Came's Posts
Nairaland Forum › Came's Profile › Came's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 28 29 30 31 32 33 34 35 36 (of 81 pages)
" Am sorry to your lil' girl or boy" she no even know the gender of the baby, Igberaga dey mama king body oooooooo.. I happy say Mercy Johnson get good heart. |
Toto dick, no give devil chance oooooo... Forgive anything way the man do you ooooo, no man perfect ... No let people say " ehhhhh we talk am" |
Make una tell am to breath out pls, make she no kill herself where she dey do fashion.... |
Na now I no say this woman no well true true ....That guy should be jailed for all I care. |
The cheeks family..... Beautiful cheeks. |
Fertile man. |
God bless Ambode....I can't believe this guy did this, what message does he want to send out with what he did. Hmmmmmmmm!!!!!na wa for some women ooooo!!! |
Girls sabi fall hand when money is involved ..... Well, let me say some girls, because we still have decent girls . |
I personally watch the movies he featured in just to hear him say those things you termed as vulgar..... Copying oyinbo na him go kill our youth them..... They will never be themselves but will always copy oyinbo people way no even send their culture ... Yeye dey smell. |
Women like you!!!! Yeye dey smell...: I no blame you oooo , na person way go engage Olosho I blame. |
Na the guy you go blame, abi na the olosho, way open way for car to pass... No rubbish your guy because of Olosho oooooo!!!! |
My friend , when you marry, and stay married, maybe you fit come advice people... Person way don wear shoe before na him go no how shoe dey be for leg. |
Ehhhhhh, so David get Gonor now.... Make olosho dem careful oooooo |
If na yeye person she get belle for, she for no even if the belle na two days old .... Story for the gods !!!!. |
Mr Ole, no mind dem oooooo,,life must go on, socialize well well, you hear. I advice make you make a movie of that phone way you thief, make you take make money ...... |
Madam Kemi talk am ooooo, people say she dey craze.... Ok naaaaahhhhh!!!! |
You for dey carry your breast outside anywhere way you go because say you no Shame to feed your child... Na only you go first breast feed baby?....you are not embarrassed, but rather you are embarrassing people .. Yeye dey smell. |
She dey go school, you dey cry, I wonder wetin you go cry when one man finally carry am as him wife. Thank God say you get money put am for school, because plenty girls her age no see money to go school. |
Na she give that fine boy mountain forehead ... See her eyes ..she no wan engage,she dey wait for wizman. Na you sabi ooooo... |
No one knows tomorrow.... LIFE!!!!!! |
Madam make God bless you with better husband, and children na him be the koko,,, all these show off them no dey tire you?na wa ooooooo... |
Halima be twins .... Hmmmmmm... |
Love at first sight, abi money at first sight? Una doooohhh!! |
Because you slept with loose ones doesn't make single mum loose. |
See as the weight of their yansh break the ground.... Na wa ooooo!!! |
" king David security officer" na wa oooooo...... King,you try sew uniform for am. |
This woman get belle true true,abi she no wear her girdles? the way ladies dey develop big belle these days no let person no pikin belle, and beer belle ooooo.... Hmmmmm.. |
This cheating thing dey men body, if not why this man go cheat on this beautiful wife way him get.... He dey their blood... Hmmmm.... Madam, actress, you try oooo, the wife don hail you .. Yeye dey smell. |
The way these actress dem dey take snatch people husband ehhhh, person go start to wonder weather bachelors don finish for this world... Na wa ooooo.... |
This man wicked oooo, he no want make this woman go husssle , and he no say na hussler the woman be before he marry am dey chop her money.... Hmmmmm...madam, carry go, you are now free!!!! |
This one still dey sing, abi he wan use Buhari blow? |
This one na for Ajekpako pikins ooooo, Ajebutter dem dey chop this things everyday... Their parents go dey feel say the pikins go well fast fast as dem see food way dem no dey always chop. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 28 29 30 31 32 33 34 35 36 (of 81 pages)