Glithronix's Posts
Nairaland Forum › Glithronix's Profile › Glithronix's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 60 61 62 63 64 65 66 67 68 (of 87 pages)
BAZ001:My DS is blinking Red, boss. I no fit cancel for now. ![]() Much respect, baba. |
BAZ001:If roads are good, you can hit big as an e-hailing driver, cos there would be less traffic everywhere. Roads are getting worse day by day, traffic keeps increasing as a result of that, that's why it's kinda bit difficult to hit it big. Assuming I have been driving on any e-hailing platform before now ni, I for don retire tey tey cos I know I for don achieve things to move on. Fuel price inflation - bad roads - traffic is what we are facing today. Those of you who have been in the hustle like 5 years ago no get any excuse to give us newbie for not owning a house in at least Ikorodu. ![]() I have padis who built houses in Ikorodu from this bolt hustle (though they own their cars). The person paying milla yearly for house rent fit dey talk true, if na him get him ride. ![]() Lagos is depreciating, na wetin dey affect us today be that. Make all roads good first, make dem come see real money making on e-hailing. But which year we go reach that stage? ![]() Dropped rider at Ajose - Ibeshe, Ikorodu now. See as everywhere white like breast milk. ![]() Need to drive back to my area cos I no fit waste this last SET DESTINATION button I have left for today - too early for that and I no trust staying online in this Ikorodu. ![]() Much respect, boss.
|
Bolt don start this morning. I set location to lekki, they gave me trip to Ikorodu. ![]() |
BAZ001: ![]() Instead make you dey train me, you dey make jest of me. ![]() No be like this life suppose be oh. Kosi problem. Much respect, baba. ![]() |
Muhammadson2020:Indriver has been my saving angel since Monday. Yesterday when bolt was doing trash, I switched to indriver. Grossed 10k with less than 1k commission on it. I think I'm getting used to indriver now, it has been saving me since on Monday when bolt was not making it work. ![]() I will hustle with bolt on the island throughout today to regain my DS, then switch to mainland and migrate to Indriver ![]() Indriver is bae, bro. I'm loving it already. Loaded it with 2k already. Much respect, baba. ![]() |
I'm filling up my tank this night or early tomorrow morning and zoom to island. Na there I want do the hustle for the remainder of this week. Mainland is fccked, wallahi. ![]() Unfinished and abandoned roads causing traffic up and down and you can't even go online with peace of mind say you go get closed-by order. If Una know how many orders that those riders cancelled today. ![]() Order came in, I accepted - then next thing, riders cancelled immediately as if bolt sent all of them to me. I don lose plenty drivers scores. Na me and island get each other from tomorrow. Any order wey want carry me come mainland, na thunder I go take waya am decline. ![]() Much respect, bosses. ![]() |
SamuelTaiw0:@the bolded ![]() You can't be a bolt hustler without having hoodlum spirit. If you no get before, the street go build it inside of you. ![]() Yesterday no gel well onto traffic. Rain no fall, but traffic fall. one thing go sha do us in this Lagos. I have been switching from InDriver to Bolt since Tuesday. I go still drop gist later. Much respect, baba. |
Conoil and Total filling station beside and after China town, opposite The Apostolic Church, heading towards Alapere Estate bus stop are both selling fuel. I chose total, anyways. Plus OANDO filling station, coming from Iyana Oworo - heading to Alapere Police station, dem dey sell fuel with less queue as well. Much respect, bosses.
|
ReadaDream:Yeah, it did worth it. I took the link to Isheri road to connect with Lateef jakande, parked at the mega Chicken and luckily for me, I got a trip that took me to my area gangan on a x1.9 again. ![]() Getting to Lateef jakande no be small thing but it was far better than putting your head straight on the main Otedola bridge. Much respect, sir. |
SamuelTaiw0:Naaahhh. I ain't buying their ticket jare. I maneuver my way out to Lateef jakande, Mega Chicken. ![]() Much respect, boss. |
ReadaDream:Na x1.9 ![]()
|
Trip don carry me come Olowora - how I go take comot for here now is in the hands of God. ![]() Make I just wind up, lock myself in with AC and blaring music through Bluetooth, moti gba kamu - I don accept my fate. ![]() Much respect, bosses.
|
Felicity001:That day, I lost 5 drivers scores. ![]() Come see PU of 15/20/22mins. Omoh, riders self cancelled on me tire. ![]() That's why I get some areas/situations wey be say, I go offline and zoom to a sane area and come online back. I don recover my DS back sha. Much respect, baba. |
SamuelTaiw0:No mind am. ![]() Person wey dey among the legends wey I dey learn from here. We die here. ![]() Much respect, boss. |
ReadaDream:Well done. ![]() |
Johnnybegood12:Maybe a cumrade sent from hell to liberate the gullible. ![]()
|
microlincoln:At the bold - rules of a comrade; No rest for the wicked. ![]() Abeg, you know weda dem still dey sell there? Abeg reply ASAP. Much respect, boss. |
Johnnybegood12:Sangotedo shouldn't be attached to Lagos at all. What a rough axis. ![]() I wonder how people dey enjoy living in that area and they will still be looking for bolt drivers up and down. Some streets dey that sangotedo wey be say you go prefer an Ikorodu. You see that Ajah - Sangotedo, if trip carry me go there in the night, I dey go offline straight. Lagos is just a total mess. What a government. Much respect, boss. |
Gudvibes06:You come ignore those bosses wey you suppose ask them to cut soap for you, na me wey still dey learn as a newbie you dey ask. ![]() Much respect, baba. |
BAZ001: ![]() How I wish the car can use groundnut oil instead of petrol, na Island you for see me today and on Sunday. ![]() But fuel no dey everywhere. All filling stations locked out. Wetin guy man go come do now? ![]() |
iCloud007:That's effects of traffic and fuel scarcity. ![]() All those riders wey dey look for ride go cry today today. See as dem plenty. ![]() If to say fuel dey ni, I go rugged am and hustle today, as I dey like this, I don already dey house preparing for tomorrow Ileya. Work starts on Monday jare. Much respect, boss. |
Felicity001:From number 1 to 5 only you? ![]() My brother, you see that early momo hustle, the thing no dey with my spirit at all, and when my spirit no align with something, it's better I back off mehn. I tried it 2 days ago, it still didn't work with me jare. Make I dey follow my set time jare, but I'm adjusting on the empty driving sha. Night driving - na hoodlum like you fit do that one, not for a coward like me. ![]() Much respect, boss. |
pope191: ![]() All of us go dey alright las las. ![]() |
AgentXxx:Done, boss. |
See as money dey waste. ![]() See traffic. ![]()
|
donfortune48:That's a forbidden location at the moment. ![]() E sure me say Person go spend more than 1hr to get there alone. ![]() Inside life. |
Any expo on where dem dey sell fuel on mainland abeg? I still deh where I dropped my rider like this, staring at the traffic and pressing my phone oooh. I no wan set destination yet, waiting for who go hint me where dem dey sell fuel ohh. All filling stations I saw on my way no open gate for any car, and cars self refuse to leave the long queue. ![]() Imagine from here to Alapere = 46mins. Something wey no suppose pass 17mins. ![]()
|
This country is f*cked, Lagos especially. ![]() Government is just making life difficult for people to live. Roads - you spoil roads in the name of infrastructure and you just abandon it halfway and jump to another road, causing traffic up and down. ![]() Fuel - what is going on with fuel now? Fuel scarcity today, tomorrow, further more. ![]() This period wey person suppose dey cash out inside surge, person no fit. ![]() Traffic come full everywhere. Yesterday, my balls were ringing onto traffic level, managed to gross 29k yesterday when my target was 35k or above. ![]() Nothing go make me fail grossing 40k today if to say fuel dey, but see what we're experiencing. ![]() I just dropped a rider at Abisogun Leigh (aguda side) from Alapere Housing Estate @3.3k surge. Now, I can't continue work before the traffic become worse, make I dey go house. The fuel wey remain inside the car go reach me cruise around tomorrow as per Ileya stuff. Need to use tomorrow and Sunday to flex small - then resume on Monday. What a nonsense state and government. ![]() Please anyone with where dem dey sell fuel, abeg share ASAP. Missing today's hustle go pain me, but if I no see fuel, I no get choice than to go and park for house. Make I set destination to my area, Alapere. |
Avoid wemco, lateef Jakande, Adeniyi jone: in fact, avoid the whole of Ikeja. In fact, avoid driving today. ![]() |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 60 61 62 63 64 65 66 67 68 (of 87 pages)

ikejamanism is better than you…






