AmAlbert's Posts
Nairaland Forum › AmAlbert's Profile › AmAlbert's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 11 12 13 14 15 16 (of 22 pages)
karryn:My sis I dey hail o, I see your vacancy so I say make I apply, the boyfriend wey you dey find na part time abi full time, and wetin de pay be like.. Cos my condition now no need explanation at all *sips dogonyaro and aki awusa |
ikbnice:Kikikiki Kikikikikikikikakakakakakaka ![]() Laff don make me think say OBJ & TINUBU na the finest men for the world Bros abeg sidon, you fit kuku lie down for bench sef make me I sidon for ordinary ground NA AC and swimming pool phone I dey find to buy sef I dey reason a. say e be like Naija near Sun well well *sips dogonyaro and aki awusa together with alligator pepper and kulikuli plus okpete with Oga IKBNICE |
Mummy ko, mumcy ni, SMH for some pipo sha, una no know una mama and Papa? Na everybody be una papa and mama, rattle snake brain everywhere.. I no call anybody name o . *sips dogonyaro and aki awusa |
Mbok add fullstop(.) Gbam, una reply dem well |
ALAYORMII:Na small world, shey you fit trek am? Abegi no be only... This world too big make I tell you infact the size Na extra excessively excessive excess large XXXXL *sips dogonyaro and okpete |
Una dey see am? Dis woman for England embassy for Togo here no gree gimme visa for 2 times now.. Upon say all my documents and details dey accurate and complete.. One day I go travel go this England, if I catch am ehnn na only God know wetin 2 of us go do Pipo just dey wicked for fancy |
The particular thunder wey go fire pipo wey sentence Dis innocent man to prison wrongly dey house dey baff him children, the thunder na family thunder and e no to only fire dem e go barb dia biabia ![]() BTW the truth be say dat money too small, but abeg if any of una see the half of dah money abeg try lemme know maybe I nid am badly.. *sips dogonyaro and aki awusa |
My most respected colleague in the industry, sir I hail you May you waka and neva Jam rock and even if you wan jam something make e be be endorsement deal.. *sips dogonyaro and aki awusa |
ikbnice:Haba bruh you still dey ask? Abeg which type of Maggi you need, Star, Royco, Knorr, Onga, abi na AjinoMoto bruh I get all, you fit still add yam, Moringa and Okpete so that the taste go come out well wellI hail you bruh, how ya end? Hope heat neva bleach you? Meen i just dey think say if the heat reach this country I go just begin dey swim gutter if I no see river, Dan, Lake or swimming pool *sips dogonyaro and aki awusa together with alligator pepper and kulikuli plus okpete with Hadura29 |
MY GEE DEM SAY NA..... YELLOWBAR... GEH Kikikiki Kikikikikikikikakakakakakaka ![]() *sips dogonyaro and aki awusa |
I dey always tell them say once you dey street use 99%intelligence and 1 %ruggedity dem no dey hia, now see as all of dem just dey kick bucket one by one.. *sips dogonyaro and kulikuli |
saaedlee:Bruh, I no go gain anything if I lie for you, this one you dey use na online waka, abeg just help me go to any bureau de change or any person wey dey change money ask am, guy na Togo I dey do my textiles business, when my Nigerian customers sell hoods finish them go need to change the money back to Cefa, 1k=1700 as of 06/05/2016while bank own na 1k=1680 Just try ask make you know whether I dey lie, forget that online matter. |
Oga na true o, find the main main people, leave street boiz outta dis *sips dogonyaro and kulikuli |
No matter how you vex reach, your anger no go fit boil water.. I dey tell you out of personal experience... Sorry oga na 2 years I pay upon say I no kill person, you wey kill person, you go tey dia well well *sips dogonyaro and aki awusa |
Ugosample:Sorry my brother it was an error, I actually meant N1000=1700CFA, this is the rate since 29th of March... You can confirm from those Guys that changes money.. |
Kikikiki Kikikikikikikikakakakakakaka ![]() Nnyapa... *sips dogonyaro and kulikuli |
Dey dia even N1,000 = 1,000 CFA, can imagine, for now my brothers and sisters Naira still get injury if e be say common CFA Dey compete with Am *sips dogonyaro and aki awusa |
Oporo sef big pass am by far, something wey you kuku use do pepper-soup, na im you dey come show us.. *sips dogonyaro and aki awusa |
Weldone our oga your try to dey rep us well BTW Me sef get nurserate dagrin from obodobuigwe town University inside agbadanwaokukonneyaefe state... Oga Lala na lie I dey lie Kikikiki Kikikikikikikikakakakakakaka ![]() *sips dogonyaro and aki awusa |
Una thank you o... Ah don hear thank God ah no be man, I be adaobi boy/geh Wait o, what of guys wey dey addicted to cheese balls, dogonyaro, Capri Sonne and aki awusa Kikikiki Kikikikikikikikakakakakakaka ![]() *sips dogonyaro and kulikuli |
OP talk true you read this seasonal book reach end? *sips dogonyaro and kulikuli |
Una how market na I enter front page sha To God be the glory *sips dogonyaro and aki awusa |
I go draw am anyday wey Nigeria begin dey offer Masquerade science as official course for any Naija Uni... Draw ko, painting ni *sips dogonyaro and aki awusa |
odimbannamdi:Bruh the condition here is rather too alarming, call tariff here is 100/150cfa per min, now imagine you plan on making an extensive call, Benin and Ghana are very very affordable but this Togo is just killing, the government here does not need any other operator apart from this Togocel, Moov (Etisalat) is here but they're almost not existing cos the government has really dealt a heavy blow to them by imposing heavy policy and conditions on them, it's just as if they're not in existence at all every now and then they get disconnected for no just cause.. I miss home that's the point blank truth |
ogorwyne:My sister make God bless you, infact make any Kasala wey go near you go tear "Nigeria Budget" ![]() We haff Eared, Nosed, Mouthed and even Teethed him own Mtchewwweee suppose reach Accra Him wan show up say him write English for WAEC |
MTN or AIRTELpeople abeg make God touch una make una reach Togo here, this togocel network na kill no be die, 1GB for 5000cfa, 300 MB for 1500cfa and mind you 1k naira =1700cfa, una no need to dey naija dey drag customers once una reach here customers go pursue una, abeg make una help out, the 1GB sef na only 4 days e dey last for me without downloading o, Imagine say u dey burn 10K cefa only for date, I never talk of calls and light bill o, plus the way exchange dey affect business here na die person fit die here o Abeg make una come rescue us |
omogin:Sis abeg 67 gbosaz for you Na sense them dey take kill Mosquito for Brocus I like you, wetin I dey talk sef infact I love you scarra |
mira4u:I get just 1 more reply for composite slowpoke of your resemblance before you go finally off.. That's a big salute and a highly high respect for your stupidity.. If you aren't content with this last reply kindly make use of the Lagoon or preferably any nearby drainage
|
mira4u:You get sense na im your life dey one bar so? I know say you go soon off I no get desktop charger to power you up #Ewu_Gambia |
mira4u:Sister abeg, I carry God name dey beg you, I carry my mama name dey beg you too, stay for your Lane o Abeg, as I jeje post my comment I no call, quote, mention or even refer to you, infact I no even know you sef... Abeg o, snake wey only one person see no dey hard e go become python.. I don tell you |
Shuo!! Shey baba no sabi read ni? No be person dey point for am wia him go sign? Abu dis my eye problem Don start again? Make I find my glasses look the pictures em again If no be my eye problem den know say baba suppose get private evening tutor Na joke I dey joke o, before him men em go begin find me, even if dem find me from today reach next year I no kuku dey Naija na Ndi ara *sips dogonyaro and kulikuli |
