Easystudy101's Posts
Nairaland Forum › Easystudy101's Profile › Easystudy101's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 (of 20 pages)
Mogidi:The shekau that is dead or the one that does not exist? Which one? Why don't u ask USA, France and Israel |
Emekamex:CIA and MOSSAD...., thank you for your good job. They want to kill everyone there before they begin the oil exploration. |
vimi:Lol...., now you are the one diverting. Maybe na im make de babe never fit find husband. |
Jarizod:I smell CIA |
vimi:Do you know how many people in adamawa depend on him for their daily bread? And as an elder statesman of the state he has to show concern. |
vimi:He is from adamawa |
Forumspotz:You guys showing these graphic pics sef!!! Wht exactly are you trying to achieve? |
lalasticlala:CIA and MOSSAD, how una dey? |
dre11:Three kposa for CIA and MOSSAD KPOSA...... KPOSA........ KPOSA.......! |
Bonapart:The better question is why do we nigerians keep dating this BIPOLAR Americans? |
omanifrank:I wish somebody go give am better psychia injection for that I'm puff puff yansh |
ademoladeji:CIA and MOSSAD una well don oo! |
VoteOutPDPJona:They think we don't know what's going on. |
loksman:You are obviously an agent. |
InMyOpinion:Well done CIA and MOSSAD |
abbey621:Hey, remember me?! How are you enjoying the recent attacks? |
bushdoc9919:Wise king Solomon. While you are at explaining where and how they get funding from, please tell us what boko haram is fighting for? |
bushdoc9919:Yes because those highly sophisticated weapons that those boys use are made in ur village abi? And those boys have very good businesses that can help finance their attacks on nigerians for about 3 years now, abi? |
Dnarvaez:Shut up already. Coins are still in use in all advanced countries |
itsmayiela:Good job- CIA and MOSSAD |
De oda day I meet one of my guys. Na so him squeeze him face like person wey dem kick for him prick. I ask am wetin dey do am, na im him come tell me say one girl tell am say him give her bele!! I wan laff but I just hold mysef, make ee no be like say I dey happy for wetin do my guy. I ask am why him go make dat kind mistake. Him tell say him use condom. Well why you dey worry? 'You use condom?' I ask am. 'Yes use condom', him tell me. Some of dis babes for yankee fit put anytin for ya head if you no shine ya eye well well. Anyway we get to wait for her to born de pikin. I ask my guy to rush go do DNA test. Him do am. But…, de result hit me with de big one- NA HIM PIKIN!! Hmmm…, dis one na big wahala oo!! If you give any woman bele for yankee and una no marry, make you just ready to pay her money for de next 18 years. Dem call am CHILD SUPPORT. Dis one no dey for say ‘I no get money, you fit manage dis one?’. De only management wey dey na for you to go relax for jail until you ready to pay her. Plenty plenty guys life don pafuka like dis. When she carry you go court, de judge go decide how much wey you go pay her every month. Even if you no get work, dat one no concern de judge. And if you get beta work, na im be say you go cough out plenty money. And all de babes for here know dat one. Most of dem eye tia reach dem back. Marriage no mean anytin for plenty of dem. Wetin dem want na to born for you, den come sidon for house dey wait for ya check every month. When babe begin ask you where you dey work and how much you dey make, dat one na sign for you to tia race. I don jam babe wey tell me say she go donate pikin give me, she go get bele for me.., lol. No be person tell me to run. I say eh, many guys don try plenty tins to fight dis one. Some go just stop to work kpata-kpata. Dem go tell you say de judge go arrest dem tire. Some go run go hide for far far state so dat police no go fit catch dem. And if you say wan fight make de court give you de pikin so dat you go raise am, dat one na time wey you just dey waste. Unless de babe dey kolo or she be totally useless woman, you no go ever get de pikin. Some women go wan deceive you say dem no like to jingolo with condom. Dem go tell you say de tin dey worry dem for bele. My guy, make you run oo!! Even when you use condom, make sure say you flush am for toilet or if you no trust de toilet.., put am for ya pocket carry go house oo..., lol. I know say dis one go sound like extreme measure, but my guys dem law hia no dey play with you when ee reach for dat tin wey dem call CHILD SUPPORT!!! |
For some of my old post, I don talk as how de babes for hia dey behave different from naija babes. For hia de babes open eye well well, and like I don talk before, de laws hia dey side with dem too much. Dis one don give dem too much freedom to do anyhow when dem like. My friend tell me wetin happen to am recently wey make me laff well well. Him and him girlfriend been get small quarrel and den de babe tell am to go sleep for couch wey dey for palour. When I hia dis one, laff no gree me breath at all. I ask am wetin him come do? Him tell me say "man pikin been no get any choice!". For house wey you dey pay rent too? And ya girl go tell you when to sleep for bed and when you go sleep for chair! Na wa for some people oo! But na later I come find out say na normal tin for hia. Na normal tin for women to punish dia men with exile from bedroom. Most men for hia dey try very hard to no make dia woman vex too much. Because if she vex, she fit troway you from bedroom for days or weeks sef. And den you go pray to God make she no too vex and den ask you to pack comot de house for sometime. No be small tin oo! Woman ask me to comot for bedroom for my own house? Onto which levels? My mama no born woman wrapper.., lol. But on a serious note, dat kind tin no sweet my belle at all. Me personally no too like wahala, den for my woman to tell me say I no go sleep for awa bedroom, no go funny at all. As a typical naija man wey I be, I get strong head like odas get too. Us wey awa ego no dey let us tink well some times. I know say some of de tins I go tell her na 'you mean a whole me go sleep for couch?', 'look me well well, shebi you know who you dey talk to?', 'dem no born you well to tell me dat kind RUBISH!!'. Well de unfortunate tin be say, all dos initial gra-gra go only work for naija. For hia if you no wan make police come escort you comot for de house, you go just comply with anytin ya woman tell you to do. All man know say 911 no hard to press for phone. Na im make mos naija guys still dey go back naija to go find wife. Nobody wan any kind yankee woman extra wahala. But de tin be say most of awa sistas dey come hia come copy all de bad bad tins wey dey happen hia. But wetin man go do na, we dey for rome, so we get to obey roman laws.., abi?! Pessin no get any choice for dis one!! |
For today post, I wan tell una small history tory wey connect yankee and Naija. I believe some of una neva hia dis tory before. Dis one na about sometin wey happen for one town wey dey for Georgia state. De place na Dunbar creek wey dey for St. Simon island. I remember one time wey me and one akata been dey talk, afta I don tell am say I from Naija, him come ask me weda I don hia about de tory of IGBO LANDING. I tell am no. So de guy come begin tell me about am. So de tory na about some igbo people wey onyibo bring come america around early 19th century. Just like dem don dey bring people by force come yankee, dis one no get anytin unusual about am, except say dis group of igbos do sometin wey none of de onyibo people expect. Dem no rebel like some groups don do before, like to fight dos wey capture dem or try to run from. De tin wey dem do be wetin I go call ultimate courage. You must get enough liver to do wetin dem do! All of dem from pikin, women and men been wait until de ship carry dem from West Africa come reach Georgia state for america. Afta dem land, all of dem come decide to march enter de ocean and come drown dem sef. With de chains wey dey dem hand and leg and neck, all of dem commit mass suicide. Now when you come tink am, for igbo culture dem see suicide like one kind big taboo. Person wey kill im sef no dey get proper burial. But dis people get de mind do am. Dem realize say to stay alive for dis strange land go worse pass HELL FIRE. So dem discover say to kukuma end everytin go be dia best choice. I know say some christians go say dis poeple go still end up for hell fire. And den you go begin wonda why ee be say na de same people wey carry christianity come give us, be de same people wey begin catch awa people to be dem slave. Shey na femi kuti sing am for song-you go wona wonda wona, until you go turn to wonderer! Me sef don begin wonda about dis christianity tin well. Some people say if you go dat place for Georgia wey dis people comit de mass suicide, you go hia strange voices and de noise wey dey sound like chains. Well....., me I no believe too much for kpoju-kpoju tory, but I dey plan to go see de place with my eyes. Any time when I get small break I go like to travel go Georgia to see de place with my two eyes!! |
This news is more than 7 months |
SUBWAY101:Tanx my dear And you fit check out more gist for my blog- lifr4yankee |
Last friday I travel go Atlanta to go renew my passport. I go change my passport to de one wey dem dey call e-passport. I don postpone dis trip too may times until I come decide to do am before March finish. And I go tell you say de waka to get my new passport no be small waka. I start online to find out wetin and wetin I need to carry go de embassy office. My online waka come turn to full time research abi na project. I see plenty sites wey tell me different tins wey I need to carry go de embassy office. From birth certificate, local government identification letter to gurrantor letter wey I go declare all my property. I come discover say some of de tins wey some of de site dey ask for no dey with me for US. Den when I try to call de number for de website, nobody gree pick. I try email, I no get any reply. Na dat time I come begin one by one to eliminate de tins wey no dey necessary . I come start to narrow everytin to US requirements. Na dia I come find out say if you wan change ya passport for Atlanta office, you go need: Online application ( you go fill de form online, den come print am) Money order $106 Letter say you don pay de money Receipt of money wey you pay Processing fee $30 Ya old passport Photocopy of de biodata page One passport photo Afta I finish to gada everytin wey I need, I come begin plan my trip. I reach Atlanta on thursday, den friday around 10 'oclock for morning I land de office. When I enter Inside, and den look around, ee really feel like any typical office for Naija. For wall dem get TV wey dey show NTA and den anoda side you go see de ambassador and Oga Jona photo. Pidgin english and oda naija languages just dey fly from all angles. And as usual, we get awa own naija wey to organize tins. Some sidon, odas dey stand up as chair no reach everybody. Some wan hurry finish quick quick. Na so some go wan take style jump line to go front. Even dos wey dey work dia no even fit coordinate de place well. As you come in, na so you go pick number. But I come notice say de workers (one of dem na phillipino woman) just dey call de number at random. Sometimes you go hia 76, den lata you hia 51. One woman wey de tin no gree come ask dem why dem dey jump number like dat, de workers explain say na de way de tin dey for dia list...lol. Afta dem check ya documents finish, dem go come send you go anoda room where you go go snap picture. If you snap finish, dem go tell you to go bring priority envelope. Some body go direct you to go anoda building (wey no be post office oo!) to go buy de envelope. For dia one babe dey dia dey make quick money. Envelope wey dem dey sell $4, she go sell am to you for $10. Trust naija and dia hustle. I sure say na people for de embassy dey arrange dis one. And dem no go tell you for dia website to come with de envelope, so dat you go come de embassy come buy dem own (naija eh...!) Well I tank God say my waka no enter K-leg. Everytin go smooth for me. Some people for dia say dem don come like three times, and each time dem go tell dem to go bring one tin or anoda. But afta everytin, de place dey organise sha as per yankee standard. Who say naija no dey respect dem sef when dem need to. Dem know say if dem try any of awa usual nonsense for yankee, na double wahala for dedi body for dem be dat. |
The person who took this pic n posted is the biggest GOAT ever. Wht's ur point for posting this? Trying to mock a man praying? Na wa oo!! |
businessline:Is this what nairaland has turned too? People just formulate BOLD FACED LIES as news stories? |
All my life for naija, na onyibo man wey I know as Jesus Christ. From de photo wey dey hang for awa church to calendar wey you fit buy for market, na onyibo with long hair wey I dey see. Even sef de "jesus film" wey we dey watch for christmas and easter get onyibo jesus. Na when I come yankee I come hia for de first time say him fit be black man. Yes oo..., de tin take style surprise me. Na by accident wey I hia dis one. Me and one akata guy been dey talk, him dey ask me about Africa, and him come dey tell me about dem own experience. Den as tory come enter religion, I tell am say I be christian. Na dat time him come ask me weda I know say jesus na black man. For my mind I come dey ask my sef weda de guy dey halucinate. But my guy been dey very serious. Him come begin give me history lesson about christainity and how say most people for bible be black men. Well, me I been no get time to begin argue with am. Weda white or black how dat one take mata? Ee really mata for some people hia oo! I find dat one out by my sef. For de African american community, ee get people wey dem dey call "conscious people". Dis one na people wey wan connect to Africa. Everytin wey dem dey do must get African meaning. And among dem, dem believe say jesus na black man. Dem go quote for bible where dem describe jesus hair like wool and him skin like bronze. Dem believe say onyibo people just take style whitewash him color to white. Dem get plenty books about dis mata. And even for some movies you go see as dem talk about say jesus na black man. I been see dis one for de movie- Malcolm X wey Spike Lee direct. I know us christians for naija no get any idea say jesus color fit be controversy, aftarall na onyibo people bring chritianity come give us. So na de color wey dem tell us say jesus be na dat one we go take. So if dis "jesus na black man" tory enter naija, I no know how some people go take am. But I trust most of awa prayer warriors, dem go speak in tongues comot demon for any pessin body wey wan preach to dem say jesus na black man. |
Caliph69:Ofcourse!!! |

