Inoki247's Posts
Nairaland Forum › Inoki247's Profile › Inoki247's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 346 347 348 349 350 351 352 353 354 (of 580 pages)
lol I don't know how he wants to campaign like this without saying jargons against the same Govt he play some role in.... If truly he no dey ok with the policy and everything of this present Govt he suppose resigned buh na lie u still stay enjoying the benefits..... eranko to ba bah aja rin oti didan ko je igbe.... Oga you're clueless nd confused dere is nothing you can tell me... |
Lol... Ruling party no fit secure dere office aw dem wan see the country secure...... |
lol this Govt no see education as anything now dere oga dey use Nepa bill nd u talk say mak dem take education serious... |
Mak he use am make everybody go rest wu dey hold him.... I don't know aw war dey sweet this people sef is dat what you're elected to do to be killing people.. money wey u suppose spend on d welfare of your people if you've excess share am give your citizen as benefits... Buh u people will rada use it nd be making weapon up nd down looking for people to kill..... |
Continue with your drama infact ABBA will participate in 2023 election wait and see... We know say e no dey go anywhere diz Govt is full of scam .. |
lol which FG the one wey dey go or the one wey dey come.... People wey no see 5million people give job dere Npower temporary job sef no reach 5million b calling figures like wu don high.... Even Tradermoni 10k Loan wey dem say go pull people out of poverty I neva see ordinary thousandnaire from that scheme talkless of millionaire.. You people shuld beta Getat from here before Thunder with high tension strike you people.... |
lol Covid wey don go on vacation you people wan call him bak ![]() |
lol dem don come with there confusing report again.... Even if person die of Food poisoning in Nigeria if dem du Autopsy for the person dem no go still see am say na poisoning.... I don't know if na INEC dey even conduct Autopsy for diz country cos na dem dey always come out with inconclusive results... |
johnmartus:Ok keep blaming Govt for everything maybe na Govt dey die or the people that choose to be greedy... You people will blame Govt for everything and you keep getting yourself in illegal dealings... |
johnmartus:Always blaming the Govt for everything you know how many times Govt fit don send law enforcement agency there and dey will still bribe there way out.... We need to start taking responsibility of our actions the Govt are corrupt and insensitive no doubt what about the people also... |
E neva clear for dere face e still dey blur like white and TV.... Bring Buhari for 3rd term people will still vote him |
Make dem Lock am bak dey are mad I wish Benin Republic can just close dere own abg.... |
lol injustice from what I just wish Thunder can jus fire him and doz English wey e dey always talk.... Injustice and Betrayal from what |
lol if dem catch diz Emir for dating app na just Nigeria prince format go carry diz emir... Imagine clear goods for Airport diz format no clear at all... |
make dem find there heart and connect it with the land ![]() |
lol Electricity is now a rocket science in Nigeria... Dey should sell Nigeria to Benin Republic maybe dey can help us fix our light and get 247 light... |
lol na Vawulence u dey find.... So that's why u decide to disgrace your husband for TV show.... then don't be deceived 90 percent of women av acid mouth they can kill dream kill anything with dere mouth infact dere mouth no dey stay one place na why wen Adam just stroll out Eve try to taste the Apple.... Women dat see Marriage as one of the greatest achievements on earth.... |
Lol we know say e no even get time for that stress... Na people wey dey always find news to cure dere Agro dey always cook different story.... if dem no find Consensus dem go find anointing Oil go Shiloh or Mountain of Fire... |
Dey shuld open the cage for dem mak dem dey roll with Ekuke for street jejely... Cause what I'm seeing up dere no b lion again Sapa don change the thing life journey.. .. |
Lol you can do us a favor go inside the bush and take God to dem so dey can know... Or use Tucano to send dem to God... |
lol |
lol if na by this den Saraki no suppose lose Kwara cos if I can remember vividly no schl dey go strike for Kwara state... |
lol they shuld transfer dem to Delta or Cross River for burnt offering.... |
Boko Haram and Iswap he too sure for dem, dem no dey deny derr work... Buh one region dey can deny anything infact everybody in that region be saint no sinner dey can never commit crime... |
lol clueless govt dey shuld lock the thing back oh cos is not useful again Xefa and Naira don dey same rate.... So the border opening no dey useful again... |
lol so in one word you're saying hellfire candidates will skyrocket cause this generation like anything sex... if care isn't taken self people will be lapping dem sef in hellfire wen space no dey again ![]() |
lol we already know say na unfinished project like Lagos Ibadan Express way naso dem go continue dey drag am... |
lol all na no dey tire for all diz marriage wahala ni... Your wife went out behind your back wetin mak we du na we help you marry her.... when you know say you no fit deal with marriage issue and be a man why you put head... Abeg allow us rest... |
Dem no even trust dem sef.... I'm sure if na west any governor try diz tears go don full everywhere like Lekki flood.... |
Since dey av nothing tangible to give us.... Mak dem dey giv us doz pishure we go dey use am du Meme life no hard.... Having bad leaders in Nigeria don b like birth right..... |
lol he should thank God for his Life if dem try this for Delta after the feeding dem go turn dem to burnt offering...... Just like feeding a Cow before you mail him to hellfire on earth..... |
Keep it up... Nothing last forever.... Dem don make almost all d youth for south Ex con while dey flex around any aw with the money meant for the country nd still rubbing it on our face... |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 346 347 348 349 350 351 352 353 354 (of 580 pages)