Theophorus's Posts
Nairaland Forum › Theophorus's Profile › Theophorus's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 62 63 64 65 66 67 68 69 70 (of 114 pages)
End of Tenure things but OP dey find how he go drag LASG enter mud with those people wen dey always insult others. |
Kai! Others go quietly dey do their things but when he reach some people own na noise for notice me. |
Heya! Sope otilo. Abeg make una parkwell. |
If you sabi the expertise of the main crew of LP, you go remember say na to talk wetin dem no fit do or wetin their products ni fit do. |
Kai! If na like this una go dey reason for 7yrs+ na una know ooo. Better speak with your people in NASS and pull out of Nigeria. Better call all your people outside your 5states to return home. |
It's better to ensure that your mind process thought before you spill it. Wisdom is profitable to direct. Baba don rush go talk wetin him no suppose talk. |
Man wen support candidate wen lose for elections. |
Happy Birthday Datti. Try your luck in 2027 if you still think you can Labour with Mr. Peter. |
Kai! Some people dey overate themselves ooo. Headmob wen no fit win elections dey think say dem fit influence anything. Abeg, make those children parkwell joor and let's see front. |
If Govt. Staff no fit marry na those people wen dey Private schools go come marry? Abeg, make everybody cut their clothes according to their cloth. No be by Force to live for 2bedroom flat. Na human being dey live for face me face you and no be by force to chop with meat and fish, remove one and manage till salary reach 200k. |
[quote author= post=124275465]Anu you didn't see the thread your brothers open yesterday because the Igbo girl that got highest in JAMB schooling in West[/quote]Check wetin you quote again. To you everything na "COMPETITION". Ndo itiboribo. |
Congratulations beta pikin. Assuming say she from that side now, dem go don create thread on how without dem Nigeria for now dey shine. Dem go still claim say for everything na dem be the best. Aboki no dey ever make noise but na dem dey supply all the Cow Meat,Jakky-meat, Beans, Dry Maize, Sorghum etc... But people wen dey import-sell spare parts go dey shout up and dan. |
Chai! wetin other dey do without Noise, He reach una own, una begin shout. Kai! Who do these Upper-iweka people like this? Anything na competition to dem. |
You buy Fuel 550 you no know say He go quick finish? If na 50# you buy litre, you no go care but you see that 500+ ehn? Well, to clear you doubt just dey buy from only mega stations. |
Okay, when we get to the Bridge we go cross am. For now, na Money I dey find. If enough pepper don rest for my Aza, then I will think of vacation. |
Drink Hot Pap and Akara the Octopus go vanish straight. Chop Hot Amala with Ewedu with Ogufe and that Octopus thing go vamose. Carry better Apu with Ofesala and the story go change. Abeg, who go carry me go Singapore make I go teach this people how to chop Better. |
What would your candidate have done differently? Research about the Actions of your Zik before independence and how that lead to the removal of the succession clause. Research about the actions of Ironside and Ojukwu that lead to the concentration of power in the centre. You're crying about the Biscuit that was taken from your Alex in 1999 and given to OBJ Abeg why you no collect the Biscuit back? You still cry say you una never rule Nigeria since 1999, Abeg na which person fault? Una dey sell spare parts you don see anybody complain say na una dey run that racket? You still dey cry say Nnamdi dey Kuje dey swallow parboiled Beans, my brother na who say make he go dey threaten sovereignty of NG? Your candidate and him party loss election, you still dey weep, what a weakling! Abeg go and learn how not to loss an elections ooo. You come dey shout say NG go break, guy, Abeg call your Brothers wen dey other regions for NG make dem return home and tell your lawmakers/Representatives for NASS make dem push the Bill. But if you do mistake enter street to cause any gbege ehn, anything wen you see you go manage am ooo. Okwia?
|
Abeg make those people parkwell joor. If dem like make dem unify thier Atm and otc payments. Sha, those days of deposits will take time to return. What Emiefielism has caused will take time to undo |
Oya! Time to look inward and start using our herbs. Enough of the Oyinbo medicines and treatments. Producers interested in production and who don't want to go out of Business should look at sourcing inputs locally. PMS stations, marketers are already feeling the heat. No patronage again and they have liabilities and so some of dem will soon go out of business of they don't start strategising. Kai! Before the first 4yrs go end, some people go don too hear am. |
See as people from that region filled with hatred for others just dey lament, and dem dey claim say everybody for their area na Billionaire. Well, hand don dey touch dem wella. One of the things wen I like for this RenewedHope thing be say He don humble the proud and nobody dey do pass dem self again. |
Either paid promoter or whatever, I think the people like their sit at home thing cos initially they were always hailing them even in their Markets. Also if they don't like their UGM they would have revealed their identity and probably organize their own Mob to fight them. But they like their UGM and sit at home thing. The twist is they have blame Tinubu for sponsoring Ekpa and that the UGM boys are Asari sponsored and sometimes claim the attack is by Fulani's Herdmen. |
You sack people, shey dem no go chop again? Dem carry their skills go sell give another person, you come dey vex. Abeg, you better parkwell make Thunder no go blow your buccal cavity. |
If you like make you still dey hate go. Na FDI dey enter home so ooo. You better begin align and gather to dey relevant. |
If this guy from one region like that dem go don dey claim 'Victimization'. But you see ehn, nobody from this guy place gree defend am on SM. I hope the US authorities can now pick the guy up to come answer some simple questions. |
Person no get Job. Him 'guy' still wan collect the small change wen dey him hand to sell 'bobo' for am. You think say our politicians bad ehn? Just reason this guy friend Mata and you go agree say average Nigerian odikwa very wicked. |
Hungry never wire you. If Hungry wire you well-well, dem no go tell you before you go enter Kitchen cook wetin you go chop. As the Food dey fire self, you go buy Soda and Cookies take dey hold Belle first. Seriously, just decide you have to eat and eat cos you don't want the consequences of lack of energy. As in Eat your Food as Medicine so that You don't take Medicine as Food. |
Kai! Emiefielism don end. Na people wen support Emiefielism I pity. Una think say the policy get leg? The guy don dey Collect for wetin some children make am do. Well, I Sha need More money ooo. |
Hmmm! I hope we can Compete with the West by then. |
Dem just dey use some people play ping-pong. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 62 63 64 65 66 67 68 69 70 (of 114 pages)