Came's Posts
Nairaland Forum › Came's Profile › Came's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 47 48 49 50 51 52 53 54 55 (of 81 pages)
Na money inspire me. Na money dey cause show off . |
This guy just let himself go, fat just dey carry am go. |
This guy death surprise me oooooo.... R.I.P. Hummmmmm!!!!! |
Maybe him wife no call am "my Oga" that is why dem divorce. Some married people go follow am now, scatter their marriage. My brother if woman no happy for your house, nothing go work ooooooo!!!! "LONELY" and "ALONE". My people any difference dey this two words. This pastor ehhhhh, marry another woman, make we hear word oooooo!!! |
I jealouse you ooo my sister, some women never even see one man propose to dem, you don marry one way fuvk up, come marry even correct one again. God bless you . |
She knows where to go and get him fixed, she come dey rant for social network. This celebrities ehhh, I no dey jealous them ooo, they live their lives as to what people would say,they are not always themselves. This one come here, come dey shout because she no say the guy na celebrity, if na ordinary person, she go come here come shout. |
"Don't let anyone fool you with love , you need money to pay your dues" Gbammmm !!!!!! All correct !!!! |
I need help on how to forget totally a man am dating now,so as to move on with my life. I have tried severally to quit the affair, but I don't feel comfortable without him, it seems my heart loves him already. I deleted his number, stopped chatting with him on whatApp,stopped calling or picking his call to help me end the affair, but he remained in my head, his number is imbedded in my head, and i feel the urge to give him a call. I know the relationship won't lead to marriage, because the man is a married man with three children. I don't wish to marry someone with kid or children, so I don't see myself saying "yes" to his proposal even if he does propose. I want to let go but my soul is clinging to him. He is worried about my new attitude towards him, but am more worried , because I want to end the affair, and look for a single guy to date. I need help on how to stop this affair, and move on with my life. |
How person go say him no get crush for Onyeka way dey hot like shawamahhh during the time way she dey reign, even now self , mama head still dey there . Hahahahaha... |
Na the woman toto,and life I dey pity, because she is the one going through the stress of the baby making process. If she dies, the man go continue with another woman. |
This world na mystery ooooo. Some go grow old dey beg death to kill them, why some dey die young. Hummmmmm. |
Even if their so called boyfriend propose to them, dem go say dem be lady, say the guy no reach their standard. Na standard and wetin people go say dey put dem for wahala. |
See where her money dey go for her back . Hummmmmm!!!! |
Dem never hear say person break her heart, because the person no gree marry am again? Abi genny, no be true ? |
He resemble lucky dube . Hahahahah... |
Funke 40 years, Eniola 39.. Two old mamas way dey fight like small pikin. Na dem sabi. |
So she leave D'banji for this burger way go start to sweat profusely if Air condition no dey. All for the money , I guess. |
I wan dance to Beyoncy song oooo, I hope say she go visit me. |
Make una no stop to dey show una self oooo, armed robbers, and kidnappers need the advert way una dey create. |
Na too much show off dey put una for wahala. Una chop belleful, dey show unaself, una no no say people dey hungry. |
This is why people no dey talk truth again... See as truth wan put this girl for wahala now . This love ehhhh, he get as he be oooooo, you say you love person, time to stay with am , you wan dey dodge. Na wa ooooo!!!! |
All for money, na wa ooooo!!!! |
She no born any pikin or pikins for the man? Why dem pursue am go strong oooooo!!!!Hummmmm!! |
Pray make the man follow you stay, because nobody fit force horse drink water. I wish you well. |
Why do men cheat to their wives awareness ? because they don't love, and care about their wives!!!! What you love, and care about, you take care not to hurt. |
Your husband dey cook, dey wash , you dey take selfie... Na your own better ooooo !!!! Enjoy!!!! |
I go like know her bra size , abi na customize bra she dey wear ? |
I hope say this bling bling no be 1,500 naira oooooo. |
Pastor say make you go bring person way give you belle, you go bring wrong person. It all means that 2face no send you, na you dey send am for the relationship. Ladies, make una tell una self the truth about the state of una relationship with a man, and check weather na to waka or stay. Some ladies are dying in silence say dem dey relationship with one man, when dem no say na yawa the whole thing be. |
Who tell you say whatever situation , generator go still dey work? No be money you go take fuel am? If i hear am for your mount again. Una way go help tell them to better the county, dey collect money to advertise yeye generator way no let dem look into our light matter. |
Mark resemble Buhari ooooo, make una look am,forget skin colour. Dem resemble oooo.. Hhahahaha.... |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 47 48 49 50 51 52 53 54 55 (of 81 pages)