Theophorus's Posts
Nairaland Forum › Theophorus's Profile › Theophorus's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 44 45 46 47 48 49 50 51 52 (of 114 pages)
Na True, we never see any paparazzi from His Excellency recently. Uncle Adeleke, how far? Shey make I send Aza for Christmas Giveaway. |
This Life no hard, na make you self no make am complicated for yourself. But still on still why Nigerians no dey gree leave Power even when dem dey die dey go? |
He be like this Jagaban time go bring Alot of Trophies come our Obodo Nigeria ooo. Sha, make 1USD = 1NGN quick ![]() |
Eeyah! Una think say na "Kemi Adeosun" una dey follow talk? Make I remind una, say na Jagaban be President ooo and na Wike una dey deal with ooo, una no fit see Draw ooo. |
Emotional Intelligence odi very poor. |
Alaga2222 Chaigozien Amuwaigwe Dafresh Tishbite42 Zeebuy Nonhuman Abeg how una see this matter like this? |
Thank you Lord for Sound Health. |
I agree that the PMB failed in a lot of Aspect. But for this Road things ehn, Na A1dem get. Big relief for our Brothers who will be visiting their Village during the festive season. #Season Greetings Everyone. |
Yes ooo. This would be a good strategy. Produce more Doctors and Nurses and let dem Japa to send more Fx home. Win-win situation. |
Fubara, I just dey laugh you ooo. Ordinary 1yrs you never do, you begin de Bobo your people. Road you no do, employment you no do but Politics na hin dey play. Well, 2027 no far again. |
Some of these matter just get as he be. If you eliminate all the people wen dey Dat picture now, replace them with fresh ones, na still the same result you go likely get. But no lele Sha, make we hope say these people will do right and we go all dey enjoy but Laslas nothing really dey this life to enjoy joor. But Sha, it's better to smile inside PJ than inside Keke |
Well, this minimum wage thing no dey reach those of us wen no dey FG payroll? |
Abeg Asari, leave Oba alone ooo, make he catch cruise. If you enter UniBen, na wetin dem go still teach you for their History courses be that ooo. Dem go say na Benin Kingdom dey rule Lagos. But, we understand say na everybody like better thing. Even the Eastern people self dey claim say na dem develop Lagos. |
Eggplant is good for Pregnant women especially from 7month upward. But Sha no lele, aside Tomatoes and Apples others na once a blue moon things. When I become more wealthy some go become normal things. |
No just Trust anybody for that NANS ooo. All of dem be bad gang ooo. Virtually all of dem na Papa dem be ooo and na Scammer be their second name. |
Eeyah! Sorry ooo. Greed na hin dey kill you small-small so ooo. Instead, make you allow another person be Governor while you do the ground work, No na you wan be Governor still be National Secretary. Bros, Abeg parkwell joor, wetin don go, don go already. |
If he pain una, Abeg make una relocate to Niger. But, as things be so, we no dey reason Niger matter for now. |
Before nko? Wetin una go talk? Abeg, make PDP park well joor. All politicians get same problem. |
The number of Private Universities that will close down once their Proprietor "change address" ehn. Well, by 2033, if this world never close, you go hear things like "I graduated from the University... Wen don close shop abi na fold up self. ![]() |
EmperorTolson:You better stay with your 70k+ That mutual benefits things na Scam ooo. To confirm, just retain your 70k job and start freelancing for the Mutual Benefit and see if you will get any deal in 3months. |
Soory, but Abeg follow the Therapy that will help solve this condition. Health is Wealth ooo. |
Hope these people realize say they just render some Women as Widow and some Children Fatherless? And the Women and Children of those Men will never pray it should be well with them. Hope they realise the those Police Officers are fellow Nigerians suffering like them and they probably have Parents and some other dependants? Well, when Karma comes visiting, na that time dem go know. RIP to the officers and May God in His Mercies send help to their immediate families. |
Una don start Yeye Campaign again. Abeg, make una parkwell joor, make better persin come do Govnor joor. You and Obaseki na Scam una be, make una carry una Waka comot make we get fresh hands. |
Gradually She go join Her sister's for Street, then Gradually those boy go use her upgrade. Shey, she dey find excuse, her younger ones go her experience take learn. Make everybody Sha train their pikin well, so that dem no go disgrace dem for public. |
Getting issues more complicated. I hope this issue will be in the good side and no wrong thing will happen from it. |
Bros-Bros... So na today day break for your Area abi? When you get less than 12months abi? "He said the IGR growth would come from leveraging its comparative advantage and exploring opportunities in technology, culture, manufacturing, and agriculture, among other sectors of the state’s economy." This talk na just English and nothing else. "We have done a lot with cassava and ethanol as well as oil palm in the agricultural sector. We have worked hard with partners to open up the retail space in Edo State and hopefully, before the end of the year, we will be launching about 60 shops in the Benin Mall with different facilities." Garri, Ogogoro and Shops na hin you want take increase IGR? Chai! Obaseki who do you this thing? Unfortunately, you no get anybody wen you go blame again and you don throway Broom and Umbrella so wetin go clear dirty for you no dey and wetin go protect you from Rain and Hit Sun no dey. |
Children of this age ehn, if una spoil this life finish, na una know ooo. |
Congratulations on your Birthday. But, please use the remaining years of your Life to do what's right and please don't come back to contest again in 2027 cos it's clear that you have been more of a spoiler for some people. Happy Birthday once again and please engage more in Charity as from now on. |
Chai Uncle Godwin really mess up ooo. But no lele, Sha, make una wen dey there now begin clear the mess. |
The Lecturer should kukuma change the name of the course to Sxxology instead of Sexuality cos these questions are more about Sxx than Sexuality. |
NPF doing things. Just give dem small money dem go arrest anybody come use bail money drink. Sha, for this Life avoid Business Center and Any person wen dey run packaging things. |
Abeg wen those conspiracy theorists them? How much was paid to procure this Judgement? Is the Judiciary still corrupt? Abeg make those people help with their Abracadabra permutations make we know how much was paid by whoever to procure this Judgement and the brief about the relationship between the Judge and CJN. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 44 45 46 47 48 49 50 51 52 (of 114 pages)
