Gigabyte13's Posts
Nairaland Forum › Gigabyte13's Profile › Gigabyte13's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 115 116 117 118 119 120 121 122 123 (of 194 pages)
🤣😂😅😂😅😅😅😂😂 🤣😅😂😅😂😅😅😅🤣 Ghanaian government be like Wertin be dis Who invite this gbajue here Osiso, event cancelled Everybody go back to where you are coming from What nonsense.....!!!!!!!!!!!!! |
Tee billz sef dey talk about family... Wonders no go end.... Wertin concern me with two community projects men.... ?Bed of a feathers....... |
Una no want war, but Dem dey launch missiles from Lebanon into isreal...... ![]() ?Isreal is not joking, infact na lran gangan be Dem target, Lebanon na paper weight for this fight. The whole Lebanon go turn refugee camp, if lsreal face Dem. Iran vs lsreal is the real deal |
Atiku still wan colonise Obi and him Gbajue movement...... Without OBI, Atiku is going no where but This time, na Atiku go be vice, na Obi go be the major candidate. If Atiku gree that useless arrangement, make humans bend waka. Na so ,Dem no go gree oooooooooooo Till BATMAN win again Oponu people |
Na calm people get werey pass Dem just get self control If dey release their anger on you... You fit get heart attack from such experience. I belong to that category... We no too like talk Our calmness is not cowardice |
Shey we were talking about DANGOTE on yesterday's thread...... Guy Sabi patronize government eeeeehn Normal normal in a free and competitive economy. I talk am with my full chest say For Nigeria If everything dey competitive business wise DANGOTE no go near 10th richest for Nigeria |
U Neva see anything U just dey start......... You go soon go find fried and roaster salad come giver her. My wife kukuma no say, All those nonsense no concern me She kukuma no dey try me with that Her craving is constant, if it is mango it is mango till she delivers and l load mango full house for her. Whatever it is, she get it in full Which one be goat today, cat tomorrow, rat in the night |
You are very very shameless man You dey tell public say, your wife bwess na peanut...... So you know see the PEANUT before you marry her.... After two children, your eyes come open Werey ni yin Sir Mother of your own very children What a pity.... If nobody tell you Before Make l tell you now YOU ARE A SHAME TO BEHOLD Wish she can see this |
soccerlite:Perfectly described Sense full your brain |
Anytime l see DANGOTE name for Rich man list, l just laugh........ If the market is open and made competitive in Nigeria, DANGOTE no go carry 10. He just dey enjoy government patronage and free tax. Once you thief enough money for Nigeria, especially polithiefcians, carry am run under DANGOTE in the name of investment and you are safe. Kudos to him though, for playing is card well. |
Werey dey exposed him colleague Once Dem remove their hands from government purse, Dem go come get sense suddenly....... Na those gun men go kpai all of una |
Portable go soon talk enter wertin him mouth no go fit deliver am from............ Sometimes, you think because of money, you can talk anyhow, until you talk to who overpass you. Them you go no say, wertin you dey call money na coins, where those ones dey. Dem go soon put am to him place soon. Him sef no go believe am I meant very soon. |
Small yansh sef dey shake Orisirisi How can a party who is adopting PDP candidates in subsequent elections claim to be the main opposition party..... ![]() ?Where was labourers party in kogi election... ![]() ![]() ![]() ??Gbajue movement too like to dey claim relevance |
Werey sef dey accuse person You no wed person legally Because she born for you You wan colonise her...... Make person tell this werey say Na baby mama she be no be anybody wife SHE IS MUCH MORE AVAILABLE TO THE PUBLIC FOR KNACKING |
He wan form, one man mopol Wertin him sef dey find go their office FRSC fit enter barracks like that..... ![]() ?All these new recruits for soldiers don dey behave like police officers this days. Dem just dey give soldiers bad image Soldiers are organised, respected and signified personalty but these days You just find them in unusual places, even in street parties and beer parlours on uniform drinking anyhow. What a shame |
Depends on the personality of the person you married and your attitude towards her earnings. My wife earned much more than me but l foot the bills and do all that is expected of me as the man of the house. I don't Force her to help out with her money, just that when she makes l demand and l don't have, l expressively so without asking her to take from her money. But sincerely, she helps out most time financially without me asking. Na lazy and greedy man wey no Sabi him responsibilities go dey look the wife purse to act responsibly. Some men sef go dey jealous their wife ontop her money Mtchewwwwwwwwww Create a healthy underau on finance in the family |
Like he cares E no send una Papa Gbajue movement |
Game on I already knew, the guy didn't resigned just like that..... Funbara Sabi game That's how to reward loyalty Even if Funbara is not loyal either. Game never end We still dey watch match Yoruba people go say ELEMI LOMA LAST |
I no kukuma blame Olamide Since the king sef, dey follow Dem hang out for clubssssss coded at VIP section Na wertin give am liver to stretch hand for shake be that. You no see as Wizkid dey squeeze am for him mama burial. King Oniru... Rest Sir These boys Sabi you Wella Wella Sir |
Omoluabi doings.... The highest of honour in the Yoruba land And doing so publicly..... No be omo afipa and sliding tackle wake their parents. Person wey pass you Don pass you jareeee Burns boy sing say "Moni ko gba ooooooo Wan fe gba ooooooo Moni koma worry ooooo Babaya won ma gba ooooooo |
Just for someone happiness you decided to be unhappy and with marriage at that.... You did something too costly. Your Mum is alive but you that is supposed to give her Joy is unhappy and she is happy... ?Seriously, the deed is done sha Na pity l just pity you You go soon do that thing wey you dey fear to do. Trust me you go soon do am Because you deserve happiness too. That she sold this and that to sponsor you to school, is her duty and responsibility, na she born you, you no owe her anything. If she no do am Wertin go be, go be No be to dey use that one BLACKMAIL YOUUUUUUU You sef go do for your own children. |
E na never marry Una don dey do isreal and Palestine fight If una marry finish Na Ukraine and Russia lifestyle go be The signs are there...... Brother let her go You dey keep community project for house I no say, you sef get your own for body but For your safety and longevity... Let this lady go. Marriage no be child's play oooooooooooo Na serious work Dem dey do for marriage |
No be Anambra l read so... You mean Anambra the Mecca of Nigeria The most safest place in the entire country. Make una dey play Una just dey start. Make una sha keep una madness to una coven. |
berrystunn:Baba l get interest for this your update ooooo Can you shed more light please |
Shey no be the same Chris Uba of Capital oil be this.... ![]() ![]() ![]() The one that owns a football club.... ![]() ![]() ![]() Baba supposed let us know, who e buy market from, wey he never settle. I think this is the second time, he is being attacked. One day bush meat go sha catch hunter |
Person wey Dem wan impeach like two months ago, don finally be Governor God no be anybody Papa mate......... |
Wertin l no be say Romance no be for poor man One woman talk say Person wey no get money, no suppose to dey get erection 😂😂😅🤣😅🤣🤣😅😂 Poor man eyaaaaaf sufaaaaaaa My pastor talk one day say If love follow door enter house, come meet POVERTY tander for seat, the love go follow window japaaaaaaaaaaa. Have a purpose to be financially stable Na Romance supposed come last |
Seriously, you are a weak man For you to have said this about , a woman that you got pregnant and with a son for you. How much have you spent to improve on her looks, clothing, l mean improving her look generally. No be to dey complain Your own sef full your body Wey she never tell you. The day she go open her mouth talk You go find space to faint You no go seeeeeeeeeee. |
MY YEAR OF BEING ALIVE, KICKING, EATING AND SLEEPING..... ABEG MAKE NOBODY COME PRESSURE ME. |
😅😂🤣🤣🤣😂🤣🤣 😅😅😂🤣😂😂😂😂 See who dey give NIGERIANS hope Person wey no get hope dey preach hope After Dem push Dem comot for power Dem go come turn preacher... Sense go come suddenly enter their brain Mtchewwwwwwwwww |
Hmmmmmmmmmm God don give am rest finally I no go gree I no go greeee You don gree now. Wertin God take pass Man no be small |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 115 116 117 118 119 120 121 122 123 (of 194 pages)
?