Gigabyte13's Posts
Nairaland Forum › Gigabyte13's Profile › Gigabyte13's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 121 122 123 124 125 126 127 128 129 (of 194 pages)
Chai See wertin this cone head man turn labour to A tool of vegeance Oga go sue who beat you ooooo Abi na the two eyes blind ni You no see who beat you well abi.... ![]() ??You are on your own oooooooooooo |
Nigerians are the problem of Nigeria Na we gangan dey dabaru ourselves Every nonsense wey we do We go run hide under government Werey no sweep him room Na Government cause am Girl no gree for you Na government cause am Una go get sense last last. |
Wike talk too much.... E go soon crumble sha How soon I can't tell but E go soon humble....... Same way Amaechi don humble now |
Dem beat craze comot for the werey body Shey Dem dey encourage you to dey craze anyhow, where those wereys wey dey push you dey when only you dey chop the beating alone..... ![]() ![]() ![]() ![]() ![]() ?Na craze Dem take dey cure craze no be ORDINARY eyes. You go dey mix politics with real matter like the LABOUR UNION and you want them, to take you serious. SHA PREPARE FOR MORE BEATING SHA YOU JUST DEY START...... |
😂🤣🤣🤣😅🤣😅😅🤣 😂😅🤣😅🤣😅😅😅😂 🤣😅😅😂😅😂😅😅😂 Una mind no go touch ground Shey you dey make mouth say Court order no court order You go protest....... How far na...... ![]() ![]() ![]() ![]() ![]() ? |
Money is really the root of all evil Evil is not a gender thing Both men and women are evil Especially when money don enter......... Na your reaction towards money go determine whether me and you go fit Waka.... MONEY THE REAL TEST OF A MAN'S CHARACTER |
Make una come turn the office to Urgent knacking center abi......... Abi una go come transfer house disagreement come office dey affect another man livelyhood. |
And they gladly accepted Awooof dey purge Belle they forgot. Purging don start, goat no wan vomit yam again.... The payer and the payeeeee And their beneficiaries. ALL OF YOU PUT TOGETHER DEY MADTTTTTTTTTTTT. If una like, make una keeeeee unasef e no concern me, l no pity anyone among them. |
Confirmedzombie:Dis one dey beat chest inside NAIRALAND 😅😅🤣😂😅😅😅🤣😅 😂🤣😅🤣😅🤣😅🤣🤣 ONLINE TERRORIST |
MR SIM card Don dey reset E don dey reason am say E be like my own go worse pass Amaechi own. Factory reset things |
Na government own we dey see... Which wickedness pass dis one No be today, l don dey see or hear such Wickedness of man to is fellow Man Wicked souls everywhere. |
Sue Magistrate and police...... ![]() ?🤣😅😂🤣😂😅😅😅😅🤣😅 419 dey sue corruption.... ![]() ?Na e be say, Dem go stay for cell till next year be that...... |
Sooooooooo.... ![]() ??We should console or advise on it or what The time wey you dey collect am You tell us ...... Carry your woran woran go one side abeg |
Politics, na chop l chop worldwide For those who understands the game Politics no be church matter.... APC appointing LP supporter and him gladly accepting the post... Shows where his loyalty as always been HIS POCKET HIS BELLY HUNGER DEY REALLY FINE TUNE AM By 2027 if LP still get OBI to contest, na to play deep spoiler for PDP. They are no threat to the APC, and they will never be. |
You don catch me I hands up 🤣😂😅😅😂😅😅 🤣😂😂😅😂😅😂 Very very useless game |
E remain OBItuary own..... |
N3TRAL:You think say Governorship position Na class monitor abi School prefect post...... He go do you plenty plenty many things Talk is very very cheappppppppp Ask yourself Politically in Rivers politics Who is Funbara without Wike.... ??Boneless, structureless, irrelevant in Rivers politics |
😅😅😂🤣😂🤣😂😂 😅😅🤣😂🤣😂🤣😅 Funbara gone............ Court loading Dis Wike na political educated gangster. Person wey single handedly gag Atiku Who be funbara.......... The game is, Wike accepted political appointment from APC because of something like dis.... Funbara suffered is first political blow Wike Very very Wicked |
Na wertin go finally keeeee am happen so Wertin he dey find He don finally see am |
You go explain explain tire Rivers no be Edo You rode on somebody to power Agreement is agreement..... I pity who dey pity this polithiefcians All of una be the same thing I remember Wike locking somebody up, who is also interested in the governorship race because of you..... Dis una fight go long... Na the person wey get longlife go survive am POLITHIEFCIANS.....!!!!!!!!!!!!! |
🤣😅😂🤣😂😅😅 🤣😂😅😂😅😂🤣 Nigerian politics dey sweet me ooooo Na those wey dey fight themselves over this polithiefcians l pity pass..... Darling Wike Wertin you dey cook Don don oooooooooooo Come chop inside now, you dey vex..... Funbara abi wertin be him name Go see the full wrath and force of Wike You wan maradona person wey get ball untop him field for that matter..... If una like, make una keeeee unasef Wertin we gain before. |
BentizilL0:Did you just mentioned Egypt.... ![]() ??You sure say, you Sabi history of Egypt and isreal so..... ![]() ![]() ![]() ![]() ??Isreal don murder Egypt tire. You see Egypt threaten isreal with anything.... ![]() ![]() ?Egypt don learn their own lesson Jeje..... Iran just dey make mouth all dis while, liver them no get. Palestine get liver pass lran. Make lran just leave mouth, enter dis war lasan. Weertin lraq do them that time, go be children play to wertin isreal go do them. |
Dem still get mouth to talk Ok oooooooooooooo Na e be say, Una go sue samklef join Una go sue plenty people oooooooooooo If no be say, something get k-leg for that una record label.... I never see one single successful artist, wey don succeed inside that una label. |
First time l took my babe then home, she is now my wife..... I told her to join my mum in the kitchen My mum bluntly told her that You are not married to my son yet You are only my guest for now So please relax, enjoy yourself. She sef shock Me sef shock Na my mama be her best friend now |
But wait oooooooooooo Why the sudden wailing of Amaechi Baba sef wan thread like Wike Wike rendered him very very useless all round. |
🤣😂🤣😅🤣🤣🤣 😂😅😅🤣😅😅😅 😂😂🤣😅🤣🤣😂 2027 tears don start already in 2023 Una go cry oooooooooooo Like some people are just born to wail BORN WAILERS......... |
hotwax:I love this your write up They all conquered isreal and left according to you. But The Saladin jihadist, who are now the Arab Palestine according to you refused to leave after conquering isreal abi..... ![]() ?So from your write up now WHO CAN WE NOW CALL THE LAND GRABBERS..... ![]() ![]() ![]() ![]() ISREAL OR PALESTINE..... ??.. |
After una don go find trouble finish Una dey find votes wey go save una.... Una never see anything... Isreal die there... The IDF already said that, after this fight, Hamas will never ever attack isreal again They will think more than thrice next time. Una think say, isreal dey jokeeeeeeeeee. Una find trouble finish, go dey hide under children and women wrapper. They cry wolf If e too pain Russia abi China make Dem sef, join in the fight, Dem go collect too. Isreal no send anybody Papa as Dem dey so. Isreal too as powerful backers Make everywhere kukuma burst. Abeg wey lran dey..... Na opportunity to destroy isreal be dis oooo Make Dem show face Dem too dey make mouth over isreal matter. Make Dem show face now. |
Cry cry babies GBAJUE MOVEMENT Like BAT get una time... Una go cry tireeeeeeeeeeee |
Finally Amaechi don dey see road clearly.... Amaechi wey deny him own people school of petrochemical because of politics. I love how these people see road clearly immediately they are out of power..... Well let him tread carefully Wike is still in power and Amaechi records are still intact for DSS, EFCC, ICPC perusal. Corruption cannot call out corruption All of una be same same. |
Yemmysworld91:Please remind him IREV or not That the judges said OBI and ATIKU never presented a different results and figures contrary to what was tendered by INEC to the court. So the court or INEC should manufactured one for them right.... ![]() ?? |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 121 122 123 124 125 126 127 128 129 (of 194 pages)

