Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,831 members, 7,810,200 topics. Date: Friday, 26 April 2024 at 11:19 PM

Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! (70122 Views)

Can You Marry A Lady Or Guy Who Already Has A Child? / 6 Places You Should Never Toast A Nigerian Girl / Advice To That Babe Wey Say Her Guy Gives Her ONLY 1K (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (39) (Reply) (Go Down)

Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naijaboiy: 10:38am On Jun 20, 2015
My people how far?

I create this thread make we woo anybody we like(e must not be your crush) for pidgin english. Some guys wan woo some girls but dem dey find am hard to use correct english.

So na your chance be this. Mention any guy or girl wey you like and use pidgin english take woo her.

Make I open floor. cool

PS: Language on this thread should be strictly pidgin english cheesy

10 Likes 2 Shares

Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naijaboiy: 10:38am On Jun 20, 2015
______ how far? You know say I like you well well? Anytime wey I think about you my heart dey do "jibi" "jibi". grin

But you no dey try for me at all. sad
You go just dey form for me up and down. You see that your smile,,e dey melt my heart and your eyes dey so sexy. smiley

I dey like read your comments because e show say you carry brain well well and you no dey ever disappoint me. Sometimes sha you dey look for my trouble,,but I dey forgive you because say my heart no fit hate person wey l like. wink

I go take you go dubai for shopping and we go stroll for paris,,catch siesta for carribbean beach and chop dinner for Italy. Your car go be german and our pikin go be twins. cheesy

Reason all these things and make you tell me your answer. No keep a guy waiting. cool

31 Likes 7 Shares

Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by peeparty(m): 10:40am On Jun 20, 2015
cool





cc
honeygirl17
mzztega
adeh39
midehi
gifttracy
Aminat508
ginawest
mzlaurel
jollyjoy
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Hazardd(m): 10:41am On Jun 20, 2015
make i observe cool
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Nobody: 10:42am On Jun 20, 2015
undecided
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by yorubaboiy: 10:42am On Jun 20, 2015
[size=13pt]lemme too do my wooing sharp sharp make i no go turn omoge wey no wear pant

*clears throat*

nwa mo....bkos of you i no fit slip i no fit chop ,as i dey always think of you my brain dey always do me wayo.....anytime wey i c ur profile pix ehn,my system dey always restore back to default settings....
i no go mind to be the ewo soup to step down your yam
d only banga to step down your starch
your loff just dey do me tinini for body
if you no mind,abeg make i park my small car in your garage.....

your one and only yorubaddest grin
cc prettythicksme aminat508 mhizel introvert [/size]

7 Likes

Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naijaboiy: 10:44am On Jun 20, 2015
yorubaboiy:
edo pple and pidgin shaaaa
Na we own am grin
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by dharay99: 10:44am On Jun 20, 2015
lipsrsealed
tut i saw it musnt b ur crush.
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naija1stpikin: 10:44am On Jun 20, 2015
Every night wen I don sleep, I dey always face one high hill for dream. Guess wetin d hill be? Na aminatu508 yansh o cry
E dey be me make bulldoze your yansh with my weapon of mass destruction but liver dey cut me. I wish say you go fit let me enter the promise land like Joshua and path the Red Sea with my rod like Moses. If I don see your pic my heart dey melt like salt wey dey for rain. I no know wen I look back like lot for inside bible wey make me turn salt wey dey melt. If you fit gimme chance, I no go chop you rush rush like hungry mechanic, walahi Na fvck and knife I go take chop you.
Pls no say no to my toast make man pikin for no go drink cement
I ruv you kiss

Cc naijaboiy

19 Likes 1 Share

Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by jonaifame22(m): 10:45am On Jun 20, 2015
Hey babes how u dey na,I just dey feel ur signal 4 where I dey, omo mehn u make brain die,I no fit jst bear d tin again na him make I disco come meet u so,my name na john, e go sweet pieces if me and u fit just go take peppersoup tins later for evening dat kind 7pm tins,I believe sey u na soji gal because u be uptown babe,as I dey look dis ur eye sef, I no sey u dey reason me sef , no fear o, me no get wahala make I get ur control so I go fit call u lerra,u 2mch babe,okay na lerra tins,u're blessed.

6 Likes 2 Shares

Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naija1stpikin: 10:46am On Jun 20, 2015
So who dey crush on me?
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Nobody: 10:47am On Jun 20, 2015
My @dey do jibi jibi got me laughing i swear cheesy cheesy

3 Likes

Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naijaboiy: 10:47am On Jun 20, 2015
Kingtom
Alberto2k
Orijin101
Jacksparrow0100
Tosyne2much
Stephenqueen
Misssclassy tongue
Ladyboss1
Twaci
Tomfrench
Adeh39
Deejavuu
Truckpusher
Afapecharis
Ronald4lif

E.t.c... e.t.c...e.t.c

1 Like 1 Share

Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naijaboiy: 10:48am On Jun 20, 2015
dharay99:
lipsrsealed
tut i saw it musnt b ur crush.
Yes it mustn't cheesy
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by dharay99: 10:49am On Jun 20, 2015
peeparty:
cool





cc
mzztega
adeh39
midehi
gifttracy
Aminat
ginawest
mzlaurel
jollyjoy

is daht all,
Was expecting like 50tags.
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by stephenqueen: 10:49am On Jun 20, 2015
Make I cum woo ishilove grin grin grin

4 Likes

Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by elantraceey(f): 10:49am On Jun 20, 2015
Sonofmark come show your skill grin
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Nobody: 10:49am On Jun 20, 2015
heheheheehehehe..chaii
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naijaboiy: 10:49am On Jun 20, 2015
misssclassy:
undecided
No be everything be english.

Type for pidgin sometimes. grin
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naijaboiy: 10:50am On Jun 20, 2015
prettythicksme:
My @dey do jibi jibi got me laughing i swear cheesy cheesy
HeHeHe grin
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by lekinz(m): 10:50am On Jun 20, 2015
Na today I go woo elantraceey
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by peeparty(m): 10:51am On Jun 20, 2015
Midehi:
heheheheehehehe..chaii
I dey wait
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naijaboiy: 10:51am On Jun 20, 2015
jonaifame22:
Hey babes how u dey na,I just dey feel ur signal 4 where I dey, omo mehn u make brain die,ino fit jst near d tin again na him make I disco come meet u so,my name na john, e go sweet pieces if me and u fit just go take peppersoup tins later for evening dat kind 7pm tins,I believe sey u na soji gal because u be uptown babe,ias I dey look dis I self, I no sey u dey reason me sef , no fear o, me no get wahala make I get ur control so I go fit call u lerra,u 2mch babe,okay na lerra tins,u're blessed.
Bros who you write this one for? grin
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by agarawu23(m): 10:51am On Jun 20, 2015
baba God na you get the glory o, if no be Nl eh, how I go take meet this my oyinbo pepper soup joy wan mama grin babe na you let my head dey kolo since the time wey I jam your moniker.
nne eh! make you just take me the way I be na, you know say money no be love embarassed .

I dey ready to spend all my dollar for your head if you go be my one and only. joy biko afurunginaya shocked grin
I don ready to meet your mama & papa so that our love go enter another level wink

I know fit chop without u embarassed
I know fit sleep without u embarassed
all my body just dey do me like say dem nak me jass embarassed
yesterday instead of make I pour water for kettle, na ground I dey pour am as your love don enta my brain embarassed

hope say you go give me chance make I show you say na you be my lost coin jollyjoy sad sad

8 Likes

Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Nobody: 10:51am On Jun 20, 2015
shocked shocked shocked



undecided undecided undecided
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naijaboiy: 10:52am On Jun 20, 2015
lekinz:
Na today I go woo elantraceey
Oya drop am. grin
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Nobody: 10:52am On Jun 20, 2015
Typing.........
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by peeparty(m): 10:52am On Jun 20, 2015
dharay99:


is daht all,
Was expecting like 50tags.
you want more?
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Shamstiel: 10:52am On Jun 20, 2015
Ladyboss1 how far now?
I know say we never rap before but I just wan use this opportunity tell you say I gbadun your swag. I no too like to dey yan long tory but e dey do me like say make we gather dey for real life

Make I wake up for early mohmoh make you be the first person I go see. E dey do me like say make I run my hand through you hair and see you dey blush one kin one kin...make I kiss your ponmo lips and enjoy the sweet sweet flavour whey dey inside am...

I wan make we dey plaii like bread and bama or like fat and oil. I just want make I be that person whey go bring smile to your face anytime you dey think about me smiley

12 Likes 4 Shares

Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Nobody: 10:52am On Jun 20, 2015
naijaboiy:

Na we own am grin
chess! It seem that is ur area of specialization.
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naijaboiy: 10:53am On Jun 20, 2015
agarawu23:
booked
This one nor be Front page material o. grin
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Nobody: 10:53am On Jun 20, 2015
Ori ife...the only love dat has an head

Anytime i wey i see u na so i dey fall yakata in love, my heart go dey do like say e wan tear my body and tear my cloth join so dat e go fit enter ur own make e become one... e just be like say make i grab u and carry u go house

i want make u be the ororo for my sardine, my 1, my 2, my 3 and my only...

i ruff you from the ground of my heart...oya talk ur own

2 Likes

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (39) (Reply)

Man Catches His Wife Cheating In Hotel, Disgraces & Batters Her Publicly (Video) / "Meet Escobar Smith, a moving Bullion Van who doesn't use calculator when Spendi / 12 Things Couples Still Won’t Do In Front Of Each Other (even Afta Years 2geda)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 31
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.