Came's Posts
Nairaland Forum › Came's Profile › Came's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 50 51 52 53 54 55 56 57 58 (of 81 pages)
Na kiss of life she wan give am, way she dey force to kiss am. Women embarrassing themselves tey tey!!! |
Make your wife do born another pikin oooo, no be this shakara way she dey always do. Happy birthday to you . |
Money get power oooooo!!!! Omotola put Dangote voice for microphone!!!!!! Na money cause all these one. |
Na this kind thing dey cause plenty divorce for society now, people go rush, go Marry to please people.some even dey suffer , say na for better for worse. People way don marry looking down on the unmarried. Hypocrites everywhere . |
Why dem go leave men way dey cheat, no be follow follow dem dey follow people husband because of money . |
Stella fall hand for that thing way she do. Of all men in the world, na her colleague husband love carry her go jam. Stella, you no try at all. I wonder if shame go ever let you live for Nigeria. You just dey cover your face for another people country... For how long Stella ?? |
People get dirty mind. The man fit no even notice him hand self . |
she been talk say her mama say make she do ashawo one time, maybe she wan try am now. Na copy copy oyinbo people dey worry our yeyebrities. |
He be like say she don go tell them and them no gree pay am big money, na why she come do this kind thing to spoil their market . |
Nothing way person no go hear finish. Una sure say this womn no dey under a spell? |
I say make I come see who Chioma okoye be. This one na to make your movie more popular, abi wetin? Na you sabi. |
This woman no dey even think marriage at all. All the best lekpa. |
Does it mean that this pastor no go face wetin him don do? Na murder case be this ooooo!!!! |
How man way no dey mind him business, go fit manage marriage. Always wanting to be seen. |
Mr Burundi changer, why you dey pose with another person wife? Why you no dey like pose with your wife? |
Wetin you go do with the memories way dey your head, and your heart? If indeed you loved the person,letting go is not that easy. Hummmmmm!!!! |
Am very impressed with all the advice given to you. Just use your head, and don't let a man make a fool of you,or use you all in the name of marriage. My sister,how long can you endure ill attitude because of what your families, and friends would say. |
This woman go sabi nack akpako. Carry go , sexy woman. |
The man take cunny tell other men say, make dem clear. I hope say him no spoil the girl market ooooo!!!! Hummmmmm!!!!! |
This foluke no get neck again ooooo,,, she collect person husband, come dey happy dey fat dey go more more. Hummmm!!!! |
Caroline no happy for this pic at all, she dey regret why she marry her grandfather because of money. |
For the 3rd pic them surprise for their sister, the boy say "sister, you never take pic before, this your laugh na wa ooooo" Ahahhahaha.. |
This democracy regime don really give people chance to express themselves ooooo, who born monkey to talk rubbish during military regime. Na one thing go make person popular, and this mama don choose to dey insult people to popular. |
The long skirt get buttons ooooo, she make sure say she open am, make people for see her body. To dress properly no dey reign again oooo, na to open body be swag. God go forgive una behavior. |
Anorexia fit dey worry am. How Person go lean like this? Hummmmmm!!!!! |
Way the belle way dem say she get? Hummmmmm!!!! |
Those dependent on fast food should know that it is human being like them that cook the food they go to buy. I support say make woman sabi cook oooo, infact make man also sabi. |
Don't start what you can't finish ooooo, if you start am , make sure say you go dey continue or else you go black pass monkey . |
Africans no dey like respect themselves , If na America dem say make you remove your cap make dem check, you go do shakara? For where !!!!! |
Wetin we go remember this boy for if not for his arrogance, and insolence behavior. No rightful thinking Yoruba will insult an Oba. Oba, I beg, forgive am oooooo |
Wetin him carry for head way him no wan remove cap? When will these yeyebrities start behaving like a role model. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 50 51 52 53 54 55 56 57 58 (of 81 pages)
??