Theophorus's Posts
Nairaland Forum › Theophorus's Profile › Theophorus's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 42 43 44 45 46 47 48 49 50 (of 114 pages)
Put the words out, ask friends and families for connects. Atleast, if you no be bad person, you suppose get who fit house you for 1/2weeks before you go arrange. Shebi na just to manage sleep and wake up. |
Shey you say you no wan get sense abi, when you use some days for Prison, you go dey remember say Landlord and Tenant no be mate. Yeyenatu, hope say your people go gather money go collect lawyer cos this one wen you enter so, na Season film ooo. |
Well, this does not apply to only Girls but Boys also. Boys now Sag their trousers to reveal thier dirty underwear and be walking like pikin wen shit for body. Boys plates hair and add coloured beads like those our 3yrs daughters. Boys now were Boxers and carry crossbags from one place to another. They wear slides and socks up and down. So the Yeye dressing thing na wetin Lack of home Training don cos already, unfortunately those without home training are already birthing their own kids. |
Kai! Not even Our Jayjay? Mike, we understand your plight ehn, so no worry. But we go encourage you make remove that bais prism wen you dey take look front. Peace! |
Good Atleast make we all stop those Yeye things dem. |
This matter na Season film. People wen dem collect money for their hand before dem make dem Caretaker, Baba don sack dem sharperly. I hope say people no go, enter her house to request for the money wen dem pay her ooo. |
You will only choose not to build with someone whom you don't Love. But see ehn, if you Love someone you will choose to Biuld with them. Though, by Experience na who F-up for relationship dey suffer am Laslas. |
Okay, make we Sha dey observe. Make we see as everything go dey unfold. |
Sha know that, that your Wife go begin drag everything with you for that House, if una marry. And you go ever fit control am cos she dey forge her own way of doing things, even if he dey awkward. So, except say you ready to be the Wife, best thing na to abort that mission. |
Congratulations Bro. This your Babe set small ooo. But Abeg, no put your Family for Social Media ooo, make all them Social Media Inlaw no go use mouth scatter una home. Congratulations once again. #Happy New Year People. Abeg, who get #10,000,000 wen he go like use do Giveaway? Make the person contact me ASAP. |
How far Japan? Make una contact Me, make we sell some part of this Country to una joor. We no get any Natural Disaster for here, na only Leadership Disaster we get. |
dibunotion:If this is True, then wait for 'Life', it will give him His reward in Full dose. In the meantime, Congratulations to Him. May those homos/confuse gender people never get to you. Amen! |
jojothaiv:Absolutely, with God impossibility is nothing. God and the Specialist for Miracles and He go do am for Us by His Mercies. |
jojothaiv:Shey dem tell you say I no know where dem dey sell am? Abeg, na person wen go dash me I dey find joor. I don't tire to dey use legedes Benz and na family man I be so na motor wen dey family inclined I dey find. |
thesicilian:Guy, we may find Gold in the strangest place ooo. But no lele send me you address make I waybill some Kulikuli and Kunu to you cos today na Boxing things. ![]() |
I sometimes Dress down instead of Bafup. Abeg, who get Sienna 2018 Model wen he no need again, He fit dash me the Car. Thanks. |
Chai! See as person dey plan Movement to prevent Wife wen Him marry from destroying him? Ladies/Women shey una see wetin una yeyenatu don dey cause so? |
Choose to wait till you are able to get the Driver side sit. If you're rushing sit beside the conductor and once the person in front drops, just enter front. You may also choose to Start Transport as a Business, you drive yourself and make money by taking passengers along. |
The Koko na to enter either of the two. But if na Blank cheque, I go gegely take the US. |
Alcohol no be your mate ooo. Run!!! |
Once dem talk to much just know say na Scam dem be. Train you pikin well ooo, make she no go dey hustle inheritance so they she and her in law dem go become public topic. |
Nigeria Justice matter, na the more you look the less you see. It's also important to know that Justice is usually sold to the Highest Bidder except in some exceptional cases. The Lawyers should also keep milking their Magas by telling them they can claim White is Black. |
Native Wisdom requires that you ask about the parents of the Lady your son brings home so that your son no go enter one chance. During Introduction ceremony you should also get more understanding on the nature of the family. |
Well, make he pick himself up, look for somewhere to stay for a week and start rebuilding gradually. Life is good, it will give you bountiful harvest of what you sow. |
I wish I fit gift myself 2010 Toyota Corolla but Man never get money. So I go just chop my Rice and Poultry like that. More importantly, Christmas is about Christ and the Salvation of Mankind and the Indwelling of God through the Ministry of the Holy Spirit. #MerryChristmas |
It's not as if you haven't gotten over her. It's just a clear indication that you really Loved her and still do. It's only shows that you were not after her "cookie jar" abi na "HoneyPot" but that your intention were good towards her. Facts is if you really Love someone, your hardly forget about them even when they are gone. So let me say here that you would still remember her. But, then let bygone be BYGONE. She is in the past, so leave her there. There may be occasional flashes but then she is in the Past so leave her there. Just pour your emotions and Love into the new relationship and let your Love be towards the one who truly wants you. #MerryChristmas. |
Sowore, you no Nice at all ooo. Up on all the collect wen PMB people dey Collect from BAT, you still want BAT to arrest PMB? Guy, Mercy small naw. Don't worry, BAT is teaching some people how not to be Unfortunate. |
I don go come back self and I still go, come back by January. |
Okay |
Okay, but painting a plane to scam a Nation is right? |
Why should you be looking for Wealthy for men up and down if you're not an Olo###. Well, make you dey careful make dem no use you upgrade ooo. |
Finally, when you refuse to control you mouth and your mouth help to control you. Learn, that it's what it is and it will not always Favour you. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 42 43 44 45 46 47 48 49 50 (of 114 pages)
