₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,331,291 members, 8,449,588 topics. Date: Wednesday, 22 July 2026 at 04:51 AM

Toggle theme

Came's Posts

Nairaland ForumCame's ProfileCame's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 49 50 51 52 53 54 55 56 57 (of 81 pages)

CelebritiesRe: Music Star Tekno Gives Advice To Guys In Relationship [WATCH] by Came: 12:43pm On Aug 28, 2016
How dem go sweet, when dem no say women don make themselves too cheap to get these days. Na people way responsible go hear your advice oooo.
RomanceRe: Relationship by Came: 8:30pm On Aug 27, 2016
Desperation no go let people take better advice .
CelebritiesRe: "The Mention Of Ur Name Is My Worship" - Mercy Johnson To Hubby On 5th Wedding by Came: 4:26pm On Aug 27, 2016
In Adekunkle Gold voice " Emi na fe love oooooo"!!!!!!
CelebritiesRe: I Was Sacked But Not Because Of Basketmouth - OAP Freeze Reacts by Came: 4:06pm On Aug 27, 2016
Him own too much , na him go confirm people way marry, know why couple dey fight, carry people wife picture put without their consent, marry,he no gree marry,he pursue him wife talk say she dey beat am.Na wetin dem send am for cool Fm be dat?. Go join bloggers, your own too much.
CelebritiesRe: Kim Kardashian Sexy New Photos by Came: 3:36am On Aug 27, 2016
This her breast ehhhh, she breast feed at all so?i no sure say she breast feed her children .Some young girls breast way never born one self don fall throwaway for ground, I wonder how this one still stand after two children .
CelebritiesRe: Kim Kardashian Sexy New Photos by Came: 3:34am On Aug 27, 2016
This her breast ehhhh, she breast feed at all so?i no sure say she breast feed her children .
CelebritiesRe: Okey Bakassi Comedian Thinks Being A Celebrity Is A Curse by Came: 3:26am On Aug 27, 2016
The money way una dey get na curse too. Una problem be say, most of una too dey materialistic, una show off too much. If eyes no see, mouth no go talk.
CelebritiesRe: "I Have 20 Houses, 8 Range Rovers, 5 Infinity Suvs"-bishop Obinim by Came: 6:51pm On Aug 26, 2016
People way say Education matter get plenty sense oooo, this pastor no go school , illiteracy follow for wetin dey worry am.
CelebritiesRe: “I Am Scared Of Marriage, We See Divorce Everyday”- Actress Ebube Nwagbo by Came: 6:45pm On Aug 26, 2016
You no dey scared of menopause? People way never see person propose to them just dey carry people divorce matter dey do yeye excuse. Everybody get him own destiny and life ooooo!!!
CelebritiesRe: Freakness- Actress Tonto Dickeh Tattoos by Came: 6:54am On Aug 25, 2016
She just carry rubbish take spoil her body. Not nice at all. I guess mama king is wiser now.
CelebritiesRe: Yetunde Babajide Odetola, Pasuma's Wife Unveiled by Came: 10:34pm On Aug 24, 2016
Make una see the fingers of pasuma wife . Hummmmmm!!!! You try for marry am.
CelebritiesRe: "Stop Showing Off, We Know You Have 6-pack": Fan Blasts Agbani Darego by Came: 10:28pm On Aug 24, 2016
Bianca belle way don born plenty children even flat pass this one. Wetin she dey show? wetin she don carry the belle do.The belle wan big before .
CelebritiesRe: Funke Akindele Posts New Video Amidst Wedding Rumors. (pics, Video) by Came: 10:24pm On Aug 24, 2016
Madam,God go bless you with children, make shame catch that prophet way say you fit no born. Thank God say this one no be Agberooo.
CelebritiesRe: Solid Star Celebrates His Son, Josh's 1st Birthday Today [photos] by Came: 10:19pm On Aug 24, 2016
Show us him mama make we see weather na she him resemble,because this baby no resemble you at all.
CelebritiesRe: He Has D Body Of A Champion, But His P*nis Don't Match - Bolt Rio Student Lover. by Came: 10:02pm On Aug 24, 2016
This yeye way you dey talk no concern women way want money ooooo. Na money be the koko.
SportsRe: Before And After Photos Of Rashidi Yekini’s Mother’s House... by Came: 9:53pm On Aug 24, 2016
Na only Rashidi be her only pikin? Wetin other of her children dey do way dem leave their mama like this? This world ehhhh!!! God bless your kind gesture sir.
CelebritiesRe: END TIME PHOTOS!!! Whose Side Chick Is This And What Is She Wearing? by Came: 12:01am On Aug 24, 2016
She go do implant, come dey flaunt am.madam, nothing last forever you hear, show yourself, na your body!!!!
CelebritiesRe: Funke Akindele's 'engagement Ring' Has Gone From 1 To 2 by Came: 9:48pm On Aug 23, 2016
If you carry yourself come outside, you go be news. Na news oooooo!!!!
CelebritiesRe: My Biggest Failure Was Exposing My Private Life Too Much” – Tiwa Savage In Elle by Came: 8:02am On Aug 22, 2016
See you , you get luck say you talk ooooo, if not the plan of that man way you marry na to spoil your career.
CelebritiesRe: Actress, Taiwo Aromokun And Her Twins Rock Matching Agbada With Style - Photos by Came: 5:50pm On Aug 21, 2016
Why person responsible husband too no stay with him wife? Madam, do anything you want with your twins oooo, na you push dem out.
CelebritiesRe: How Actress Anita Joseph Turned Into A Beggar At The Airport by Came: 5:44pm On Aug 21, 2016
Madam, how you manage go put yourself for situation way wound take dey your arm,tell me that one ooooo, I go like know.
CelebritiesRe: Photos From Captain E's 18th Birthday Party (Omotla's Son) by Came: 5:36pm On Aug 21, 2016
Dem invite werey too, sorry, I mean Denrele. Haaaahhhahaa
CrimeRe: Man Butchers Two Sisters In Jos Over Pregnancy (photos) by Came: 4:35pm On Aug 20, 2016
Women no dey open their eyes to know person way serious at all. One Person say him go Marry you, you leave the person go dey ask another person way never ready for marriage weather him go marry you. Na confusion cause this one for you now.
CelebritiesRe: Husband C@tches His Pregnant Wife $leeping With Another Man In A H0tel Room by Came: 3:49pm On Aug 20, 2016
Person carry her body go meet the real person way give am belle, una say she cheat.The man way Marry her sure say na him get the belle?
CelebritiesRe: My Relationship Ended With Genevieve Because I Was A Virgin by Came: 3:39pm On Aug 20, 2016
because na Genevieve , if na one Yeye person you go talk? Why mention her name in the first place? He be like say that virgin attitude still dey worry you. Try grow up bro!!!!!
CelebritiesRe: My Family Is Most Important Than My Career –mercy Johnson by Came: 3:19pm On Aug 20, 2016
You sure? No be career you run follow immediately way you born your first child, you no even relax small face family way you say dey you important.
CelebritiesRe: Makeup-free Uche Jombo Shares Selfie Ofher Son Watching TV With Funny Caption by Came: 11:25am On Aug 20, 2016
This pikin way dem born yesterday, don start to dey waka. God is great. God bless your family uche.
CelebritiesRe: Religious Parents Beat Son To Death In Church For Not Confessing His Sins by Came: 10:49pm On Aug 19, 2016
Una sure say na the teenage mama be dat. Which kind mama go follow her husband beat her pikin to death..... No be African mama, I guess!!!!!! African mamas go be like "no kill my pikin for me ooooo"
CelebritiesRe: Stella Damasus: "I Am Using My Haters To Make Some Quick Money” by Came: 5:50pm On Aug 19, 2016
As you dey use your haters make money, na so you use style snatch the man too, come dey use the man do only wetin you , and God sabi. Stella, stop responding to your so called haters, you no get shame!!!! Na that place way you dey fit you,because shame no go ever let you live for Nija. See her mouth " I dey use my haters make money"
CelebritiesRe: Anita Joseph's Skin Damaged By Tattoo [PICS] by Came: 11:32am On Aug 19, 2016
Why she go do tattoo in the first place? If you tell them, dem no go hear, dem go say dem be yeyebrities. Na so one yeyebrity carry map for her back, she say she be Mama king now. Mama king, when king grow ask you of that tattoo way dey your back, tell am reasonable thing ooooo !
CelebritiesRe: Top Comedian AY Got Surprise Party As He Clocks 45. See Photo by Came: 8:53am On Aug 19, 2016
How many Mouth una get? He be 45 or 38, which one ? Happy birthday Ay, age na number!!!!!

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 49 50 51 52 53 54 55 56 57 (of 81 pages)