dey pull off PPE?
Dat man nor go school if e go at all, na dundee.
Na block heads nai make up the bunch of aids for Aso Rock!
Nigeria dey wahala with primitive people wey make up government.
If na better government,na 5 people nai go secretly bury Abba Kyari with PPE without any stress as ordered by government.
Una nor see how people wey dey advance for everything dey do their own?
Na so so last una dey like to carry.
Who see una dress go think say una be better people.Dem nor know say na brainless monkey nai dress so.
Comot here with una mumu�☠️
Foreign Affairs › Re: Pollution Dropped, Himalayas Visible In India After 30years From 125miles(Pics) by favour32(m): 3:12am On Apr 20, 2020
Chuzoetoh:
you wetin you don surf sincehuh Nonsense man. Comot here joor!
Nor mind that stupid person.
Bad belle.
Wetin you nor go fit do wey other person dey do instead of you to hail am, you dey envy am bc others dey hail am--Orue!Ozuo!Ewu!Oyemu!Obolo!
Crime › Re: Navy Exhumes Remains Of Missing Officer In Ebonyi by favour32(m): 2:45am On Apr 20, 2020
JudasNaCarrot:
Honestly....I always ask this same question because Ebonyi people are too primitive to be called Igbos.
Their ways and culture, the kind of house and food,dialect are all primitive.

Their governor is the worse of all the governors and that is why Wike dislike him like plague.

Nonsense and ingregients
You don hear dem dey speak their Igbo language?
If dem go deep for language other Igbos from Anambra or Enugu go shout say "hmm, we nor understand una language!"
Politics › Re: "Abba Kyari Influenced Anambra Federal Projects & Refund Of 30b To Anambra" by favour32(m): 2:26am On Apr 20, 2020
If every dead person for Nigeria na saint,who be the bad person?
Christianity Etc › Re: Social Distancing At MFM Church In Aba Today (Photos) by favour32(m): 9:33pm On Apr 19, 2020
What is wrong with Nigeria that is so primitive?
A country with larger percentage madcaps!
Health › Re: 68-Year-Old Woman Delivered Of Twins At LUTH (Photo) by favour32(m): 8:42pm On Apr 19, 2020
Many nor know IVF and dey form smart. grin

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 231 232 233 234 235 236 237 238 239 (of 262 pages)