Snoopz's Posts
Nairaland Forum › Snoopz's Profile › Snoopz's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 18 19 20 21 22 23 24 25 26 (of 74 pages)
Are they doing well ? Abi na those states wey arrange the unopposed level shii? Na to just dash the ones that wan to contest small dolls |
Worst govt ever, HOA will issue directive to the ministries, they no go acknowledge, Buhari go issue order, then mele kyari will do what pleases him, disregarding chain of command... No wonder the petrol was adulterated 2/3 months ago |
Werey, make the ipobs sef off him light, na good thing Dem do Nigeria |
In a sane country, gist lover suppose dey cool off for cell by now, if nnaji doesn't want people to know, it's none of our business to even find out and put on the social media, this gistlover just doesn't know when to stop, I'm sure he/she will carry a bone she can't swallow one day |
Apc dey run ponzi scheme, Becos you can't tell me this old man get 100m to waste without expecting something in return |
Chief law officer of Nigeria dey involved in politics, the central bank of Nigeria governor too dey in politics, no wonder Nigeria dey in jagajaga |
chudeclingy:No be today peter obi don dey with the masses even when he was a governor |
ifex370:Congratulations won't remove 1 sec from your life |
Once that 66k enter bayi, and you never figure your post nysc, you go too collect wotowoto o, next time if you hear favour Market, you go shout big amen. Forget bring your CV after service, give them your CV with faith but don't rely on human beings, i can't remember the number of people i submitted my CV to before and after nysc finish, na person wey we no even expect arrange job for me |
blackboy:4 teachers to handle over 200 students ? You go wicked o |
Avoid betting friends too. Btw na Becos you no get job and you be irresponsible gambler, bet wan kpai you |
Amaju sef suppose resign, Becos how you go insert that kin clause in a contract, knowing fully well you can disengaihin anytime |
That money wey dey sweet them now, Dem go later cough am out |
When a number of over 25 candidates dey pay that sum for form, they should know only one candidate will win and trust me the candidate won't be a small boy, na person wey full ground go emerge, and we all know who full ground and who no full |
Nairaland, stop spreading fake news |
28 in university?? You be small boy o |
Instead make ministers of education sit down and navigate this storm, they're busy doing consultations up and down paying 100m for forms |
Luku you she be gf, next on the list, discard her |
In civil service, some departments no dey loud recruitments o. Na low paying jobs no too dey require connection I dey suspect say you be corper wey just finish, pray for grace otan, i cant count how many people i submitted my CV to when I finished nysc, na just the right button wey we click wey everything set |
You get luck sha, na person wey dey take you go 7th cloud wan tie knot with you |
Apostle see boobi e dey smile ![]() But dat him gbola get veins wey fit kill person o ![]() |
Na for photo he travel, all those things Dem don talk no dey enter him head |
I this old man enter presidency, we go too collect o |
You be loyal boy na, moreover, you Sabi how much you gats deposit to him? |
This is one dey joke with us ni sha |
Them using condom means the babe sef na runs girl. She wan chill with the Big boys, now Dem don run her Street |
General buhari and Lai mímú no go like this one o |
Maga go pay tire o, you see ladies in vehicles showing their video recording skills without showing the man behind the wheel, na to keep her options wide open |
She die?? I say she die?? |
Na money dey make her adorable, if Pogba wise make he no marry her, make him just dey shoot make she dey deliver just like ororo |
With cancelled in mathematics? I doubt any uni go give you admission. But check the requirements for courses in your choice uni |
The private school i started with was paying half during holidays, na last year Dec spoil everything wey i make up my mind, the proprietress no Pay untill 30th of dec i be like wetin con remain during festive period? Dem for no kuku pay na Feb like this naso Tescom call me for interview i happy die. I Sha don commot na the remaining ones i dey pray for now, but everybody no fit work for lag govt at the same time |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 18 19 20 21 22 23 24 25 26 (of 74 pages)
