Theophorus's Posts
Nairaland Forum › Theophorus's Profile › Theophorus's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 40 41 42 43 44 45 46 47 48 (of 114 pages)
Congratulations Obaseki at least you can count this as one of your Achievements. Cos most of him achievement na just political battles here and there. Make Obaseki go reinforce for the main elections cos matter just start. |
Me just dey wait make Obaseki hand over first before him go come collect full dose of wetin him give to others. Obaseki really prove say Edo can Never be Lagos. For 8yrs Obaseki no complet any project. He use first tenure sign MoU come use second tenure repair streetlight for only one street upon all the streetlight no last 2weeks. Obaseki go soon learn why Oyibo talk say 'power is transient'. As for Shaibu, anything web him eye see, make he manage am. |
This Asue Ighodalo na better person but forget this Election ooo, cos Obaseki don too spoil ground and him fellow politicians dey wait to teach Politics 409 |
Chop better! Na indomie a whole man dey chop. Find better Apu/Garri with Better soup chop, down dem with Better Sachet water wen dey room temperature. Buy Apu 300/ 3 cups of Garri But that same Fish 350 Big Green Vegetables 200 Pepper 100. Na better value for money be that. |
AqualinaXYZ:Kikikikiki, some of Una dey rejoice as bad things dey happen but Una forget say wetin Una wish others go soon be Una portion. |
Okay |
Dem don carry Akpata handicap ooo. Baba think say Ellupe71 dey different from PDAPC but he forget say all of them na Nigerians dem be and Na inside Blood all the Balablu-Bulubala dey. |
Kai! Government job good small ooo, just wake up one day declare strike cos you no like condition of service after every every dem go still pay you. |
Women wen dey sell Bread, Pure water, Kulikuli, Pawpaw etc... Take the money send pikin go school and build house no dey register their business. Na all these Wig sellers dey register business wen no fit employ them not to talk of employ another person. Abeg make we throway these Yeye stats joor. |
You take decision come dey expect make everybody like the decision for this Woke generation? Madam, Abeg you Fup ooo |
Can a man fight for God? Can a man defend God? Well, if a Man has to defend His God, then that God is no God at all. |
Well, that will only be on the short run. Guys go soon gather all the money wen dem need to move. Laslas, if you get opportunity and the road clear, Abeg Japa. |
Even Sowore don dey Lamba ElluPe71. |
Dem no even advise this girl as she pose for picture see the lips like thick ponmo. But why some people dey behave like this? Why spread your seed anyhow/anywhere? Must you enter any/every hole? Abeg make una dey put sense for this thing small-small. |
Hope this create the necessary economic effect and make things easier for the common man. Let hope this will not go the Nigerian way that makes everything to fail and never yield the expected effects and returns. Congratulations to Nigeria. |
If dem no train you from home, no worry cause the Street go train you wella. Shebi you think say everything na Cruise, you go wake up begin talk wetin your eye no see because your Party no win elections. No worry, when hand touch you, you go get sense. |
Well, He be like this Boy get better advisers cos this to see person still humble like this scarce. Sha, use this your small fame well so that he go enter New levels. |
Okay |
Okay |
Finally, I don agree say Wike is not Nice at all. Abeg na wetin dem dey pay their staff I want make Govt look into |
Self Love is Key. You should atleast Love yourself enough not to kill yourself because of some Fo*lish 'boy'. Have a focus, Have a Life Have a Purpose, Have a Vision Stop letting one Yeye person be your Inspiration for living. |
NB: When you are successful people would look for things to point to as your strategy and strength but if you fail ehn, forget ooo. |
Veenbanks:What Do You See? |
Hmmm! It important to face one's calling and get involved in some brouhaha. |
Life happens. May God keep Us all from every form of Evil. But wait ooo, why this Diri of guy come look like Ambode like this? |
From the last statement, these are few deductibles... 1. The Woman no dey cook for the Guy, so the no dey chop better. 2. The oza room is not open to the Guy, the guy only get it whenever he's a "good boy". 3. After this week the guy should not expect those "largess". |
Instead make una jejely dey una house dey drink Garri and Kulikuli, una no gree. Now una don enter 1-chance for political games of throne. When una comot from this one una go learn to maintain una lane. Fubara think say everybody go be like Buhari, wen kip kwayet let that Streetlight-MoU Gurnor dey misbehave anyhow. Unfortunately that MoU Guvnor don dey regret hin gragra now, cos he get less than 10months for office. |
You probably would never know or have a hint of how much effort some people put into what you Rubbish. Laslas, it only when your effort yields the Right result that people will celebrate you. Na why dem dey talk say who Pass na hin know book. |
Hmmm! The things Lack of Money causes ehn... But then all these small boys wen no get sense wen dey let Konji control them na another problem dem be and those girls self wen no fit control their legs. If we fit control F*rk rate, then Birth rate and this menace can be easily controlled. |
There are reasons why the Procedure for Marriage begins mainly with Introduction Ceremony where Families and Friends of both parties are supposed to come together and familiarize themselves. Break the protocol and you would have yourself to blame. Some people are already F**king and Impregnating and aborting for their Cousins without even knowing. |
Once dem talk, you go understand the Prism wen their reasoning pass through. |
If you no be Pastor and you dey wear Suit for 2 out 4 Sundays then, he mean say you no too get Native attire. Suit on Sundays na like uniform for Pastors. But wetin pain be say this writer suppose put color combinations wen persin dey wear for suits. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 40 41 42 43 44 45 46 47 48 (of 114 pages)