₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,331,223 members, 8,449,228 topics. Date: Tuesday, 21 July 2026 at 01:17 PM

Toggle theme

Came's Posts

Nairaland ForumCame's ProfileCame's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 29 30 31 32 33 34 35 36 37 (of 81 pages)

CelebritiesRe: Whatever You Think About Me I Don't Care About It- Lilian Afegbai by Came: 3:05pm On Jan 04, 2017
Who wan talk about fine girl with Agberooooo voice... Do anything you want oooo,na you sabi.. No be only big brother way we no no wetin he dey teach people dey your name, wetin again people no you for....
CelebritiesRe: Phyno, Entertains Timaya By Cooking An African Meal For Him Pics,vid) by Came: 3:01pm On Jan 04, 2017
Way the food nah!!!!
CelebritiesRe: Some Entertainers Will Die In 2017- SOUL E by Came: 2:58pm On Jan 04, 2017
Your own life dey for your Hands abi,,, you no weather you join for the list...I hope say na god show you that yeye, and not God.... Yeye dey smell...
CelebritiesRe: Getting Married Was My Best Part Of 2016-funke Akindele Bello by Came: 6:25pm On Dec 30, 2016
Na marriage be the koko for her true true ooooo,,because desperation really enter her matter.... JJC, you do well oooooo...congratulations madam.
CelebritiesRe: Mercy Aigbe Lamented On Instagram About The Mega Chicken Chinese Food She Ate by Came: 6:06pm On Dec 30, 2016
Madam no spoil market for them ooooo,,dem no force you go there... Una go dey form wetin person no no , why you no cook for your house .
CrimeRe: 72-year-old Man Caught With Human Skull In Osun Says “na Mistake" by Came: 5:59pm On Dec 30, 2016
I happy say na exhume he exhume the skull, no be person he kill carry fresh skull dey waka.... If dead body can be used to help the living in a positive way,I support am oooooo....
RomanceRe: Actress Anita Joseph Says She’s Tired Of Buying Expensive Asoebi, Here’s Why by Came: 12:22pm On Dec 30, 2016
Dem forbid you to marry too... Carry your own Aso Ebi to them make them buy too.... No be only to come show us yansh ooooo, show us your husband too....
CelebritiesRe: Jim Iyke Pens Heartfelt Letter To Uche Jombo by Came: 8:08pm On Dec 29, 2016
I sure say uche head go dey big now for where she dey.
CelebritiesRe: RMD And Jumobi Celebrate 16th Wedding Anniversary by Came: 7:48pm On Dec 29, 2016
The man don talk finish ooooo, he say the woman really tolerant all him rubbish.... Women way dey rush leave their husband, make dem no say no perfect husband anywhere oooooo.... If this woman open mouth tell una wetin she endure, una go fear ooooo..... Congratulations to una .
CelebritiesRe: Kelechi Nwogu Hosts Davido & Banky W At His House In Port Harcourt (pics) by Came: 3:25pm On Dec 29, 2016
Am holding you like my boy. Hahahahah...
CelebritiesRe: Hospital To Throw Out Prince James Uche In New Year - Son Cries Out by Came: 3:01pm On Dec 29, 2016
This world na wa ooooooo....he be like say dem give people warning say make dem no help this man... This man don sick tey oooooo...Hmmmmmm!!!! I recommend prophet TB Joshua to them oooooo... God still works wonders.
CelebritiesRe: Hilda Dokubo, Helen Paul,lorence Ita-giwa Other Stars At The Calabar Carnival by Came: 2:44pm On Dec 29, 2016
No be this madam way dem say stretch mark full for her breast, open breast so? Na wa oooooo......dress way others wear, cover their breast she open her own to showcase the stretchmark... Abi na lie people lie for the stretch mark .
CelebritiesRe: Wizkid, 2Face And Other Stars Show Support For TV Host With Kidney Failure by Came: 2:32pm On Dec 29, 2016
Kidney , again!!!!! Hmmmmm!!!!! People need serious lecture for wetin dey cause this kidney wahala in order to no how to avoid am oooooo...
CelebritiesRe: Ubi Franklin Removes Wedding Ring, Flaunts Watch Gift From Ali Baba. Fans React by Came: 7:21am On Dec 29, 2016
If you watch this girl for hospital drama way she dey do, you go see say the girl stubborn die. My Guy wetin you do way she no fit forgive you serious oooooo..... Make una no compare any person with Ani oooo,because no be everybody go take rubbish way Ani take. You get money to marry girl way you don date many years, you no marry am, you go dey give people belle up, and down.
CelebritiesRe: After Telling A Girl She Means Your Life To You And She Makes This Comment by Came: 10:38pm On Dec 28, 2016
Na so dem go carry person leg come outside when dem no say dem never ready to marry, or even get plan to marry the person self... I no blame the babe ooooo...
CelebritiesRe: 2face And His Family Visit The Lagos Zoo Park (Pics, Video) by Came: 10:32pm On Dec 28, 2016
Dem no give that boy Xmas food chop abi wetin. The boy lean oooooo...
CelebritiesRe: Man Seen Taking His Bath On The Street In Broad Daylight by Came: 10:25pm On Dec 28, 2016
People way go match that water....Hmmmmmm.. Person gats dey prayerful and careful for this end time ooooo
CelebritiesRe: Jenifer Akindele, Having A Crazy Xmas Dance Competition With Family [pics Video] by Came: 1:13pm On Dec 28, 2016
Why this girl go chose this kind furniture.... It doesn't look nice, the colour just dey too plenty for eyes. No be everything way cost good for eyes.
CelebritiesRe: [Video ]Tonto Dikeh’s Breasts On Display As She Falls On Stage At Iyanya’s Conc by Came: 7:36pm On Dec 27, 2016
Na when she dey do anything to make sure say she hammer, before she come jam hammer way come make am stop to dey hussle.
CelebritiesRe: The Woman Who Rocks Olusegun Obasanjo’s World by Came: 7:12pm On Dec 27, 2016
The person tell am say she need the news paper to fan herself incase dem take light,,,,, na dem no gree fix light problem when dem dey there, so make them provide paper for fan ooooooo..... No be praise she go praise am b4.
CelebritiesRe: Murphy Afolabi Abandons His 7-Year-Old Daughter [PICS] by Came: 7:05pm On Dec 27, 2016
He get mouth dey talk say him sleep with the girl. He just took advantage of that girl that day. So as he finish him own turn, he turn supervisor dey watch others sleep with am too..... Yeye dey smell....na desperation cause this thing for this yeye girl too.
FamilyCould This Be True? I Need Help Pls! by Came(op): 5:16am On Dec 27, 2016
I was told by a prophet to stay off my mother-in-law, that she is a witch in sheep's clothing because she is a mother in Catholic Church.. How do i avoid her since i will have to stay in my husband's house where she stays as well when we travel for the festive season... I thought it was a joke, but i heard the same thing from 3 different places.... A man preaching on the street told me the same thing very early morning on my way to work too.... Am yet to believe them because this woman doesn't treat me bad. I was told she is the cause of all other people's misfortune in the family, because she vow that no other person in that family will be grater than her son, and whoever wants to be too close to her son more than her will be doomed as well.... My children are eager to meet their grandma this festive period, but this warning of staying off her baffles me... Could mama be a witch really? How do i avoid her and avoid trouble or give myself out.... I need help pls. Has anyone experience such or been told that a family member is a witch before?? Hmmmmmmm....
FamilyRe: Help!!! My Daughter Doesn't Eat by Came: 4:46am On Dec 27, 2016
My people na so my daughter do oooo , way worry wan kill me, now my money don wan finish for where I dey buy plenty food way she dey demand from me now... na every minute she dey tell me say "mummy am hungry" hahahahahaah.... Na so small children life be sometimes oooooo.....
FamilyRe: My Husband Molest, Beats Me On Christmas Day (photos) by Came: 4:32am On Dec 27, 2016
People no suppose beat people for Xmas day,,, he be like say na Xmas day way the man beat am,make her eyes open,because as i see am he don tey way she dey receive beating from the man dey endure am.
CelebritiesRe: 80yrs Witch Gets Trapped To An Electric Pole While Flying Back From Her Mission by Came: 4:15am On Dec 27, 2016
80 years way go relax, dey serve baba God wellar make she for make heaven, still dey fly fly Up and down.... She no no say old age go make am
No fly well like when she young ..... Yeye people dem.
CelebritiesRe: Actress Mercy Aigbe Shares Cute Picture Of Her & His Son Hanging Out by Came: 4:10am On Dec 27, 2016
Madam, this boy never reach to senior another pikin, abi shakara no go gree you get belle. Fine boy!
TV/MoviesRe: New Masquerade Cast of 1983: Can You Name Them? (PICS) by Came: 4:02am On Dec 27, 2016
Na to thank God for the gift of life because some of them don die.very interesting to watch then...
CelebritiesRe: 2face Idibia Giving Smoking Lessons This Christmas [PICS] by Came: 3:55am On Dec 27, 2016
The question be say wetin smoking dey give for body?he go better make person no all the vitamins way dey inside smoking before person start oooooo...... He go soon come show una how not to wear condom make una pikin for plenty ....yeye dey smell.
FamilyRe: Lady Donates Her Kidney To Her Mother As A Christmas Gift To Her (pics) by Came: 9:32pm On Dec 26, 2016
And dem dey drink again, abi no be drink i dey see for their front so.... You do well ooooo.. Better pikin.
RomanceRe: Inside The Factory Where Sex Dolls Are Made (Photos) by Came: 4:06pm On Dec 26, 2016
He better make dem marry this one than to dey rape people,,, some even dey rape small small children self ... ...na people way sex don take over their life go dey interested for this one, and those way say women no be am again....yeye dey smell.
CelebritiesRe: Photo: Checkout How Pastor Chris Okotie Shows Off His Rolls Royce by Came: 1:41pm On Dec 26, 2016
This man no get wife,no get children,he don get two divorce record,and he no send as i dey see am..... Na wa oooooo... I wonder the kind advice way he dey give him members for church.
CelebritiesRe: Wizkid & Davido Hug And Celebrate Christmas Together -( Pics,videos) by Came: 1:24pm On Dec 26, 2016
Wizkid be like bonga fish. This boy just wan take drug kill himself.

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 29 30 31 32 33 34 35 36 37 (of 81 pages)